You for just carry this your topic as reply go this thread; Four Lucrative businesses you can start in Nigeria because as I read your thread I remember say we dun discuss something similar recently wey concern businesses wey person for do for the country. Me I no too believe physical business because I no too see money for the thing although e dey every presentable based on the country wey we dey wey people go like know wetin you dey do to get the kind money wey you dey spend especially when you dey loud in your spending and when you no fit show dem any better physical business, dem go automatically think say you be illegal person as a yahoo boy or other illegal business and e fit put you for trouble. Apart from this I no see any other reason to engage in physical business if you dey do online and e dey pay you, just for just invest more into other online business and secretly be making your money.
Guess who your patronizers go dey mostly be, na yahoo boys because the average Nigerian no fit buy boutique cloths. Na only yahoo boys and some tech legit internet hustlers wey dey patronized boutique business because things too cost for dat side. Wetin you go see #20k for outside fit be #50k for boutique and this boys no dey price dem but just buy am and na wetin make boutique owners keep on increasing price. So although the business dey recreative but e go take time from you to run as you no need put person for the shop or dem go fall am for you. This days sales boy no dey trusted again as everybody dun open eye. Him fit dey your shop open e own so focusing on internet business is still the surest way of hustling provided say the hustle legit and you can defend where the money is coming from and also maintain low key life so people no go too dey shuku eye for your business.