Pages:
Author

Topic: Stay patient 🤞 - page 2. (Read 311 times)

sr. member
Activity: 224
Merit: 195
December 15, 2023, 01:33:15 PM
#8
OP, this na nice topic as na wetin we don already dey yarn since for this forum even before you join but e good as u dey very quick to understand the ways of Bitcoin.

This na wetin dey worry some people dey no dey fit get this kind of patient to allow their investment for a long term as soon as little profit just enter dey don rush go sell am, some go say dey no want make the price fall below wetin dey buy this na very bad attitude to investing in Bitcoin as normally we suppose to don understand by now say Bitcoin dey very volatile and the price fit drop below our entering price but certainly as long say we continue to hold we go still make better profit from our investment
hero member
Activity: 882
Merit: 800
December 15, 2023, 10:42:53 AM
#7
Make I go find something chop 😋😋

If you like no go look for something eat before you come dey talk with people wey eye don open finished for money, and na true here na place to get patient before you moved to another level person no go just come now now expect to boom enter the next rank or even want to make huge profits within the small time frame him or she just join the forum na wetin make i dey look some newbies wey no dey get patient at all for here. People wey reach the level them dey no just appears from no where reach there them also start from somewhere to reach where them dem dey.
newbie
Activity: 28
Merit: 2
December 15, 2023, 09:48:24 AM
#6

So I will advise everyone stay patient and learn before they can earn

Na so me too I think say na wetin I fit invest today then reap am tomorrow. The thing really need patience, steadfastness, and perseverance.
Like OP use tree illustrate, u no fit plant tree come chop the fruit the next day, week ,month or that year. U must give an enough time. This patience don make so many people dump their investment due to say their expectations cut short.
Person really need to learn before en earn.
member
Activity: 224
Merit: 68
Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
December 15, 2023, 01:19:23 AM
#5
The truth be say some kind Patients be like wast of time I swear some people don’t actually understand this Bitcoin stuffs while some really want to learn but no idea or someone to teach them. It painful that majority are just doing it Cus there is money once dy try and it fail they just give up that why is hard to be patient though
From my observation, Bitcointalk.org has helped in creating wealth creation for thousands of unemployed youths.
This has helped in reducing unemployment and in turn boasting the Nigerian economy through Wealth Creation. So I will advise everyone stay patient and learn before they can earn
full member
Activity: 560
Merit: 161
December 14, 2023, 05:54:29 PM
#4
Op eey8n you talk. Cryptocurrency no be wetim how some people see ahm na e be , crypto no be something you fit just start to and belong to get profit immediately.  One must get patience to get profits,  even the learning aspect of crypto,  you no fit start today dey expect say you fit dey get weitn you want immediately.  Everything about cryptocurrency is all about patience,  any person  wey no get patience no go fit make it in cryptocurrency. Success comes in crypto when patience dey.
jr. member
Activity: 73
Merit: 3
December 14, 2023, 05:30:19 PM
#3

My bothers and sisters patience na the only way to see front for this business oo, everything for this space they work with time, investing in crypto  be like when somebody plant tree, make I ask, when you plant tree na that thesame day or month or year you go chop the fruit? Shabi you go wait for the tree to mature first before e get fruit? Na so cryto investment dey  too.
So as e stands so, my people na the tree we dey plant so.
Make we no let pepper body spoil am for us,
The least way you fit invest just do am and wait patiently.
My people we go talk later,
Make I go find something chop 😋😋

Op naso e dea you know say many people wan make am fast but it doesn't do that way because crypto investment regards with patients and that time will surely come for the big profit. As you dea invest just they observe small small you go dea see better results before you know you go make am. Not only crypto ma in general everything wey you go invest it deals with a gradual process.
sr. member
Activity: 574
Merit: 252
December 14, 2023, 04:51:52 PM
#2
Nah  normal thing be that nah, that dem dey say Btc nor be get reach quick scheme nah process, nah that place patient for come because he go still take time for you to understand more about am, if you go dey invest for short term for Btc nah your luck because Las Las nah regret go end am. So as you talk so nah patients win am for Btc oh because in a long run your profit go sure pass. Short term investors.
member
Activity: 66
Merit: 17
December 14, 2023, 04:23:26 PM
#1

My bothers and sisters patience na the only way to see front for this business oo, everything for this space they work with time, investing in crypto  be like when somebody plant tree, make I ask, when you plant tree na that thesame day or month or year you go chop the fruit? Shabi you go wait for the tree to mature first before e get fruit? Na so cryto investment dey  too.
So as e stands so, my people na the tree we dey plant so.
Make we no let pepper body spoil am for us,
The least way you fit invest just do am and wait patiently.
My people we go talk later,
Make I go find something chop 😋😋
Pages:
Jump to: