People just care about wetin dey give dem money not to loose it but when it comes to their personal safety they do not care about it because they feel nothing go happen. But when it comes to personal safety it is very very important because life no get duplicate, if we are careless about things and anything happens to life their is nothing that can be done about it. That is why everyday you see people rushing out to go secure their businesses but when it comes to things related to health they do nothing about it.
You know say the major priority for naija don become how to get wetin to eat to get strength and survive. Nigerians dey live from hand to mouth and na that one make certain things be the way they are and wey make people go first want secure their business before them go even try to treat malaria and typhoid wey dey worry dem or even say make dem go hospital for check up until dem enter there as emergency patient. They are after all na money dem go need to pay the bills of hospital and any other bills.
Me I dey always blame government, however this one wey relate to personal security, I go blame both government for not providing some basic needs of the people as their responsibility and on the other hand blaming the people for not trying to be responsible to their lives, at least to go check up earlier go save the person cost of treatment when the illness don dey severe or turn into another thing.
But if to say government provide certain basic support in the hospitals, I'm sure people go just dey waka enter their go check dem selves. If to say Nigeria hospitals dey run on a subsidized rate and sometimes free in some medical issues including taking of drugs then it will be totally the fault of Nigerians if them no go hospital. Like for some foreign land some operation na free or very very cheap whether you dey part of government , belong to any political party or not , whether you dey work or not or whether you dey for NHIS, so long you be human being you enjoy basic and help support. For naija, hmmm Omo we know the story, no need to even begin talk.
Another area wey I blame government na road. In fact most of the accidents wey dey happen na because of bad road. So if government been fix those roads, the accidents no go happen or won't be very bad if at all person no dey cautious. Me I dey blame government wella oo for most things wey don go wrong for the country.
Some drug stalls dey sell expired drugs and when they are caught they will be pardoned but government won't do proper investigation on people wey dem send work wey don collect bribe because dem selves dey collect bribe too.