Pages:
Author

Topic: Why E de important to avoid to de tell people about crypto way you get - page 2. (Read 403 times)

sr. member
Activity: 560
Merit: 408
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
For me why person go even try to flaunt his Bitcoin or  holding to anyone. in every aspect of life, I think keeping your holdings a secret is best for you because if people don't know your worth they will definitely have nothing to take you. Only a beginner who doesn't understand the risk involved in showing or sharing your financial secret would be so foolish to expose it.
E dey very risky for us to dey tell people about our savings, e good make we dey keep am secret because no be everybody wey dey close to you dey like how you dey progress, for this world wey we dey so we need to the hide so many things, e fit be say person wey you talk to about your crypto currency investment will go tell him friend and maybe that him friend do not no anything about crypto and e go dey look you with bad eyes wey be say wetin you dey do na illegal, another one be say the person wey you tell no be your friend but your enemy but you see am say na friend will come gang against you to steal your funds.
newbie
Activity: 22
Merit: 4
Any person wey dey reason about security like me go dey conscious about how dem go open their mouth for everywere dey tell people about their crypto holdings me self been don read for news say e get person wey go tell people about how him dey invest dey make profits from cryptocurrency na so dem take plan come kidnap go hide inside bush, like dis dem plan for de person and him com bring all dey coin wey him dey hold com transfer am give dem onto him dey always make mouth dey open outside how him dey see millions na so dem take carry am run las las him lost everytin. Like dis anytin u be just hide yoursaf no even allow person sabi wetin u dey do ontill dem con notice am by demselfs.
hero member
Activity: 616
Merit: 509
Top Crypto Casino
For me why person go even try to flaunt his Bitcoin or  holding to anyone. in every aspect of life, I think keeping your holdings a secret is best for you because if people don't know your worth they will definitely have nothing to take you. Only a beginner who doesn't understand the risk involved in showing or sharing your financial secret would be so foolish to expose it.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
This na very serious matter oo, some persons go think say na joke buy no be joke, for this same forum naim person post for beginner and help board how dem take ho rub person house come even collect the coins wey been dey em wallet, and this na person wey dey like to post online, one of the biggest mistake wey people wey dey into crypto go do naim be to dey share your financial information dey give people anyhow, I get some friends wey e dem received any crypto sef you go see their post for WhatsApp status, that na expose you dey expose your self.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
OP check whether the link of the original post wey 1miau post for Beginners and Help na the same post heading wey you write so give us for our local board on how important wey em d to avoid telling everyone about our crypto holding.

Why I am pointing this out na because I clicked on the original post link, where em carry me on go na
How to add Bitcoin address to Electrum / difference sweep and import priv. Key


OP no connection d with the post link and the one wey you translate to. I go say make you re-edit the post by providing the right post wey 1miau post for the Beginners and Help concerning the post wey you translate to pidgin so. Why that na because em go d easy for people wey wan trace and properly understand wetin the OP(1miau) talk wella for proper English.
full member
Activity: 294
Merit: 168
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Op, I agree with you, no be only for Bitcoin self but for the things wey we dey do for real life because after you do tell your friends them the type of investment wey you don put hand wey dey give you money, they go think say money done full for you everywhere and when they ask you of money, you come give them below wey thing they ask or you tell them say you no get money to give them at the moment. They go see say you do not want to help them. Before you go know they done get hatred and jealousy for you, and some friends fit go to the extent of poisoning you through food or drink. E good too anytime we comot with our friends make we dey careful for anything wey we go chop, if we want go use the restroom or answer a phone call, make we sure say we finish our food before we go or if now drink make we carry the drink go there to avoid being poisoning because the heart of men is full with evil.
sr. member
Activity: 490
Merit: 311
Play Bitcoin PVP Prediction Game


Translations:

Languagetranslated byTitle
_______________________________________________________________________________________________________________________
Nigeria (Naija)Mia Chloe (reserved)reserved
Op, this part shouldn't be added to your translation, I advice you removed it.
We should be cautious of how we speak of our Bitcoin investment, even if we are trying to teach or introduce Bitcoin to someone to avoid jealousy or for such person to  know your worth not just friends but relatives because jealousy or issues can come from anyone.
 The Internet is not a friendly place if you take your privacy and security simply then get ready to face the dangers of it especially the threat of KYC which is one of the easiest ways hackers and scammers can get a complete details about you.
sr. member
Activity: 336
Merit: 495
Math + Code = Blockchain 😁
Original Topic: Why it’s important to avoid telling everyone about your crypto holdings
Author:1miau

Why E de important to avoid to de tell people about crypto way you get

If you first look am e no be like bad thing to tell people say you get Bitcoin for wallet,but E get some kind things you need reason and put for mind.


To de tell all your friends fit nor be better thing.

Even if them be your friends you need to de careful well well if you tell them about Bitcoin or other crypto way you get.

As E always be, some of them go de way go con de jealous,especially if them think say  you rich (but you nor rich like that) con start to de  beg you make you  give them some from inside. This matter fit spoil  trust way una get for una self way fit spoil una relationship kpata kpata or finish.

Or if that one no happen , we know say some of them nor Sabi keep secret and Dem go fit come bigin de tell other people. E de possible say people go con know about am way de jealous/ and get bad relationship with you or Dem fit be thief way de plan to thief your crypto.

After all, the more many many people con de no about your crypto, the more bad people fit come still de know about am.



To de link your identity for internet join your real Identity fit de very risky

Normally nor be better thing to de use your real names for Internet, especially when he  concern your cryptocurrencies. This matter  concern  forums, public social media accounts way get connection to cryptocurrencies and  for all services, where we go need to use email address or similar.

Since many accounts go need email if you wan register, you suppose use email way you  newly create way nor get your real name.E  go protect you from spam and scammers Dem who wan no your real name and address.

With  social engineering, scammers fit conclude about the person, how many crypto them get, find out where Dem de live and fit con plan to rob you



KYC fit expose your identity to peope way no suppose no about am

Better wrong idea de  between the reason and the result of  KYC-process.
E de very important to de extremely careful and know the risks way de if pesin do KYC. Better avoid am if you fit and no do am if you  nor want make bad thing shock you.E dey  possible say the KYC-Scammers / Hackers use your hacked personal information way Dem thief to take gain knowledge about your personal address or location / sell am give other people and Dem fit plan to rob you for  house and thief your crypto.Dem even catch coinbase sef. de sell user data.

See some other reasons why to de do KYC fit puts you for big risk: Why KYC de very very dangerous – and useless



Overly to de  carelessly handle your personal data go increase likelihood of them to thief your  Bitcoin by force or other old ways


Different attacks dey way you fit lose your cryptocurrencies: scams, phishing sites or hacked wallets. Another attack way you fit avoid na the popular $ 5 wrench attack:


https://xkcd.com/538/

U fit avoid am wella if the attackers nor know your personal data and where you live.



Finally,Everybody dey responsible to keep their own data well and who go gain knowledge about your crypto. As simple rule, E always  dey advisable to dey  careful when you de  doubt. This matter  still cover all actions for  Internet way fit threaten privacy.
Once information don cast, we no fit undo am and all the (bad) things way fit follow.


Pages:
Jump to: