My country people good afternoon inside this afternoon, see eh, anything wey we dy do, make we try all our best to gain knowledge, because even bible talk say knowledge is profitable to direct, see eh, most people for we country wey dy misinformed or wey lack knowledge believe say once you dy press phone or laptop too much, mean say you be scammer or yahoo boy, make we look around us for we country, almost all the people doing well get one or two knowledge about something wey dy pay dem well, ok make we talk about dis crypto industry now, those people wey lack knowledge about the industry, na dem dy mostly go lose money for trading and scammers hand pass because them no know whats up, some of dem dy even invest serious money in shit coin because them lack knowledge, wen de coin fall and refuse to rise again dem go generalize am say crypto generally na scam, or you wan talk of those people wey dy give people money to trade for dem? All this tins dy boils down to lack of knowledge.
I don even see one young fine guy wey one white man wan give one good job like that, because him no sabi read, the man no just know how him fit help am again, because na guy wey him just like, and the job demands documentation, so why I dy tlk all this tins is that make we seek knowledge with everything we get abeg, because e get why.
Na true you talk o, because the right knowledge fit help person comot for poverty. Afterall, poverty na state of the mindset and na deficiency of the right money making knowledge na em make many just dey suffer in poverty.
Besides the acquisition of the right knowledge, e no dey enough not to put am to practice, that na why them say as person dey try acquire the right knowledge, make em pray for the wisdom to apply the knowledge to benefit him/herself and family and friends.
E even dey good for person to solicit the help of a good crypto broker so as not to loose much unlike when such a person invest in shitcoins inorder to get rich quick and then come dey shocked when the market crash or something like scammers hack their account and cart away with all their funds.
Those wey dey invest in crypto with little to no knowledge of am, go actually learn from their experience if them dey concerned so much as to know why them loss their funds. Else, crypto currency no be scam and as we don know, na the future of money be crypto. So anyone wey dey learn about am now or practicalize the knowledge wey dey don get so far, dey very much ahead of anyone wey just sit down dey shine eye look.