Pages:
Author

Topic: Subsidy removal and all you need to know - page 2. (Read 313 times)

hero member
Activity: 1204
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I don lose faith in politicians and I always dey skeptical of anything them talk or dey do, bad experience don kill the trust between the government and her people, na the country where we find ourself nai cause am. I dey talk to my lawyer friend today about the fuel subsidy, and our dear learned colleague just dey give me reasons why him feel say na the best way forward BAT make so. I no fit argue with am because anything I talk go seem bias because I want PO to represent us at that level.
hero member
Activity: 1022
Merit: 744
Like dis some people dey talk say de subsidy removal na beta tin but na naija wey dey. How are we sure say after we don suffer all dis suffer finish our govt go do the right thing? Me no really get problem with dis new development but naija na one country wey be say de price of things for we country dey defile de law of gravity, if e don go up e no dey come down again.
The subsidy removal na very good thing wey be say if to say them remove am since, we for don see more development because the money wey dem they pump go for that subsidy pass the money wey them they allocate for education and health sectors, and na our rich people they enjoy the subsidy since them get money to buy at subsidize price come send am out to our neighboring countries for more gains.

I know say some people no de satisfy with the subsidy removal due to hardship and financial situations, but with time everything go they alright even though we no they try for ourselves, but this time I am sure our economy will take a good shape.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
Personally, I no get any qualms with the fuel subsidy removal. This one na matter wey don dey ontop table since former president, Goodluck Jonathan dey Aso Rock. But wetin happen be say den bully am into not removing the subsidy. Removal of subsidy dey okay, infact, Yaradua been do partial removal the time wey fuel been N65. But wetin Tinubu do na like putting the cart before the horse. This one na him make the hardship come triple. Zero plan him nor put in place. Even NNPC wey follow adjust their price talk say him nor suppose just remove am like that without any other measure to cushion the sudden removal. This one be my qualms. Right now sef, nobody sabi as how this thing to take end wey be say the positive side of the subsidy, Nigerians go come start to dey enjoy am. Nobody.

 
legendary
Activity: 1106
Merit: 1372
You really tried 4 di info. Dis fuel palava na wahala be dat I'm so kwantri now. My area, some people dey even say no bi President Tinubu Removed di fuel price while other people dey no bi Buhari. But me I know say no Buhari and Tinubu come dey implement am fully so na the both men do am. As Buhari start am Tinubu can still cancel it as president. Fuel subsidy na good thing but I no support am because mostly we do Niger Delta. The oil is taking from di area yet we are not benefiting any and probably na only di fuel subsidy we been dey benefit. Now di fuel price in my locality is #700-800 per litre. Very soon the poor and the average Nigerians can not buy fuel again.
For the Dangote Refinaries. Make nobody put hope for there. Di Refinaries wey im build at di Northern part of di country e no dey sell fuel in di kwantri but im dey carry am go outside kwantri dey sell dem. Dangote cements wey dem dey sell am very cheap in other kwantries, dem dey sell am #5000 in Nigeria. Anything Dangote , I no won hear am with my hears.
He is one of the problem in Nigeria. He is also joining di ruling class to suffer the poor. Dangote can discuss with the president to reduce cost of living in the kwantri but he is very happy when the people are suffering.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
I no really know much about politics behind fuel subsidy removal, but I remember clearly when President Goodluck Jonathan wanted to remove fuel subsidy and the people protested for days which made him change his stance. Today President Tinubu in his first day in office removed fuel subsidy and the people have surprisingly become rational and seeing things from a different perspective. I wonder if all those who protested against fuel subsidy removal during Jonathan’s administration have all suddenly changed their mind on the subject.
I watched one of PBAT videos during the presidential campaign where he bragged that if he becomes president he would remove subsidy and he would also be unperturbed by series of protest from aggrieved nigerians. So if we want to go by what he said... Subsidy removal has come to stay.

Like dis some people dey talk say de subsidy removal na beta tin but na naija wey dey. How are we sure say after we don suffer all dis suffer finish our govt go do the right thing? Me no really get problem with dis new development but naija na one country wey be say de price of things for we country dey defile de law of gravity, if e don go up e no dey come down again.
sr. member
Activity: 602
Merit: 306
I no really know much about politics behind fuel subsidy removal, but I remember clearly when President Goodluck Jonathan wanted to remove fuel subsidy and the people protested for days which made him change his stance. Today President Tinubu in his first day in office removed fuel subsidy and the people have surprisingly become rational and seeing things from a different perspective. I wonder if all those who protested against fuel subsidy removal during Jonathan’s administration have all suddenly changed their mind on the subject.
As them no get choices again naija problems don tired everybody with the way things dey cost day by day in this country if them no change their mind for the new elected president to removal fuel subsidy we know no how this country own go take be, las las most of them wey protested during President Goodluck Jonathan time them too go dey regret now, na why this country matter sometimes no be waiting person go dey put mouth say him support this and that.
hero member
Activity: 1204
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I no really know much about politics behind fuel subsidy removal, but I remember clearly when President Goodluck Jonathan wanted to remove fuel subsidy and the people protested for days which made him change his stance. Today President Tinubu in his first day in office removed fuel subsidy and the people have surprisingly become rational and seeing things from a different perspective. I wonder if all those who protested against fuel subsidy removal during Jonathan’s administration have all suddenly changed their mind on the subject.
sr. member
Activity: 798
Merit: 364
I greet una my fellow 9ja people with maximum respect. No be new thing again say the new administration of PBAT don announced the removal of subsidy and the thing dey cause noise everywhere sortey NLC wan embark on strike. The matter long but make I cut am short and tell una something wey we need to know about the whole issue as explained by the NNPC for their verify Twitter handle link.
why price increase wey June never end?
From the report, we hear say former president Buhari signed till June 30th to cover for the subsidy but that date never reach and the price Don sky rocket reach #500 and above. Wetin cause am? NNPC say since 2022 govt no drop money for the subsidy and govt dey owe them 2.8trl reach this moment, na dem dey use their money to supply the fuel na why dem increase the price now make scarcity no con dey.
why selling old fuel with new price?
Normally na so business be. If you hear about the increment of price for market you no need to allow your former product finish before you increase your price too. Why is it like that? If you no increase the price and you wan wait for your former product to finish that means you no go see new product buy again since the price don increase for market and your money no go reach again.
why NNPC dey fix price?
NNPC say e no dey fix price for anybody. Na you wey dey sell your market go determine your own price depending on how you sef see am buy  Grin no believe anyone wey tell you say na NNPC dey fix fuel price for sellers.
na like this we go dey buy fuel at higher price dey go?
No! This price hike no go continue like this dey go. E go dey change as people are buying and the sellers too go soon dey reduce the price in order to attract more customers to their side. The problem here be say we dey easily adapt to things for this country  Angry
how Dangote, NNPC and other refineries fit help the matter?
Plenty things go take place if dangote refinary begin dey work now and more extra better things if govt own refineries are revive also. Fuel go choke everywhere plenty if we start the refining for ourselves, work go dey for our youths and our GDP go begin smoke to high like kilode 😂


The above contents was culled from the image share by NNPC in the Twitter link provided above in this post with a little modification for better and to aid understanding more easily.
Pages:
Jump to: