Diz 1 fit be off-topic but eh get another scam way d go on 4 pH city and Lagos nah 2 city way I don visit way I experience am. Some group of people go separate dre self, some times self eh go be person like elderly man or woman, dem go come dy tell u story like, dem come deliver something dem from far place (fine name of 1 city call) then them go come tell u make u direct them for somewhere way them no say no even they d location, the way dem go talk u go even pity them, u go say make u help them try fine the place 4 dem with fear make dem no go fall enter wrong hand, but as onah they waka they go nah so in group go they join onah small small him go aslo they ask dem same question, some of them go follow dy suggest say make onah help am, b4 in go fall enter wrong hand, watin dem go just they fine nah to dy convince u they waka with them comot 4 ur area where u fit sabi people, wen onah reach were them dy convince say them fit dope u, then language go change. Few of dem I believe say them no they use ordinarily hand, as u and dem just follow they talk u don they fall for their scam, why some nah ordinarily with brain way dem they use enter person. I almost fall victim 4 pH until I come notice am my self. All of us just need dy careful any where make we fit use our head identify the small scam way doz people way they outside go wan scam us.
🤣🤣🤣 This ones them be touch and follow them fit even scam you collect every every from you even sell you to ritualist wey Dem don already make connect for. These days person needs to be much careful o as many things dey happen.
Another one wey dey make me laugh na this neolife people aka am I right, I am wrong people. Their matter tire me sotey my tire don tire. If you see them na their shoe you go take know Dem don trek tire sotey their shoe sole dey beg Dem so try help patch dem well.
Those people them be another one chance people and time wasters.Make you pray not to enter their cycle .