I just notice say for Bybit some vendors they specify say there payment method nah cash in hand, abeg anybody don try out this option here ?
With the kind security issue we they face for this country that kind deal no be Watin person suppose even agree to do in the first place, as I we don see for general board where such deal almost lead to something else.
I just wan ask if anybody don make use of that option before and also to warn against the danger of such deal..
I just dey notice am too, I am not sure anybody will get themselves involved in any physical exchanges, unless our government finally win that all the exchanges should delist the NGN p2p from their exchange, if not how can someone risk their life for a physical trade just because them get a good rate. But my question is, how you go take meet up the with the person for a physical exchanges, if you people no dey the same city? Or you go travel along the way to meet the buyer from where e dey for a physical exchanges? If that's it, it doesn't make any sense at all, if you check it well, those vendors no get too much people wey rate dem well, that one fit be a sign that is very risky because whenever we want to sell our coin through p2p, we dey normally look for a vendor who gets excellent reviews.
You self supposed know say nobody wey get enough sense go gree trade such physical trade even though say the rate too good except say na person you know already offline.
Even though I sabi the person well well, I no go tried such thing, because it might be a set up. Person dey follow you laugh no mean say him no fit cheat you, people fit get you through that person wey dey close to you. So make we no believe any physical trading, even though their rate is #2k per one $.