Pages:
Author

Topic: The need to learn a high paying skill - page 2. (Read 208 times)

member
Activity: 168
Merit: 75
March 13, 2024, 01:08:28 PM
#2
I for say e no really matter o but as the world be so e dey really important because the country no funny again, everywhere tough, to survive no really dey easy na e make e make sense say person supposed learn work wey be say the pay dey okay to take care of you and your bills. No be to do the one way no go dey give us chance but the one wey dey easy small like engineering or online business, as we dey work for Bitcointalk like dis, even to go learn work like coding and cyber security.
full member
Activity: 182
Merit: 109
March 13, 2024, 04:44:53 AM
#1
Good morning my country people, today I wan talk about skills wey fit change our life, because education alone is just not enough if you must succeed, you know say you don't have to go to school to be successful, but need to go to school to be enlightened.

See eh, the way tins dy go, even as a graduate, if you no get high paying hand work or skill, e no go easy for you, regardless of ur educational background, so e dy  important say if we want live well for this naija wey we dy, try your possible best to learn a high paying skill like trading, coding, web designing, online marketing skill,  learn how to sell, you fit no be the richest, but I believe say if you dy good in any of them, poverty no go knock your door, make ona reason am.
Pages:
Jump to: