E get one reasoning wey people dun make people feel say na wetin quality contributions be dat. You no need to write about Bitcoin or the forum before you go drop quality contributions especially for local boards like this one. The least constructive discussion wey you drop here go get appreciation because na we we. You no need be professional before you go drop quality contributions. Just no spam this place with repeated content or similar post then you no go get problem for here. You be newbie no mean say you go dey misbehave. No dey carry shoulder up no matter the age you be for real life. Small pikin wey get rank pass you for here Snr you so try dey take corrections from them and you too go grow one day reach higher ranks.
So far I never too see toxic attacks on newbies for here instead na embracement we dey give them and I hope it continues like that. Me I dey like newbies contents because na something new I dey expect from them but it gets disappointing when you no see any efforts from them but they beg for merits upandan. You think say na begging people carry grow reach where dem dey so. If you want rank up, put working and you go achieve am no dey dull. This forum just dey like Bitcoin, the opportunity is opened to everyone so anybody fit grow just say make you put work into your posting and no dey mumu with your writes ups them (write well people go reason your matter)