My country people una Weldon oo I don notice say many Nigerians no wan use ear hear Bitcoin matter especially those way no get people around them way de into Bitcoin.I don de reason the matter since say y many of them dey fear to invest for Bitcoin?
I con realize say during those first period way mobile technology tay cast for naija,some of the people way understand all this Bitcoin matter use am tay scam many people so over time people con de conclude say Bitcoin na scam .
Another thing way still de contribute na wrong idea. Many of them believe say Bitcoin de bring wealth over night.so Dem no de bother to read about am before Dem invest or hodl.the reason why Dem get dis belief na because I dn see many cases of all dis yahoo boys Dem (cyber fraudster)de use Bitcoin name de cover d scam way Dem de into some even de use am as scam scheme say like make u give Dem 5k say Dem way invest am for Bitcoin say the next mins Dem go credit you 10k based on people way no understand Bitcoin those victim go send d money and the scammers Dem go disappear later na d victim go con de feel say Bitcoin na yeye tin. To de teach people about Bitcoin no easy at all that is why I de respect people way fit de do am for we naija.
I no say people no de too de fall for those kind scam again but that wrong idea about Bitcoin sti de their head say na scam.
The major thing be say, the first guys dem way been dey into bitcoin, them use am run people scam, the thing come give bad reputation to bitcoin. Then our government too no come help matters, as them announce say make financial institutions no allowed bitcoin transactions again. So the thing come give bad signal to the people say bitcoin na bad thing.
So e go take person way understand bitcoin to start to explain to people say bitcoin no be bad thing as government paint am, I remember say I been dey discuss about bitcoin with my friend some certain time, person way dey near me dey listen come dey ask me, if I don join yahoo.
So you see the kind orientation way dem get about bitcoin, no be only for Nigeria way restrictions on bitcoin dey, some countries self too don put restrictions, but bitcoin don stand the test of time and e go continue to prove this government leaders wrong, because bitcoin get value and reputation true true and no be scam.