If government shut down all exchanges, na Telegram na e traders go switch over to because currently p2p trade dey available for Telegram even though we know say their exchange rate dey cheap but by then we no go get option because na only them fit sure pass that time.
Telegram matter dey fear me because scammers full there, since when dey scam me I dey fear to accept any info wey I see for any group wey I no sabi, no say even for exchanges wey we dey use scammers dey too but the daily warning wey they dey give they guide us well, I just pray make we get better means way we go dey transact comfortably.
I believe say no be every trader for a platform go be scammer some legit ones go dey, so if you trade with any legit one and your p2p transaction goes well, na to save e phone number so that whenever you won do p2p trade, you go call am and trade with am to avoid meeting another scammer.
Legit go surely dey, the main thing be say how we go take recognise am na em be problem, but sha we wey dey forum e go dey easy for us because way sure for us but people outside forum go suffer am because most of them joined crypto new and dey no sabi any thing, especially during the airdrop of a thing at least e create more awareness for many people to know crypto.
I hear say back days those early crypto adopters for Naija get watsapp group wey them dey use for p2p trade but scam still dey that one too. Infact nothing wey scammers no dey involve as long as na money issue. So no think too much wait till that time come and we go cross the bridge make you no go dey over think for something wey fit no come to pass.
I been dey hear say what'sup group dey but I never come across am before but if e happen way most dey, groups will start coming up, but during the period we go need to be careful because even the bad ones will show up too.