The term common man here refers to an average man "financially". Man wey e be say e no too get but sometimes e dey meet up with life demands.
Many of us here be "common man" , and I wan talk about how some of us they view Bitcoin!.
So many common man dey view Bitcoin as some gateway to financial stability, which dey very wrong in every aspect.
Them dey fail to see Bitcoin in the same plight as the original creators of Bitcoin. Although even though we no know them , but at least we all know say Dem no create Bitcoin as something wey go liberate people from poverty but as something wey go give person sovereignty over their financial assets.
The common man the fail to see this side , instead them see Bitcoin as some get rich quick scheme.
Everybody now an then dey hurrily invest for Bitcoin or other altcoins without getting proper knowledge of wetin e be Dem dey dive into.
If only dey common man fit see Bitcoin the right, Bitcoin for dun fulfill it's true purpose wey dem creators carry for mind.
I understand watin you wan pinpoint for here. Shay the main the main message na say make we no enter crypto as get rich quick scheme without proper knowledge? That one na true talk. But watin I wan pinpoint for here be say;
First of all na main reason for the creation of Bitcoin. The same way weh money get about 5 functions but only 3 be Im main function, and 1 be I'm first main functions, na so Bitcoin take dey too ( not in the same amount of functions though). The thing be say, Bitcoin start as a result of the 2008 economic global crisis, na im Satoshi mine the first Blockchain write message for inside. The message been contain the date and news for that day, weh been talk about bailouts from banks.
After all this talk, I just wan dey on the fact weh be say, the creation of Bitcoin na for decentralized transactions. Na that one be the main reason before asset sovereignty and protection from inflation Dem Dem follow. So, if someone sees it as a liberation from poverty, when it first came out didn't it serve as a liberation from economic crisis too?
Secondly would be diving into Bitcoin without knowledge. This may be a very contradictory opinion, but isn't diving into something sometimes without knowledge, better than acquiring all the knowledge in the world and still not taking actions? I think it takes great courage to just try your hands on something even when you know nothing about it and how risky it is. Don't get me wrong, this may be the main reason why people say Bitcoin is scam. True, but if one has a positive mindset, they'll take it as a form of growth.
I no Sha tell you make you go risk your last card unto say you dey try learn
but make we no dey deceive ourselves say we dey learn, dey gain proper knowledge, no con dey do anything, cause then, the man who lost his money but has invested before is now probably better than you that think knows it all.