Pages:
Author

Topic: When is the right time to sell - page 2. (Read 258 times)

sr. member
Activity: 574
Merit: 252
May 03, 2024, 05:04:29 AM
#2
I know say some people get different kind of investment goals, so some people go only sell once their investment goal is met, some people na condition or emergencies dy force their hands to sell,

Yeah every body get their own Bitcoin investment goal. But still those investment goal still involved making profit and all that , but the Reason most people dey sell their investment base on emergency purposes, nah because say dem lack emergency funds wey dem supposed use tey cover expenses, wetting dey cause am most time nah wen person go over dey aggressive with his bitcoin accummulation, because  he or she wan make better profit in a short run , so dem go use those emergency funds tey invest still to get better stashes and e go lead to early or premature withdrawing. That why e dey better to dey  accumulate according the way your hand reach , like dey use some percentage of your earnings tey dey accumulate while the other remaining percentage as emergency funds, but sometimes some people dey sell from Their investment if Their emergency funds nor fit keep up with that expenses expecially the ones wey relate to health issues.

people don even vow say Dem no go touch their holdings till 5-10 years time regardless of wether the investment go dy profitable or not, so in essence of all this is please, when is the best time to sell? I know say most snr men for here go dy reason am say i surpose know this thing, but as e be so, I no just know the best time to sell,  I don list out most of the scenario wey fit make person sell, but I no know which one be the best, abeg make ona enlightened me abeg.

To me earn long-term accumulating and holding nah the best , because person go get time tey accumulate better stashes of Bitcoin. Because most of us here nah average earners and most time we dey get personal expenses to take care of , so we nor fit carry go all in with our earnings , so to dey buy small small quantities with DCAing nah just the best so that as we dey accumulate we go get cash to handle expenses.

Now back to your question, to me I don't think sey any best time dey to sell. Aslong sey you dun get better quantities stash of Bitcoin, you go fit withdraw anytime because by then you go dey good profit expecially when be sey u spread your purchasing with DCAing during your purchasing (as long-term holding) so as Bitcoin dun rise you go surely dey in nice profit and you go fit withdraw any time and you still dey profit , but still everybody get their own target.
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
May 03, 2024, 03:34:58 AM
#1
Good morning my country people inside this morning, ona know say I partially dy new to this Bitcoin investment of a thing, na trading and mostly technical analysis I really dy conversant with before I come into this forum, because I dy trained in that craft and even till today, I dy use am dy see front most times, but e get one question wey since I come here, I never still get a clearer picture of, even after doing so many readings and finding inside this forum, so today I just say make I ask am officially if any one go fit throw more light on when is the best time to sell?

I know say some people get different kind of investment goals, so some people go only sell once their investment goal is met, some people na condition or emergencies dy force their hands to sell, while some people prefer to dy take only the profit on top, some dy sell only during the bull season and some people don even vow say Dem no go touch their holdings till 5-10 years time regardless of wether the investment go dy profitable or not, so in essence of all this is please, when is the best time to sell? I know say most snr men for here go dy reason am say i surpose know this thing, but as e be so, I no just know the best time to sell,  I don list out most of the scenario wey fit make person sell, but I no know which one be the best, abeg make ona enlightened me abeg.
Pages:
Jump to: