The PH refineries is still not operating yet, everything is just politics, we barley know the true stories these days.
Looks like the range is around 600 to N1000 because while I was still in ph, I got it for < N650 but now in akwa ibom, I got it for N1100 last week, it went down to N750 but now looks tobbe stabilizing at N800. It's funny how everyone is buying at this prices and life is going on. A year and few months ago, we were buying the same fuel around 80-85% less than the current pump prices. Like Igebotz said, it's hard to know the true stories these days because even with fuel subsidy gone, economy haven't gotten any better.
Na that suffering and smiling wey baba fela don carry sing far back. Na religion and ethnicity make people for naija no fit get one voice, na the people wey e involve directly dey always suffer because other people go dey sideline dey watch. Our situation for naija na really an unfortunate one as government dey carry our mouth robe ground and nothing go still happen, one government come , do wetin dem like comot and another come also do wetin dem like comot, society keep going down. How deregulation go be like this? Only going up up and price no fit fluctuate come down, na wa oo. Since wey dem say dem don fully comot subsidy and deregulate that sector, Omo na so so increments without no proper reason. Refineries never get to work, some people just carry Nigeria dey do business. Too bad the kind of system we dey.