Pages:
Author

Topic: US Don Knack Visa Restriction (Read 234 times)

hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
June 03, 2023, 07:57:40 PM
#27
Finally US don impose visa restriction for all those politicians and other people wey dem catch say dem try scatter our presidential election for February1.


Taah! Make Us get out!
Who dem wan deceive? Na today I begin hear visa ban for US and layer on those people go still travel.
Na so we hear visa ban for Atiku and Atiku still travel go US. Na only person wey want make dem deceive am dem go deceive.
You give visaban finish for election mal practice and still send delegates to inaugurate the president wey the election mal practice produce. Make una dey play! Just dey play!.
member
Activity: 159
Merit: 39
June 03, 2023, 03:44:16 AM
#26
 E no be today wey the whites don dey consan diasef wit our mata. If na so dem dey use wan correct the election anomaly, why dem no put eye the court case wey Obi bin get against Tinubu, abi no section for the law dey against election rigging?
To me dis na to show say we dey claim independence and INEC dey claim say dem dey on dia own yet we still dey get interference from outside. Dis wan na see finish wey boro boro don cus.
newbie
Activity: 57
Merit: 0
June 03, 2023, 03:13:25 AM
#25
Finally US don impose visa restriction for all those politicians and other people wey dem catch say dem try scatter our presidential election for February1. Wetin dem do, dem intimidate voters, dem follow to manipulate the results, dem carry thugs to go snatch ballot box, kidnap INEC staff, bribe the electorate etc. Most of these terrible people already get family for US or dem like to dey go there go run one or two matters. As e be like this sef, we never see any list and dem nor go release the list to people wey dey affect. These people go know when dem go embassy wan to apply for visa.

Quote
Taking Steps to Impose Visa Restrictions on Individuals Involved in Undermining the Democratic Process During Nigeria’s 2023 Elections Cycle
The United States is committed to supporting and advancing democracy in Nigeria and around the world. Today, I am announcing that we have taken steps to impose visa restrictions on specific individuals in Nigeria for undermining the democratic process during Nigeria’s 2023 elections cycle. These actions are specific to certain individuals and are not directed at the Nigerian people or the Government of Nigeria as a whole.

Under Section 212(a)(3)C) of the Immigration and Nationality Act, these individuals will be subject to restrictions on visas to the United States under a policy covering those believed to be responsible for, or complicit in, undermining democracy. These individuals have been involved in intimidation of voters through threats and physical violence, the manipulation of vote results, and other activity that undermines Nigeria’s democratic process.

The decision to take steps to impose visa restrictions reflects the continued commitment of the United States to support Nigerian aspirations to strengthen democracy and the rule of law.

As much as I like wetin the US don do, e go still make sense if other countries like UK, France, China, Japan, UAE, Saudi Arabia, Qatar, Korea and all these other nations fit do the same. But e go hard because even some of these other nations dey benefit from these guys big time. E go also make sense if the visa restriction fit touch their family members as well -  their wife, children too.

Shey una agree say visa restriction nor dey enough. Which other measures una feel say dem suppose add to this visa restriction?


https://ng.usembassy.gov/taking-steps-to-impose-visa-restrictions-on-individuals-involved-in-undermining-the-democratic-process-during-nigerias-2023-elections-cycle/


This just the hypocrisy of the Western world, for me it will not solve our problem as country. It has been a normal routine after every election, all of the corrupt politicians are still buying properties over there without any restrictions
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
June 02, 2023, 05:28:47 PM
#24

How I wish them fit point out those people e for better for we nigerians but at this, they refused.
Do you think if names were mentioned something bad would have happened to those that has been already swore in power last month and that's what I noticed, they don't want to be the architect their down fall so they made it uncovered to we Nigerians.
[/quote]

No mind those men my brother, all of them know werin dem dey do finish and I just dey feeling say them know wetin we citizens  and common man dey like which is simply  hype and the moment  them hype one small issue everybody don lock up dey happy and one of the time wey we youths for gain the country na the end sar protest bjt we gave up and at some points I dey feel say my personal  efforts and risk i took in going out that day was a total mess as those same sars men still dey patrol and we still dey get very serious fear for them because of how likely them fit easy harass person.

If the US  embassy  know say them dey fight and support the common  man, them for make the names public.
hero member
Activity: 1400
Merit: 650
Always Act Smart and Play Safe With Your Funds
June 02, 2023, 05:11:48 PM
#23

I just dey see this thread and I also notice say plenty of una really write out of bitterness  and I really feel bittered writing on this thread now because we dey really see how the election was rigged openly and yet we no fit still do anything and this act na very big slap on our faces as citizens because this men do this beating on their chest say nothing go happen  and actually nothing  don happen and now na inauguration we just finish and I come dey reason who wan carry power comot from GCFR wey really find power come see?
If na you,  you go gree?
I just dey imagine the hope of bitcoin  and cryptocurrency  at large for this administration and I just pray we no go dey bind like fraudsters simply because we get bitcoin.

And I no really see this ban as something wey serious because if the embassy  really mean wetin dem talk, them for make open the names of these men so incase we been say them for those countries, we fit point to their publication openly but no, because all of them na the same.
How I wish them fit point out those people e for better for we nigerians but at this, they refused.
Do you think if names were mentioned something bad would have happened to those that has been already swore in power last month and that's what I noticed, they don't want to be the architect their down fall so they made it uncovered to we Nigerians.
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
June 02, 2023, 11:48:02 AM
#22
Now we must learn a lesson on how to build and develop our country by ourselves instead of using our hands to scatter the good the thing God had gifted us, how I wish they would ban or restricted all the politicians that could have been more better than just few individuals. However they should released the list of those individuals let us know the evil doer in our country to enable us get the needed president to rule the country.
If this is actually authentic then there will be serious problem before 29th of this month when the swearing in would take place.
I just dey see this thread and I also notice say plenty of una really write out of bitterness  and I really feel bittered writing on this thread now because we dey really see how the election was rigged openly and yet we no fit still do anything and this act na very big slap on our faces as citizens because this men do this beating on their chest say nothing go happen  and actually nothing  don happen and now na inauguration we just finish and I come dey reason who wan carry power comot from GCFR wey really find power come see?
If na you,  you go gree?
I just dey imagine the hope of bitcoin  and cryptocurrency  at large for this administration and I just pray we no go dey bind like fraudsters simply because we get bitcoin.

And I no really see this ban as something wey serious because if the embassy  really mean wetin dem talk, them for make open the names of these men so incase we been say them for those countries, we fit point to their publication openly but no, because all of them na the same.
full member
Activity: 308
Merit: 197
May 31, 2023, 12:51:33 PM
#21
 I dey very happy for the step wey us done take to fight against those corrupt politicians wey they against democracy for this Nigeria, at least make them follow suffer the consequences of their acts, because if Nigeriabetter today eh go better for everybody and if eh bad as well eh go bad for everybody too.
 I wish say all other developed countries as well go follow join the U.S give them ban as well, because na that one to force them to change tcountry country, by leaving good examples, building good hospitals and other basic amenities, creating jobs for the youths.
 Instead of carrying their children to big schools abroad, they go come develop our tertiary universities, make am standard for our students to get proper education, no be even say the children of politician wey them dey send abroad to go learn they come back with those knowledge gained from to quality education gained from abroad to come develop and become beneficial to our country, so what's the essence, most of them wey get business and industries for united states go they forced to bring I'm come back Nigeria, which go dey very beneficial to our youths because eh go create employment.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
May 26, 2023, 04:45:49 PM
#20
The United States cannot make such law enactment into action because they also realized what they will be loosing at the cause of this, by now we should be familiar with the economy and political propaganda they make to the media but were not being made effective in the reality, it is not possible for the United States to lay restriction on the country base on it internal affairs since we are no longer under colonial era, this sanction can't be effective because they will also loose part of their economy progress realize through international commonness and relationship, when I heard the news I'd thought about it that it may not be effective because they will be affected through the international ties we had together.
My bother, I no sure say you really follow watin OP talk o. E no dey refer to the country as you dey try imply. Na on specific individuals for we country way th feel say, there hand dey involved in all th malpractices way happen for we country during the presidential pools. Na watin OP dey try talk and on that base, that dey very possible and e no big pass them to do.
We big pass Russia way them boycott due to this them wahala of recent... Them go lose something but, them go gain something as well. Na why them be world power, na there place to put body and few people no suppose dey intimidate full country and undermine Democratic process.
sr. member
Activity: 490
Merit: 308
May 23, 2023, 11:20:03 AM
#19
This visa restriction wey USA government give to Nigerians wey dem cash for the 2023 general election no nonsense. Na innocent politicians nai dem go ban and not the real criminal. If dem won to do dat, they should first of all arrested or ban The INEC Chairman, because he is the prime suspect for the whole Election of the year.
Well na true you talk but the matter be say the whole system of government and their policy no dey work like that, everybody no say na for this country the real course of this election matter dey for the hand of the inec chairman and the number citizen himself because na only them nai get power to stop this nonsense wey dey happen for our national elections. And the whole after effect dey always fall back on innocent people and na so this case sef don be.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
May 23, 2023, 10:21:10 AM
#18
Finally US don impose visa restriction for all those politicians and other people wey dem catch say dem try scatter our presidential election for February1. Wetin dem do, dem intimidate voters, dem follow to manipulate the results, dem carry thugs to go snatch ballot box, kidnap INEC staff, bribe the electorate etc. Most of these terrible people already get family for US or dem like to dey go there go run one or two matters. As e be like this sef, we never see any list and dem nor go release the list to people wey dey affect. These people go know when dem go embassy wan to apply for visa.

Quote
Taking Steps to Impose Visa Restrictions on Individuals Involved in Undermining the Democratic Process During Nigeria’s 2023 Elections Cycle
The United States is committed to supporting and advancing democracy in Nigeria and around the world. Today, I am announcing that we have taken steps to impose visa restrictions on specific individuals in Nigeria for undermining the democratic process during Nigeria’s 2023 elections cycle. These actions are specific to certain individuals and are not directed at the Nigerian people or the Government of Nigeria as a whole.

Under Section 212(a)(3)C) of the Immigration and Nationality Act, these individuals will be subject to restrictions on visas to the United States under a policy covering those believed to be responsible for, or complicit in, undermining democracy. These individuals have been involved in intimidation of voters through threats and physical violence, the manipulation of vote results, and other activity that undermines Nigeria’s democratic process.

The decision to take steps to impose visa restrictions reflects the continued commitment of the United States to support Nigerian aspirations to strengthen democracy and the rule of law.

As much as I like wetin the US don do, e go still make sense if other countries like UK, France, China, Japan, UAE, Saudi Arabia, Qatar, Korea and all these other nations fit do the same. But e go hard because even some of these other nations dey benefit from these guys big time. E go also make sense if the visa restriction fit touch their family members as well -  their wife, children too.

Shey una agree say visa restriction nor dey enough. Which other measures una feel say dem suppose add to this visa restriction?


https://ng.usembassy.gov/taking-steps-to-impose-visa-restrictions-on-individuals-involved-in-undermining-the-democratic-process-during-nigerias-2023-elections-cycle/

The United States cannot make such law enactment into action because they also realized what they will be loosing at the cause of this, by now we should be familiar with the economy and political propaganda they make to the media but were not being made effective in the reality, it is not possible for the United States to lay restriction on the country base on it internal affairs since we are no longer under colonial era, this sanction can't be effective because they will also loose part of their economy progress realize through international commonness and relationship, when I heard the news I'd thought about it that it may not be effective because they will be affected through the international ties we had together.
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
May 23, 2023, 06:47:27 AM
#17
This visa restriction suppose don tey self, so that all of dem wey de run go stay and develop other people country leave their own go learn lesson small.
Wetting de vex me be say even our leaders wey supose lead by example de go treat himself abroad because dem no gree repair our own hospitals, and dem de send their children go school for there because dem know say dem no structure our own educational system well.

As much as I like wetin the US don do, e go still make sense if other countries like UK, France, China, Japan, UAE, Saudi Arabia, Qatar, Korea and all these other nations fit do the same. But e go hard because even some of these other nations dey benefit from these guys big time. E go also make sense if the visa restriction fit touch their family members as well -  their wife, children too.
Meself de support dis one, so that dem no go get choice then repair and set our own hospitals and schools under good condition to attract people from countries to come and study here with us.
Nigeria leaders na the most foolish and wicked leaders wey I don see for my life. Money dey the country wey una go use the money change everywhere,instead dem go carry this money go foreign dey go help people wey don already help themselves since. Nigeria leaders just be like poor man wey steal money carry am run go reach man hotel go lodge,still the do money competition with the rich man for him own hotel,and him family dey stay for pako house wey be say if rain fall water dey wet him family because the zinc dey leak. Money wey e suppose to use go give him family a better life,he use am go dey hotel dey lavish. Anyway sha, I happy say US don let those people wey them restrict visa from to know say,them US no send una with una stolen funds. Now imagine say these set of restricted people get houses and investment for US,no be US property e don turn to.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
May 23, 2023, 06:16:05 AM
#16
As much as I like wetin the US don do, e go still make sense if other countries like UK, France, China, Japan, UAE, Saudi Arabia, Qatar, Korea and all these other nations fit do the same. But e go hard because even some of these other nations dey benefit from these guys big time. E go also make sense if the visa restriction fit touch their family members as well -  their wife, children too.

Shey una agree say visa restriction nor dey enough. Which other measures una feel say dem suppose add to this visa restriction?
E no dy enough o my brother. The better here be say, them dey try do something and no just fold there hands to allow injustice slide like this. As them no fit put body for our sovereignty as a state, them too dey try the least way them fit do but, these na still the least. Like you don talk, if other nations join body like you talk, nation like England but, these people no go gree put body because of watin them dey collect from Nigeria.
I for like make them still deport these guys families from there,
Seize there investments over there or force them to sell. E no hard them to do. If them fit do am to man like Abramovic formal owner if Chelsea, them fit do am.

Make them con dey in the condition way them dey create and face watin we dey face.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
May 22, 2023, 10:37:36 PM
#15
Las las all this nah just to make headline, e go soon comot. I just wonder why these obodo yibo pipo go dey chook mouth for our mata. Nah today dem know say we politicians dey do mago mago for election?
 We don gain independence from dis white folks yet them still dey treat us like say we be dia responsibility. Well, I no go blame dem, na us wey no fit do anything without interference from them.
 Some people go say this one go choke, but I believe say e no go worry them, after all, dis no be d first time, highest them go just lie low for sometime till the ban is removed.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
May 18, 2023, 06:01:35 PM
#14
According to one of the comrades, restricting most of these politicians globally will actually cause them to start managing some sectors correctly, such as the health sector, where the majority of the government-owned hospitals are not being properly maintained. They should even seize the majority of these assets they owned abroad, politicians have manipulated and taken advantage of people enough, Even if people try to make things work by electing the appropriate candidates, they still manage to rig the general election.I really think it's just a matter of time before people stop treating government officials lightly whenever they fail to perform their duties adequately. I'm so hurt by what I'm seeing right now.

Omo our politicians are crooks. I doubt if they would really change from their evil ways. See all these things are what leads to high crime in a nation. I am beginning to feel that these guys are just toying with themselves  (not us ) with these travel ban they had placed. Do not be surprised in the nearest future  you will  start hearing that politicians have been travelling out of the country with fake identities with the aid of those their lackeys and cronies they planted into the system. The worst of it all is that, this would be  an international collaboration and they would be moving out with private jets since they have it, it would not be a challenge to them in anyways.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
May 18, 2023, 05:19:52 PM
#13
Finally US don impose visa restriction for all those politicians and other people wey dem catch say dem try scatter our presidential election for February1. Wetin dem do, dem intimidate voters, dem follow to manipulate the results, dem carry thugs to go snatch ballot box, kidnap INEC staff, bribe the electorate etc. Most of these terrible people already get family for US or dem like to dey go there go run one or two matters. As e be like this sef, we never see any list and dem nor go release the list to people wey dey affect. These people go know when dem go embassy wan to apply for visa.

Quote
Taking Steps to Impose Visa Restrictions on Individuals Involved in Undermining the Democratic Process During Nigeria’s 2023 Elections Cycle
The United States is committed to supporting and advancing democracy in Nigeria and around the world. Today, I am announcing that we have taken steps to impose visa restrictions on specific individuals in Nigeria for undermining the democratic process during Nigeria’s 2023 elections cycle. These actions are specific to certain individuals and are not directed at the Nigerian people or the Government of Nigeria as a whole.

Under Section 212(a)(3)C) of the Immigration and Nationality Act, these individuals will be subject to restrictions on visas to the United States under a policy covering those believed to be responsible for, or complicit in, undermining democracy. These individuals have been involved in intimidation of voters through threats and physical violence, the manipulation of vote results, and other activity that undermines Nigeria’s democratic process.

The decision to take steps to impose visa restrictions reflects the continued commitment of the United States to support Nigerian aspirations to strengthen democracy and the rule of law.

As much as I like wetin the US don do, e go still make sense if other countries like UK, France, China, Japan, UAE, Saudi Arabia, Qatar, Korea and all these other nations fit do the same. But e go hard because even some of these other nations dey benefit from these guys big time. E go also make sense if the visa restriction fit touch their family members as well -  their wife, children too.

Shey una agree say visa restriction nor dey enough. Which other measures una feel say dem suppose add to this visa restriction?


https://ng.usembassy.gov/taking-steps-to-impose-visa-restrictions-on-individuals-involved-in-undermining-the-democratic-process-during-nigerias-2023-elections-cycle/


According to one of the comrades, restricting most of these politicians globally will actually cause them to start managing some sectors correctly, such as the health sector, where the majority of the government-owned hospitals are not being properly maintained. They should even seize the majority of these assets they owned abroad, politicians have manipulated and taken advantage of people enough, Even if people try to make things work by electing the appropriate candidates, they still manage to rig the general election.I really think it's just a matter of time before people stop treating government officials lightly whenever they fail to perform their duties adequately. I'm so hurt by what I'm seeing right now.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 18, 2023, 01:22:27 PM
#12
This visa restriction wey USA government give to Nigerians wey dem cash for the 2023 general election no nonsense. Na innocent politicians nai dem go ban and not the real criminal. If dem won to do dat, they should first of all arrested or ban The INEC Chairman, because he is the prime suspect for the whole Election of the year.

Agbe na better talk you talk here, wetin USA do for this Visa restriction na rubbish how Dem go leave big names wey play bad role for the rigging of the election come dey ban other politicians? If Dem wam do the right thing make dem first arrest Mr Yakubo being the inec chairman and all the people wey do mago mago with am and make Dem put mouth make sure say naija government punish people wey change the outcome of results in some state for example we see how the original results come out for Rivers state even after dem say na peter obi no win there so I expect Dem to ban the Rivers State governor wey be Like, Lagos state governor and other bad people wey do bad bad things for the election and make Dem also no allow tinubu enter aso rock until dem finish the hearing of the casse for court na that time I go believe say dem get good plans for naija no be this Visa restrictions wey dem dey do.
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
May 18, 2023, 04:32:34 AM
#11

Na the same US weh give visa ban some men go knack two of them envoy down yesterday for Anambra State. Real problem deh this our country so with that killing. We know how US deh behave when you touch their citizens. Life matters there, e no be like Nigeria where them deh kill people like chicken and nothing deh happen. Again that list weh them write names of people weh them ban na fake. The US no make am public because e go contradict human rights. Those people go find out when them go airport to fly.
member
Activity: 213
Merit: 12
May 17, 2023, 06:02:32 PM
#10
Yes this is a welcome development, make them dey serious oooh no be to the talk am for mouth ooh tomorrow now we go hear say this one dey Us and the other one go UK, because bribe Don spoil everything for this world, because when dey promise you one thing now from Nigeria you go change mouth Begin talk another thing, because no be today we begin hear the news of visa banned in Nigeria and after a while we begin see them dey fly 💸💸💸💸 up and down like mosquito dey go dey come back,so wetin I they talk na make una dey serious,

And again be say if them go still place sanctions on our lawyer them too we dey judge in favor of who get money pass and who go give them appointment in their office,no single Truth, Nigeria court is no longer a common hope for the common man again ooh the politicians don buy all our lawyer ooh, that is why I they offended you they will tell you to go to court because na their brother or sister dey there and na them them,so make them still look it that party and know what will suit them because they have rubbish this country oooh.. especially de mata wet dey court now presidential election results,if they have come out to say the truth..
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
May 16, 2023, 04:24:35 PM
#9
This visa restriction wey USA government give to Nigerians wey dem cash for the 2023 general election no nonsense. Na innocent politicians nai dem go ban and not the real criminal. If dem won to do dat, they should first of all arrested or ban The INEC Chairman, because he is the prime suspect for the whole Election of the year.
full member
Activity: 756
Merit: 180
Eloncoin.org - Mars, here we come!
May 16, 2023, 12:58:00 PM
#8
The visa restriction no dey enough truly, because the damage wey Dem cause because of greed go last for generations to come.
Even if things go happen to these corrupt people, the problem be say their loyalist go carry on their agenda of greed and corruption.
We are just waiting for the inauguration on the 29th to see what happens, because we as Nigerians know the new look we would get from international observers. The ban just began, let's hope all things are sorted out in the courts of law so that the simple citizens don't get to suffer in the end, due to ban and more restrictions.
Pages:
Jump to: