Pages:
Author

Topic: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing? (Read 357 times)

sr. member
Activity: 504
Merit: 323
We go appreciate if you that one for us weh still be newbie if you say make we use the old one e go hard for us to go the last page and some of us fit be discouraged
hero member
Activity: 812
Merit: 675
The sub-thread wey you talk say make we create dey very important for dis our naija local as you don talk am say e go reduce spamming and na so e suppose be sef. As I don talk am before, make we create little but not much sub-threads wey we sabi say people dey mostly dey interested in discussions wey comot for there. Na we place and we know how d matters dey be for we country and how we dey take handle am. If we look into am well, we no go lack ideas of d relevant sub-threads wey we suppose create come bring traffic here to our local board.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
Hey, just noticed you got your local Nigeria, dedicated board, I'm so glad all of you managed to fight it. congratulations to the Nigerian bitcoin community.
I remember when you started with the demands, I even partially participated in the discussion. I would say that not much time has passed since that request. looking at your activity, you certainly deserve this.
congratulations once again.  Wink
Sir you are welcome to our local board. In Africa when someone visit a friend, it is cola that is used to entertain the visitor but we don't have cola so I welcome you with a merit. Please accept my offer that represent cola here in the local board. And also thank you for
supporting and locating us to our corner. You are really a friend indeed.
legendary
Activity: 3248
Merit: 3098
Hey, just noticed you got your local Nigeria, dedicated board, I'm so glad all of you managed to fight it. congratulations to the Nigerian bitcoin community.
I remember when you started with the demands, I even partially participated in the discussion. I would say that not much time has passed since that request. looking at your activity, you certainly deserve this.
congratulations once again.  Wink
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
You notice people dun reduced engagement here, that's because interesting topic no dey available and we want to address that by encouraging the creation of topics by members. No vex say e dey locked at the moment but immediately we get better traffic here I go reopen am. I dey encourage you and other make una carry those topics una been create for that hangout thread come this board as topic so we fit discuss am well.
Na so bcos we need quality topics 2 cause traffic. To discuss no bi di problem, dis won wey u dey creation of topics, creating topics no bi di problem oh, but quality topics, in di process of creating topics one thing we have to avoid is to avoid spamming, and dat my no 1 campaign slogan in this board. Please I dey beg una when u dey create topics avoid spamming. I don tok am r plenty times when di tin go casaplaka for we unit make nobody no tok say I no tok am. And also avoid account farming. Go nd check Meta to see account farming issues... I no dey tok sae make una no create threads here but please take time 2 reason am.

Please again and again make una avoid Spamming di board. Caution! Caution!! caution!!! Quality threads go promote the board rapidly
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.

I think this Sub-Threads dey important but no be for discussion like politics, Bitcoin or altcoins discussion. Those na popular discussion wey for help the thread creation process on the board dey active, but e get other discussion wey fit dey annoying but if we put them for a Sub-Threads that wey, we go help minimize spam, wetin others think and then u fit give examples of this Sub-Threads wey go make sense. My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think

I agree with you for the last suggestion boss about creating a sub thread for just the beginners over here and possibly pin am as well but I think make we get only that sub thread for now and make we try to dey stick with creations of more threads and topics over here.
And since we never get any moderator for the board I go advice make we no dey spam the board but rather try to dey communicate and pass more information as well as bringing up Nigeria related issues only on the board at least for now.
full member
Activity: 840
Merit: 137
Una wedon oo las las we don get our local board, omo apines wan finish me like this.
I don read many tins here nd notin to dey kill ourselves like this, e don set be dat so wetin we go do na to just take our time arrange our board how we want to be just like de wey oda pipo own be so dat e go dey very clear for pipo eyes. So i go suggest say make all everi pend till next year we settle down arrange how tins go be.

Merry xmas to una oo nd appi new year ahead.

I swear,I dey with you senior man for this matta wey you just talk so,say we go calm down arrange our board Wella.The board wey our senior men dem for the forum don create dey burst my brain like this,,,e just dey sweet me.The year don dey end,and we thank God for the protection from when the year start to now wey the year don almost end like this.
The level wey some people been dey when the year been start dey different from the level wey dem dey now.dat is to say this forum don upgrade so many people,we thank God for that,and we also pray say baba God wey don protect us reach now,go protect us reach next year too.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I no know for others but I thinks say that’s Hangout board doesn’t need to be closed, Abeg make we check am properly that hangout sub board get really contribution to us getting our own board.

The traffic on that hangout sub board choke. I was really surprised when it was closed  that place na better place where we can gather and still discuss topics in it.

If na Peter obi him go say, I got the advise from a mad man but me I no get am from a mad man instead i get am from our Snr bros Igehhh and e make sense. Make I explain, if we leave that thread open only that thread go dey active for this local board and e go make the place scanty. We want all those topics wey we been dey get on that thread to become their own thread. I no mind if we repeat this topic here as thread but e go make sense since e go bring out a broader discussion on those topics.

You notice people dun reduced engagement here, that's because interesting topic no dey available and we want to address that by encouraging the creation of topics by members. No vex say e dey locked at the moment but immediately we get better traffic here I go reopen am. I dey encourage you and other make una carry those topics una been create for that hangout thread come this board as topic so we fit discuss am well.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
I no know for others but I thinks say that’s Hangout board doesn’t need to be closed, Abeg make we check am properly that hangout sub board get really contribution to us getting our own board.

The traffic on that hangout sub board choke. I was really surprised when it was closed  that place na better place where we can gather and still discuss topics in it.
No b lie u talk my broda. As e b now cef, I nevr reali understand d creation of thread 4 dis we new corner. As oppose to tryin 2 dey arrang tins, I 4 say, mak we leave dat place open first. Mak we dey manage am dey go until, we decide if we go lik get sub boards or not and wch particular boards we 4 lik get.
E go gud cef say, pple go dey drop dere suggestion as we dey talk so, later, dem go gather d suggestions, tak am form poll for voting on how many sub board we go lik get nd wch particular boards we need. Dat go help mak we get sense of direction wen we enta here.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Always Act Smart and Play Safe With Your Funds
Una wedon oo las las we don get our local board, omo apines wan finish me like this.
I don read many tins here nd notin to dey kill ourselves like this, e don set be dat so wetin we go do na to just take our time arrange our board how we want to be just like de wey oda pipo own be so dat e go dey very clear for pipo eyes. So i go suggest say make all everi pend till next year we settle down arrange how tins go be.

Merry xmas to una oo nd appi new year ahead.
hero member
Activity: 1372
Merit: 908
As for wetin cryptoprenuerbrainboss talk about sub_thread ,it no bad as long as na to control spamming and monotonous threads Dem especially from dis our prospective newbie dem wey go always like to dey introduce themselves, mk we no cum dey get plenty different threads talking d same tin all in the name of introduction mk outsiders no com d see our board like child's play.
I think @Lida93 dey correct, we suppose get thread wey newbies wey just dey join the forum go dey introduce themselves so that e no go be like say every newbie go come they create introduction thread. As we never get plenty thread for the board, if we allow newbies they create thread just to introduce themselves na just newbies introduction go just full everywhere wey e no go too make sense. We suppose get place where any newbie wey just join the forum go dey introduce themselves and make we try dey give merit for their so that e go encourage them.
full member
Activity: 770
Merit: 180
Eloncoin.org - Mars, here we come!
If we grant Igbo, Hausa and Yoruba threads others go want their own and we no wan carry ethnicity come here. Make we all just dey discuss for pidgin (very important) and English in future when here over serious, we go implement other things like that.

This one na fact wey dey. If language threads begin dey, the division go start and many threads go dey irrelevant and just occupy space. Pidgin English wey we dey use na general language for we Nigerians, and we go make this place dey more valued and lively, if we discuss more of the themes and essence of why this forum, this board, and great threads and posts  for this place dey necessary.
We go dey smarter and more ahead with legit information if our post and threads make sense and provide good insight. I no need to stress on how our contribution here go somehow influence the acceptance of crypto currency adoption for we country. E fit happen in the nearest future o.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I no know for others but I thinks say that’s Hangout board doesn’t need to be closed, Abeg make we check am properly that hangout sub board get really contribution to us getting our own board.

The traffic on that hangout sub board choke. I was really surprised when it was closed  that place na better place where we can gather and still discuss topics in it.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Also, e go sweet if we open a permanent topic make politics discussion de sup there eg (nigeria politics)
abi wetin my ogas reason
I no sure say it go make beta sense to to com d create permanent topic for politics discussion , it for beta say  we hold on and with time push for subboard specifically for tins like d politics nd domestic Mata, economic  Mata, and any other mata's wey supposed dey too. Make we leave politics issues to still dry run inside the main board itself.

If you see my OP you go see say I no put topics like Bitcoin discussion, politics etc for this sub threads mata because e no make sense to tie those topics that one thread when we supposed use am create more thread and keep the board active. If we put this two discussion including economy discussion for one thread then mata dun finish be dat as here no go dey get active thread.

As for people wey dey suggest say make we get other language thread, I no support that one especially now. Make we try dey avoid creating inactive thread as e go spoil here. Make we create wetin go interest people to talk inside as na that kind threads them we need here. This threads no go just dey  active oh as e gas dey add small small knowledge to people or contribute for the growth of the board.

If we grant Igbo, Hausa and Yoruba threads others go want their own and we no wan carry ethnicity come here. Make we all just dey discuss for pidgin (very important) and English in future when here over serious, we go implement other things like that.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
Based on popular demand which I find meaningful, the previous hangout thread has been closed and after we get this board active maybe I go reason open am for other discussion (fit no be this year again maybe 2nd quarter next year) as by then many people go dun sabi say we get Local board and not local thread again or I lock am forever.

We still dey on the celebration and I go like encourage the creating of threads by everyone, the faster we get everything running the sooner we get other wish granted like subboard and merit source for the board etc. Wetin i wan make we discussed for here na only the Sub-Threads mata other mata should lead to their own thread creation.

I no dey discouraged thread creation but we suppose get some sub threads wey go help moderate the spams for the boards. The Sub-Threads supposed be like Introduction threads) to avoid that madness wey dey beginners and help, as new users they introduced themselves with deadliike threads regularly).

I think this Sub-Threads dey important but no be for discussion like politics, Bitcoin or altcoins discussion. Those na popular discussion wey for help the thread creation process on the board dey active, but e get other discussion wey fit dey annoying but if we put them for a Sub-Threads that wey, we go help minimize spam, wetin others think and then u fit give examples of this Sub-Threads wey go make sense. My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think

Also, e go sweet if we open a permanent topic make politics discussion de sup there eg (nigeria politics)
abi wetin my ogas reason
I no sure say it go make beta sense to to com d create permanent topic for politics discussion , it for beta say  we hold on and with time push for subboard specifically for tins like d politics nd domestic Mata, economic  Mata, and any other mata's wey supposed dey too. Make we leave politics issues to still dry run inside the main board itself.

As for wetin cryptoprenuerbrainboss talk about sub_thread ,it no bad as long as na to control spamming and monotonous threads Dem especially from dis our prospective newbie dem wey go always like to dey introduce themselves, mk we no cum dey get plenty different threads talking d same tin all in the name of introduction mk outsiders no com d see our board like child's play.
hero member
Activity: 700
Merit: 523
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I thank appreciate everybody for here and outside this board wey help and support for the creation of this our board,I  support the creation of the sub thread base on the way our Boss CBB don explain am using the ethnic and Africa  proverb thread site as example. This na e go be fun pass becos u fit just tanda for the place just dey catch your trips forgetting say u even dey inside btt forum.

I for suggest say why we no just dey on pidgin only instead of both,English na our borrowed language and if you no hear English,you no go fit express yourself for this forum. I bin mistakenly go miss road enter one foreign board omo I confuse becos I no understand wetin dey there. The idea of division of the language into three for board make sense anyone among the three wey you hear,you can also contribute. Na we board so make we start to enjoy everything naija for here.
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
First of all I go like congratulate ourselves for getting our board. I see say the local thread dey locked already na why I do my congratulations carry over here. Lol
on to that sub thread Mata, e dey very necessary bosses. If we check mate am we go see say na political issues dey always top discussion for Nigeria on a daily basis. So for sure political sub thread no be bad idea to create. That orientation for newbies also na better idea before dem go loose guard for general forum and chop negative trust or Pam ban. Naija no dey carry last when e reach entertainment. Kiss Daniel and Davido perform for WC22 e no go bad if we get sub thread for jokes and entertainment related discussions. I for like say make we get sub thread for gambling too but we sef no too dey interested in local leagues. Na my little opinion I drop so.
hero member
Activity: 1372
Merit: 908
As I been dey read through I see one of our very own padi dey Yan say make we create board for local language as e be say we naija get three speaking language oga brainboss I no buy that idea o. Unless una want to begin create division here because that's one go make every o man go dey chat for him own language wey no go make sense at all. We say Naija na one indivisible nation make we show de example even here too no b to dey divide the platform. Make we use Pidgin here make no body create any other dialect speaking board for here. Make we leave am for the Pidgin wey we dey speak here.

I no mean to dispute any body o. Na just my own opinion as e be. Make una reason with me.
My own na just suggestion and is not mandatory to implement it... Make I use the forum as example for you, why be say as the forum dey we get local board for different languages? Why they no talk say since na bitcoin and cryptocurrency all of us they talk about, e no need to get local board, and as people they post for local board, they no dey post for other sections wey they speak English? If we have sub thread for each language, e no mean say people no go still dey post with English or pigin for normal thread wey people create. As we don get board e no go too make sense say na only English and pigin we go still dey speak alone, pigin no be our official language and no be our local language.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
We never get enough active members from the same geographically location for the country wey go make us begin divide, make we dey concentrate on the genera language for now (pidgin and English).
Since na 3 major languages dey Nigeria, I dey reason make we divide am, na you dey reason am say we people never plenty for each geo political zone, maybe you fit just create poll so that people will vote. If am not wrong, I think the main reason why we didn't get our local board early is because they believe English is our official language and that's the language they are using on forum here. I think e go make sense make we divide so that we go fit get 3 languages and everyone go fit speak their local language there and e no go stop everyone from speaking English Also.

This thread idea make sense o. Sr. Comr. Brainboss your shoe shine wella. This issue of creating sub thread go well o but make we pray say members no abuse am. E go make sense say the sub thread wey you go create go carry better heading wey go go well so that any body wey want Yan go Yan Belle full him mata as e be am wey go make sense no be to come dey Yan careless here.

Jump to: