Pages:
Author

Topic: Wike not supporting Atiku - page 2. (Read 169 times)

member
Activity: 378
Merit: 76
Eloncoin.org - Mars, here we come!
February 11, 2023, 03:41:17 AM
#1
My people una know about the issues wey governor wike and the presidential candidate for PDP (Atiku) Dem been get, the problem Don really increase o, e reach where be say wike don give order to Rivers State people say make Dem no vote PDP (Atiku) for president say make Dem vote APC candidate (tinubu)

Though wike never talk am openly oo, but the PDP political leaders for my local government don dey announce openly say wike say make dem no vote Atiku but tinubu, even yesterday for PDP rally for eleme, Dem still announce am,

My people how una see this matter?

Una feel say wike dey fight for the good of Rivers people or en dey fight for en personal interest?

And why be say wike no support Peter obi based on the issues en get with Atiku, why en choose to support Tinubu?
Pages:
Jump to: