Pages:
Author

Topic: Prevention is better than Cure: Binance Removed Naira from the Platform. - page 2. (Read 249 times)

hero member
Activity: 1148
Merit: 555
I nor understand the direction government dey go like this. Make them nor do the one wey Nigerian traders go lose their money for Binance. I listen to Wetin cbn hovernor talk about the money wey don move through Binance from Nigeria and from him cappings you go know say the man nor know Wetin he dey talk. Binance get kyc, I nor get why them dey talk like say the platform na darkweb stuff wey them nor fit trace anything.

I see this news dey trend for X, Binance never confirm am but people don dey panic

sr. member
Activity: 770
Merit: 445
I been dey try to sell bitcoin in Binance just now and I see say di naira side e no dey work and I come tried USD di thing work and I come still try naira again na di same thing.
As I open binance the other time wey I wan check the price wey dollar dey, I see say the thing no show, but MTN network have been misbehaving since morning, so I was thinking it’s network problem so I just closed my binance app, until now wey I dey see this thread na him my brain dey tell me say no be network, we no fit make use of p2p again be that,  but this one really weak my body ooo, plenty people don dey use to binance p2p.

If you dey use Binance dey receive payment make una go change am now and move all the coin you get in Binance to another exchange before the story change.
E no dey necessary make dem change wallet now, if they receive money for binance, they fit just send am go another exchange like KuCoin, then they will make use of p2p on the exchange, d only place Wey problem go dey na if government decide to ban binance in Nigeria completely. So the best thing na to dey use non custodial wallet dey receive your money, but if you get mind, then you still fit dey use your binance receive, then they use KuCoin convert your money to naira, I just hope the government won’t come for KuCoin one day also.
hero member
Activity: 896
Merit: 586
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
This is the most annoying scenario so far, how will one be able to exchange his bitcoin for Naira now the FG has made Binance remove Naira from the currencies. I have some little coins in Binance that I do change whenever I need funds to take care of some responsibilities, it means that I need to move it to my electrum wallet immediately.

OP, please is it only Binance or it includes other exchanges too. I hope this is will be a way for the unification of Naira, and not that it will be forever, because it will be hard for one to convert his bitcoin to Naira, and I don't think that Naira is included in DEX.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
That is true. I noticed that now also.

If you dey use Binance dey receive payment make una go change am now and move all the coin you get in Binance to another exchange before the story change.
What else again if no P2P trading on Binanace and other centralized exchanges anymore? I guess the regulators are reaching out to these exchanges one by one. Best to have all your coins on noncustodial wallet which we always advice.

But I guess the regulators may be finding ways for naira unification and want to regulate the exchanges in a way they will not violate their policies.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
I been dey try to sell bitcoin in Binance just now and I see say di naira side e no dey work and I come tried USD di thing work and I come still try naira again na di same thing.

Once you click naira everything on the screen go blank and when you click another currency then everything go come back.

If you dey use Binance dey receive payment make una go change am now and move all the coin you get in Binance to another exchange before the story change.
Pages:
Jump to: