Pages:
Author

Topic: the decline in price of bitcoin - page 2. (Read 371 times)

member
Activity: 364
Merit: 44
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
May 03, 2024, 08:54:03 AM
#9
There is no need for panicking those that has been in the market for long is of more advantageous as they don't easily shake with situation like this they are made with information that always guide them, it's clear with some pin post that after halving there is always some dropped in BTC before it will come up again and this period always stand out to be the best to accumulate as much as one could for me instead of mornitoring the market and be having some fear now just to concentrate on accumulating  would have stand the best.

Though some sell off there BTC because of fear but they may regret at the end when the bull will fully enter the market.
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
Fully Regulated Crypto Casino
May 03, 2024, 06:46:49 AM
#8
 Na better talk you raise here, this one na normal thing wey dey happen after the Bitcoin halving event, sometimes eh go drop very low beyond expectations and that go make plenty people to dey panic say them go lose their coins but make dem no fear because the coin go still pump again after a while and I get believe say eh go still set another ATH too, so this na opportunity to buy more, instead of selling make everybody wey dey invest in Bitcoin buy as much as dem fit buy especially for people wey dey ready to invest for long term, this na the right time to buy more so them go fit make profit when the coin go begin pump again. As for newbies wey get small knowledge about Bitcoin, i wan tell una say make una no dey misled by those social media talk, I hope say by now una suppose done know say Bitcoin dey volatile in nature, sometimes eh dey increase and sometimes eh dey decrease too, but when eh decrease make una no go panic sell coins so una no go regret when the coin pump again. Currently Bitcoin na the  crypto asset wey em face show pass so eh go make sense to seize the opportunity to invest for that kind asset when the price drop, imagine wetin people wey invest when the coin been dey 18- 20k dey enjoy now.
sr. member
Activity: 378
Merit: 285
May 02, 2024, 02:38:32 AM
#7
Normally watin you talk no bad, bitcoin just dey like priq wey be say after e don cum e go fall to rest small and Jack up again. People wey don tay for this business no need encouragement again because we don see the wonders way bitcoin fit do. Na in make our people talk say watin elders see while sitting the youth no go fit see am even wen dem climb on top iroko tree. This dip was expected, so e no dey move me at all, I stand like orji nothing go shake me. Me I been don already know say days like this dey come, so I started on time to keep some liquidity to carry pack the bitcoin, as the dip keep hitting deeper. That's why dem dey always talk say better preparation dey prevent bad performance. For people wey Sabi the business, dem go know say dip period na im people dey become millionaires. People that bought the dip by the way.
full member
Activity: 350
Merit: 128
May 02, 2024, 02:24:09 AM
#6
Most valuable caption on this thread is that lot of Investors who expected a quick rise on the bitcoin immediately just after the halving and those who're panicking probably because of the approach falling of bitcoin would likely to switch there crypto assets to AltCoins.
It's really going to be regrettable for Investors like that and to those who'd be feared to buying on the DCA around this Dip event.
full member
Activity: 266
Merit: 120
May 02, 2024, 01:41:32 AM
#5
I learnt that $300 million was liquidated from the crypto market that was the reason for the fall. As people are expecting an increase in the price of Bitcoin, others are also waiting for a dip for them to come in so with the dip that occurred recently, we should be expecting a rise any moment because a lot of investors will seize the opportunity to accumulate more Bitcoins. The dip is also part of the post halving corrections that is meant to occur so there is no cause for panic. Keep hodling and better still acquire more when a dip occurs.
full member
Activity: 588
Merit: 119
Epsiloan Protocol
May 01, 2024, 05:07:48 PM
#4
actually na normal thing say after bitcoin halving we go come experience the price correction wey go make the price of bitcoin waka come down, just like how e come down after bitcoin reach the previous ATH of $68k. so normally the price of bitcoin fit go down well well but person wey know em left and right know say bitcoin go still rise again because after the price correction na better pump in price naim we go see. the news and some social media talk dem fit present the matter in a scary way but make una no panic especially the newbies, if your aim na to invest for long term then you no suppose get issue with this changes because every great story start from somewhere and if to say some of those big holders quit them for no dey where dem dey today. i no too like the idea of selling bitcoin to buy altcoin this period because na now we go see many of those altcoins turn to shitcoins, and since bitcoin go experience some dip why not channel more fund to buy at a cheaper rate so that when the price pump again you go get better profit for hand?



This dump we are presently seeing is normal. And this is the right time for new investor to come in using DCA. Although most newbies that hold BTC may be scared of this dump but i will advice them not to sell in fear. BTC is coming with a great pump soon. Selling your BTC to buy altcoin is a very wrong idea. Even BTC are the one than control the price movement of this altcoin most time. Then why selling it to buy what you are not certain of making profit from.
sr. member
Activity: 574
Merit: 252
May 01, 2024, 01:03:39 PM
#3

Nah normal thing for most people to panic expecially those wey still dey new to Bitcoin, but still I nor see any reason for any panick , just as op  said after halving market go experience dip in price before the main skyrocketing or bull run. Right now I believe say alot of people dey happy sey Bitcoin dip , because dey first missed the opportunity to buy when the price never rise reach like this  .

So no need to rush things make the dip come seff , after all we know say Bitcoin go still rise massively, and nor forget say the number of Bitcoin stashed nah determine the kind profit you go make. When the bull run come . That why most time dem go say make you get better quantities first before thinking of Taken profits from your holding or investment.

So make we take bitcoin investment serious and make we no dey take advice from people wey no too sabi about bitcoin because dem fit mislead you to make wrong choice. You know say some people dey get that mindset and that convincing spirit of making you do Wettin dem do. After you don make wrong decision dem go come dey blame you. So make we try invest now and make we no listen to decivers.

Well that's true, this is not even the time to tell people all this one because they supposed to dun know say bitcoin nor be wetting dem dey joke with , see funny thing Is that most people that are aware of this nice opportunity go still miss am due to trying to play smart, like waiting for more dip before accumulating any quantity for themselves (which is messed up that why e always dey nice to accumulate with DCA). While some go grab this opportunity tey change their life for the better, now Is time to take action and accumulating than to assume whether they will be more dip or the price go increase fast.
sr. member
Activity: 462
Merit: 355
The great city of God 🔥
May 01, 2024, 12:44:27 PM
#2
Sincerely speaking na now wey bitcoin don drop wey people sopos invest more on bitcoin. Just as you talk say after having say bitcoin dey expirence correction before E go rise again, we sopos take advantage of am before E go rise again. To invest shitcoin or altcoin na just like gambling wey person fit win or lose. And the chances to win dey always dey slim. For me bitcoin na the best investment, though E dey slow to grow in price compeard to altcoin dem wey dey pump and dump. But bitcoin dey gradually grow and E dey grow on solid foundation meaning say e no go fit disappoint person. E dey reliable trusted. So make we take bitcoin investment serious and make we no dey take advice from people wey no too sabi about bitcoin because dem fit mislead you to make wrong choice. You know say some people dey get that mindset and that convincing spirit of making you do Wettin dem do. After you don make wrong decision dem go come dey blame you. So make we try invest now and make we no listen to decivers.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
May 01, 2024, 12:22:24 PM
#1
actually na normal thing say after bitcoin halving we go come experience the price correction wey go make the price of bitcoin waka come down, just like how e come down after bitcoin reach the previous ATH of $68k. so normally the price of bitcoin fit go down well well but person wey know em left and right know say bitcoin go still rise again because after the price correction na better pump in price naim we go see. the news and some social media talk dem fit present the matter in a scary way but make una no panic especially the newbies, if your aim na to invest for long term then you no suppose get issue with this changes because every great story start from somewhere and if to say some of those big holders quit them for no dey where dem dey today. i no too like the idea of selling bitcoin to buy altcoin this period because na now we go see many of those altcoins turn to shitcoins, and since bitcoin go experience some dip why not channel more fund to buy at a cheaper rate so that when the price pump again you go get better profit for hand?

Pages:
Jump to: