I don't know if there are others still feeling cautious towards the ban been lifted
I personally haven't tried it
So would like to ask has anybody tried buying via bank?
If so how was the experience compare to P2P?
Hearing about
Social engineering has affirmed my decision not to share my number via P2P.
Wetting you talk here na truth but I never know wether the phone number given to the client you wan release asset to dey risky? Because most times if we want to sell coin for P2P the person we wan sell coin to, go talk say make we drop phone number asap and sometimes E fit be the phone number we carry register for our play or BVN so I no no how sensitive this thing fit be , but I believe say E no good atol. Base on security level.
I am already used to p2p trading so using my card is like someone who trying to violate the rules and regulation that governs us before despite they have lifted the ban but i still feels guilt of using it to buy cryptocurrency, Because Nigerian tins na for brain e dey worry them. I no even sure say na dem take that talk into their mind self because anytin fit happened anytime na wetin make me still dey fear even as i don dey use with the p2p i no fit go touch my card to use am buy any digital currency before dem go trace me or even me say na we dey still prove stubborn dey use am trade.
We suppose watch we country very well before we jump tinking say everywhere don cool without know saying area never balance till now, we go try dey cautious of wetin we dey do abege if you still feels safe wit they p2p funding den you go ahead than to go use card direct dem give you restrictions.
You are actually Wright. You know say Nigeria no dey dey serious for whatever thing them dey do. Dem fit talk sometime today and you rush go so that thing the next day police go still arest you say who tell you? Meaning the sector's for government no dey in union or unity to know update on the country. If them talk anything for news and you no use your brain you go be the first victim of that thing.
Nigeria no dey effective for making law and standing by it. All are just words to sugarcoat and make the country have a good reputation where as nothing of such occurred.
If you guys remember last year we celebrated on issue of bua cement selling for as low as #3500 to fight again Dangote expensive cement. And now if you check out there was no effort made to make that dream come true but wrong speculation dey say price don come down and no where wey dey sell for such price.
So for this issue of lifting ban on crypto currency E fit be trapped or not to see people behind crypto currency. So make we just dey use the normal perttern we don dey use for long now. Make we no go use excitement go do wetting no nice because Nigeria good for news but in reality is the opposite.