My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?
Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!
My oga, the country don almost turn upside-down o. We sha no go lose hope on top of the country because na our home country be this. Before this regime,plenty regimes don pass including during the military services. All if you factor dem together con recollect the struggles and tussles wey we don undergo, you fit come into conclusion say, na serious and deep prayers we need. And it has to be intentional and collectively.
I'm pretty sure that's what the president is buttressing on. We have been stagnant as a nation and have a very long way to go. The expectations and burdens on us as rhe giant of Africa and the different corrupt cases wey dey happen on daily basis. E reach make we enter serious prayers o. One thing wey i like na the mentioning wey mr president mention am say make we help am, help ourselves with prayers.
And as of the need to remind us. Yes. Our presido need remind us o because if you dey look for environment where dem dey injure people pass, hypocritically, na Nigerians. That's why dem talk say change begins with me and you. As far as we continue to sabotage the efforts of the government, we won't prosper as a nation. Instead, let's join into prayers.