Pages:
Author

Topic: The internet and crypto - page 2. (Read 330 times)

hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 04, 2024, 05:38:41 PM
#15
The first wave happens in 2021 which I believe sae, many people miss am because of sae dem no believe in crypto or dem no hear of am

But me I no believe say 2021 na the first wave of cryptocurrency oo. Before that time we don get previous halving and particularly the season wey really create awareness of bitcoin na around late 2016, 2017 and 2018 bear season. Those times altcoins self follow enjoy small rally apart from 2021 wey Elon musk them follow dey make market make noise.

So regarding the body of the post how the internet go fad away, we don see the scores na. We don see say government work no even see draw for the kind of benefits locked on the internet. If no be internet self, wetin person for do? The internet provide fast information, na knowledge base for some people too. Once you ask google answer don show. Internet don provide skills and jobs alot. For naija economy, if no be internet, many people for dey stranded. Make we just count wetin internet don do for persin, people dey trade, hodl, do P2P etc
member
Activity: 196
Merit: 25
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
February 04, 2024, 12:34:24 PM
#14
Years back(21 years ago), a fella wrote something about the internet in a newspaper, stating on how the internet go be a fad as people go give up on am.
Picture and link below:

https://regia-marinho.medium.com/internet-may-be-just-a-passing-fad-the-newspaper-said-21-years-ago-153aae2e0c2f

Here we are today, year's later, the internet making people millionaires, of people wey d engaging on am in diverse  ways. The same thing the apply for where crypto dey. People still d call crypto scam, d no wan believe on am or have anything to do am. In years to come, na so wey go d hear the laugh people wey d call crypto scam.

Time will tell, to every better thing wey person d do. You won't see the result fast but believe me, it will happen someday with your head up straight hoping for the best to come.

My advice na for peso to keep investing in crypto and don't give up on am because someday em go make you millionaire. This go be second wave of crypto wey go make people millionaires. The first wave happens in 2021 which I believe sae, many people miss am because of sae dem no believe in crypto or dem no hear of am

My cry is not having the information of crypto early, but I thank creator I have the information now  and decision has been made already not to give up. Any thing your doing without criticism know that you have not started, there are people that don't believe on change even when everything around them is changing is still appear as mirage to them. I don't pray to be in the company of Thomas that don't believe even when they are seeing because they will discouraged you if your strong enough. Crypto currency, Bitcoin is out to change the work time will tell it will be like fela, statement in crypto we stand.
full member
Activity: 238
Merit: 152
Duelbits.com
February 04, 2024, 12:02:15 PM
#13
Years back(21 years ago), a fella wrote something about the internet in a newspaper, stating on how the internet go be a fad as people go give up on am.

My advice na for peso to keep investing in crypto and don't give up on am because someday em go make you millionaire. This go be second wave of crypto wey go make people millionaires. The first wave happens in 2021 which I believe sae, many people miss am because of sae dem no believe in crypto or dem no hear of am
To dey invest for crypto na very nice something wey many people never dey really understand because dem tink say maybe e no dey really work or na only street buys dey uses  am but Sha e get pipo wey Sabi d crypto Waka well and dem understand how e b so dem dey try invest and e dey help dem do sometinz. Most times dem for u to get better money from cryptocurrency na to invest for long time no be say u go out money dia today den tomorrow u don go collect am back because dat pattern na just small small money u go dey collect but if you wait like as bull run dey come now if I don buy Bitcoin na you fit wait till next year make you for collect better money.

Well this era now d internet don help people pass as dat man wey u refer to earlier been talk because most of the crypto Waka and other work like freelance na ontop internet we dey do am so na more like just internet money be dat .
full member
Activity: 588
Merit: 119
Epsiloan Protocol
February 04, 2024, 06:30:03 AM
#12
I know back then that people will never believe the internet can turn out to be this. Alot of people cash out from the internet now. Just as you have said, the same thing has happened to crypto in 2021 and we till expect more to come. Alot of people missed out in 2021 not because they think it's a scam but because they lack information about it. The internet and crypto has worked together in recent time to make cryptocurrency more popular among people. I believe the next bullrun will turn out to produce alog of millionaires which I will definitely be among. This is a call for all, but few will listen, congratulations to those few that listen.
full member
Activity: 140
Merit: 63
January 27, 2024, 10:17:46 PM
#11
You know one thing wey dey there be say, sometimes musicians they talk in parable but you no go know where there message they go. According to internet description fud means fear of uncertainty and e also dey for cryptocurrency being cryptocurrency fud.

Now if you check the meaning of cryptocurrency fud wey I give link above you go see say the meaning na wrong speculation about something, and that also implies say internet na a place for wrong speculation and true true fela dey right for my own point of view. Him dey doubt wetting internet go later turn to, because e go cause more harm to people than good just as this internet and cyber criminal dey scam people like this and our young girls dey die steady, na the cause of internet Naim be the fud I see say him dey fear.

But him no too see the brighter side of am but at a point wetting him talk na true. Just that the youth they struggle to make sure say them take advantage of the internet and make something tangible out of it.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
January 27, 2024, 07:22:59 PM
#10
After how many years of that statement see the internet now. When something they progress e get plenty persons wey go believe say that thing na scam or e go soon crash. Currently like this, wattin that guy do, na wattin our news feeds and some social Media influencer they do now, but relating to Bitcoin and cryptocurrency. Some believe say Bitcoin an still fake, while others go dey share false information make panic for dey, and people go dey sell their coins to loss. Anyway, that na why we dey always talk say make we no believe everything wey dey come from the news ma y of the person behind na based on hatred or wickedness niam dey make Dem share all those false news .
member
Activity: 238
Merit: 54
January 27, 2024, 06:15:49 PM
#9

  The crypto world is increasing at 113% in a year that is, its users ,the cryptocurency fast growth transit not having breaks the internet sudden increase  in decades  before the expected time .
   The most important quality is about Bitcoin fast adoption rate  much higher than the internet ,Bitcoin ascertain to million users in about few year . At 2019,Bitcoin users double the numbers of people using the internet within there first 10 years .
full member
Activity: 224
Merit: 195
January 27, 2024, 03:21:16 PM
#8
Everything around usually happens with time while change remains constant making more people to adopt and adapt to a new idea, pointing at Bitcoin in due time more and more people will gradually see the benefits, we don't espect it to happen in a blink of an eye, it takes willingness and enough conviction for a person to decide on investing his money into Bitcoin. Likely said, we just have to keep our head straight waiting for the best.
full member
Activity: 504
Merit: 198
My privacy, my right.
January 27, 2024, 03:01:34 PM
#7
Generally if we want look am in real sense ehh no be everybody go start to do crypto at same time, eim no wan get as you wan take preach am wey go make all the people jump into am at once. Only say no just pray make you be the part of those group of people wey go come into am when it done the reach the buttom pot cause by that time cryptocurrency like bitcoin go don dey expensive pass wetin eim be today because by then the value go done long. If you dey so lucky to meet am now nah to just the manage your hand the invest wetin your hand fit reach either weekly or monthly or anytime wey eim dip just like right now wey the price don fall na beta time to buy am too. But no dey forget to only invest wetin u fit lose oh
member
Activity: 66
Merit: 5
Eloncoin.org - Mars, here we come!
January 27, 2024, 01:31:44 PM
#6
The truth is sometimes we need good explanations or evidence to believe in something, yeah most of us here most have heard of Bitcoin but because we weren't exposed to it much we could be part of it since the origin.
As comparing the internet with Bitcoin (cryptocurrency) including shitcoins it's about enlightenment, the more time passes by the more evidence are shown then it becomes very clear of how important it wouldn't be even the creator of internet wasn't aware of how big his creation would be for decades so the forecast of internet failing was from so biased experiences not experimented. one thing is every one of us got the right to speak some openly abuse this rights by saying whatever the gods put in thee heads.

We are begining to experience most of the predictions of the future so Bitcoin and the internet works together, and in few years (over a decade) people will become so into internet and Bitcoin because they might get it more clear by then mind you there are still billions of people under autocratic leadership so they may not know about Bitcoin till their autocrats introduce it to them including the interior villages.
hero member
Activity: 798
Merit: 547
Leo is resting.
January 27, 2024, 12:37:47 PM
#5
For me eeh I believe say person wey talk about Internet say many people go dey fed up on  am no really see road well, Internet self don create more employment opportunities pass our government I believe say na the reason why dem never come out ome talk say make we no dey use Internet again because the evidence already don show everywhere say people no fit survive without making use of Internet.

Now coming to this era of crypto, (Bitcoin) e get plenty things wey we need to consider even though we don already dey benefit inside. Na person wey get money go fit invest for cryptocurrency and to get the money wey you take invest you still need to wait until the price increases which most people especially for our country naija no wam take ear hear because most of them believe in as e dey hot or sharp sharp profit. Our government na another reason why most people for our country dey fear to invest in Bitcoin, today dem go hear say dem fit do Bitcoin business for the country tomorrow another information go come out you no say no body wam lose money for na fear dey the minds of most people wey get money to invest but no wam invest.

Another problem be say no be everybody go fit do this business no matter how simple and easy we fit say e be, no be everybody fit dey monitor when the price dey favourable to buy or sell as some people dey only use phone to answer call especially people wey dey village wey network and Internet no strong how you fit say dem go do investment when dem no get access to good network?
full member
Activity: 294
Merit: 172
January 27, 2024, 10:00:40 AM
#4
Years back(21 years ago), a fella wrote something about the internet in a newspaper, stating on how the internet go be a fad as people go give up on am.
This is a common character of critics who always go against anything they don't understand or see the bigger picture of. I don't know why they do this but most of them do it for attention purposes only not that they actually mean what they are saying. I only feel bad for people who get deceived and discouraged by these folks!

Here we are today, year's later, the internet making people millionaires, of people wey d engaging on am in diverse  ways. The same thing the apply for where crypto dey. People still d call crypto scam, d no wan believe on am or have anything to do am. In years to come, na so wey go d hear the laugh people wey d call crypto scam.

Time will tell, to every better thing wey person d do. You won't see the result fast but believe me, it will happen someday with your head up straight hoping for the best to come.

My advice na for peso to keep investing in crypto and don't give up on am because someday em go make you millionaire. This go be second wave of crypto wey go make people millionaires. The first wave happens in 2021 which I believe sae, many people miss am because of sae dem no believe in crypto or dem no hear of am
Cryptocurrency go still do some people like the internet, them no dey ever learn. Anything wey you see others dey do wey dey ligit, instead of criticizing them, follow them and see how e go be latter. Bitcoin don stay more than 10 years, scam no dey last like that. Na wetin people no know be that. Me I no dey force anybody o, our economy is already showing everybody shege.

One thing ah done understand about dis life be say u no go fit force people to do weting dey never get conviction on. Ah go fit hit my chest say na only some adults wey still they ignorant of the internet and cryptocurrency. Dem still get this fear say anything wey dey online na scam. Yet dey still they use Facebook, WhatsApp, TikTok, and other social media every day. No be mumu be that, na for the WhatsApp, wey dey no go fit use scam them?
My brother the thing dey tire me o. You believe say the internet na all about scam yet you dey sleep for the internet everyday. Na you dey current pass for wetin dey happen for the country and the world. Wetin I notice be say, those wey get this believe of internet being scam no dey ever make money for the internet. Them go dey there money dey fly them why others dey use the opportunity the internet offers to cash out major.

full member
Activity: 168
Merit: 109
January 27, 2024, 09:16:38 AM
#3
One thing ah done understand about dis life be say u no go fit force people to do weting dey never get conviction on. Ah go fit hit my chest say na only some adults wey still they ignorant of the internet and cryptocurrency. Dem still get this fear say anything wey dey online na scam. Yet dey still they use Facebook, WhatsApp, TikTok, and other social media every day. No be mumu be that, na for the WhatsApp, wey dey no go fit use scam them?

Normally dem done see am say all those people wey dey sell for market, some of them done loose customer since people no get time to they go some kind places go buy things. Instead, they prefer to order am online. If they still continue to they ignorant, the world go advance leave them behind.
full member
Activity: 364
Merit: 154
January 27, 2024, 08:25:56 AM
#2
True, if I was familiar with crypto well that period e go for nice because that time things beta for our contri pass now, now things duh hard some how even most goods duh dey expensive. This time around before one month salary go carry person for that whole month nah big issue. But still meh still got to invest even though now 5% or 10% of his earning or salary.
Because this next wave wey dey come so nah to follow am well make nor go be say nah "had I known" con go end am that we got to accumulate more BTC if nah DCA method run am. So that at the end wetting when you look your portfolio big smile go appear for your face . Cheesy
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
January 27, 2024, 08:16:08 AM
#1

Jump to: