Pages:
Author

Topic: With the current hardship?? (Read 212 times)

sr. member
Activity: 560
Merit: 408
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
November 16, 2023, 09:09:42 AM
#31
The economy is bad and will still get worse but the fact is that it doesn't mean you have to be taking your invested bitcoin. To avoid all this set up plan for your bitcoin investment, invest in a amount that you know will not affect your cost of living, you are investing not saving so if you continue to take what will now be left of your investment funds?
Na the mistake wey some people dey make be that, they no dey plan things well well because people they shout say Bitcoin halving dey near some people go park all their money and even sell some of the few things dey get to come dey part of people wey go benefits from the gain, I dey support wetin dey dey do ooo because the way wey country dey now everybody dey fine way to make money and bitcoin na the way now but the koko be say make we dey reason any matter well well before we go into it.

Now wey everywhere hot now person need to they plan well well because the way wey things dey increase prices day by day if we no plan am e go affect our investment because e go lead us to dey put hand for the investment wey we don't do before and e will come be say we no invest at all. The thing be say make we dey predict the future either positive or negative so things no go hard for us because if e come positive na our gain e be and if na negative we dey save.
member
Activity: 334
Merit: 27
November 11, 2023, 04:11:54 PM
#30


Dis economy breeze dey really blow dey hit everybody o but we still dey gallant and we no he step back or give until we achieve wetin we want. The economy bad well well but dat one no go stop us say we no go do d right tin if e come to investing for bitcoin. We go dey save dey invest for bitcoin no matter how small e be, I just know say one day we go get better profit for dis hard decision wey we take, even as we dey try manage everyday.

Make we no touch money wei don entails there, if we touch am so, our 1BTC no go be 1BTC again o. Even as d market don dey green so, make we no dey carried away by d little profit wey don dey on top, make we just hold d ones wei we don put till better time come to cash an out.
my brother ur talk na better one, hmmm the situation wey country dey now and wetin we go aspect in there nearest months no dey friendly oooo. Wetin person go do now, money wey person dey earn no increase and yet cost of living dey increase, how man go cope.make God help us all, amen
hero member
Activity: 812
Merit: 675
November 11, 2023, 04:38:33 AM
#29
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

Dis economy breeze dey really blow dey hit everybody o but we still dey gallant and we no he step back or give until we achieve wetin we want. The economy bad well well but dat one no go stop us say we no go do d right tin if e come to investing for bitcoin. We go dey save dey invest for bitcoin no matter how small e be, I just know say one day we go get better profit for dis hard decision wey we take, even as we dey try manage everyday.

Quote
If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

Make we no touch money wei don entails there, if we touch am so, our 1BTC no go be 1BTC again o. Even as d market don dey green so, make we no dey carried away by d little profit wey don dey on top, make we just hold d ones wei we don put till better time come to cash an out.
full member
Activity: 322
Merit: 166
November 11, 2023, 04:12:16 AM
#28
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

We all understand say d economy for d country bad but make dat one no make us go take decision wey no go make sense later. Money wey don enter bitcoin, make we dey try comot our mind for there and we no dey pray say we go dey situation wey go make us go touch dat money back because say d economy bad and we no get choice dan to go do dat. Any money wey I don put for investment, e don dey there be dat until d time wey bull run come. Anything wey good dey take time to happen and if I say I no wan wait patiently, I go miss out greatly for dis thing wey I don dey anticipate for long. Make we try comot our eye for our bitcoin investment, make we sought for other means to make money so dat we no go touch d investment even as d economy bad reach.
full member
Activity: 504
Merit: 154
November 10, 2023, 11:30:03 PM
#27
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
This man wey una dey call una president wey be rich man wey no even win one vote for nigeria make everything to be worst since wey e be una president, I no sey nigeria wey be our country e dey hard before somebody can control nigeria well and remove inflation but president Goodluck Jonathan  did it and everybody for nigeria dey rejoice and dey celebrate but since dey use national independent commission to remove Good luck Jonathan wey be better president for our country naija na e make we dey suffer different things, all una leaders wey dey government house na dem the course our problem for this country, so I dey one place dey do my business and for get government and their leadership wey be yeye leadership
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
Vave.com - Crypto Casino
November 10, 2023, 07:39:10 PM
#26
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
Man must survive at all cost so even if situation tight the last option na to dip hand into investment to save the situation afterall hunger know no anybody even with Bitcoin halving coming up person must survive first, it's very unfortunate that the country economy is very bad, inflation is too high and cost of goods and services don high such that salary alone is not enough to cater  for all those expenses, infact people wey even get investment are even very lucky some people no get that opportunity they live from hand to mouth, unfortunately our politicians don scatter everything with the removal of fuel subsidy making things to be more difficult, I pray we all survive the current hardship.
full member
Activity: 560
Merit: 161
November 10, 2023, 07:09:03 PM
#25
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
No be small thing my brother, economy hard no be lie. Money no even reach anywhere to buy things for market again,  everything fir market they very expensive and the worst thing about this thing is that the price keeps increasing every day. The country dey in a terrible situation wey be say e go hard for things to become normal.  Right now the price of petrol is very high and naira to Dollar is very high too, this is what is really affecting the price of things in the market.  The government no dey even try at all for things to get better in the market , the only thing dem dey fight for is for their own pocket.
full member
Activity: 252
Merit: 157
November 10, 2023, 06:51:54 PM
#24
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.
My brother e no easy ooh but however we no they reason those matter again because e done become normal thing for we 9ja here, however I don't no how people for take cope like say online self no they, so perhaps online done creat plenty opportunity way be say u no gat depend on the government make them give you work before you go start to they make money.

So plenty courses they online way you go fit learn and apply for work online because if we talk say we go wait for our government before we go start by the time we go realize ourselves old age done come.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
November 10, 2023, 04:15:41 PM
#23
If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
That one for d if to sae peso d solely depend on bitcoin for survival. But as the matter be so, peso get other side hustle wey em d into to cope and manage em self for this hardship wey APC led government bring give us so.

Peso investment for bitcoin na for the future, na why em be sae, before peso start em investment journey for bitcoin, you are advice to invest with money you never the use so since the future can't be ascertained to know when bitcoin go do well for price for peso to withdraw em profits for em bitcoin investment.

I no d sure sae whether I go fit d among those wey go chuck their hands for theor bitcoin investment wey dem d make since toward the halving and bull run, just because of the present economic situation of the country.

As I d so, I no think sae I go fit risk my future riches for the present situation of the country. As I come know sae the bitcoin wey I hodl today go do marvelously well for price tomorrow when the bull run start by 2024
member
Activity: 155
Merit: 79
November 10, 2023, 02:01:38 PM
#22
If you dey invest in bitcoin, just know say is a long-term investment, remove your mind from it. Only invest what you can afford to let go for a long time.
In this present economy, everyone should have something doing and not rely on an investment.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
November 10, 2023, 01:39:34 PM
#21
Country hard oo, this time wey we find ourselves in is a very difficult time, money no even get value and even if money dey to even business it is so difficult to think of the business to do . But since the country done be like this their is nothing one can do it is just better for one to remain positive that better things will come one day. The price of things in the market is very expensive that 500 naira no come get value again.  I think the hardship is really affecting everyone irrespective of the class you belong to. Government no even dey try to make effort for things to get better.
Things are getting more difficult and when you do your observation well you will know that it is not only in this country, the world is suffering from a global economic downfall just that ours is worst, the majority of people living in this country are just trying to survive and naira as lost its value and the dependence of dollar is serious affecting our own market, in the sense that if the dollar is high so is the price of stuff, our market should depend on our own currency then it will be better. let us just be positive and hope for the best to come. even a thousand naira does not have value anymore and if you notice our politicians they don't steal millions anymore they are still billions because millions can keep them up anymore.
full member
Activity: 224
Merit: 195
November 10, 2023, 10:37:02 AM
#20
The hardship touch every body and e no easy but one thing be say we must surely out grown this level and for here rain still dey fall heavily I no know for you and where u see ur own harmattan 😅

Just as e red so, from my own perspective I no go advise you to chuck hand come remove funds from your investment portfolio, e no go make nah before you bring the money invest shebi u see say na for the long term and you don cross ur mind finish, make u no come go back for wetin u don decide. Try relax options choke and as well if u dey earn monthly try as well to dey secure emergency funds cos the way e be now money no get to finish for person hand
full member
Activity: 392
Merit: 185
Play Bitcoin PVP Prediction Game
November 10, 2023, 10:17:25 AM
#19
OP, welcome back from your time off, we need to understand that as Nigerians, the suffering is everywhere just those in power and the influential people don't feel it much, they only feel it when they buy petroleum products which they use lesser amount of money to purchase before or payment of flight ticket, but as an ordinary citizen, we feel it in all aspect, you talk about one withdrawing investment to help him or herself, op, you have forgotten so quick that, it is not everyone that's here that have an investment in either bitcoin or in other things, some people barely have mobile data to even browse the internet, the case of hardship in Nigeria has taken another shape, if someone has an investment it is good to withdraw a little to solve some issues,thats if there is know alternative, but on general note having an extra hustle aside your investment is good, that's if you can lay hand on one.
full member
Activity: 518
Merit: 156
November 10, 2023, 10:11:05 AM
#18
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

The investment way you make, na to save you from the raining days, so if you're raining days don reach, Omo na to put hand inside that your investment collect small, take survive first.

You no go dey inside water soap  dey enter you eyes na. Except say your investment Never mature, or e dey at a cradle stage, that wan be say, I go say make you look for another hustle take dey hold your side, pending when you go get a return in your investment.
full member
Activity: 322
Merit: 146
November 10, 2023, 05:22:11 AM
#17
Of course nobody go get money somewhere and u dey at the point of desperate need of money and u just chill. No way. Even I don hear some of us say... "Nomatter how needy them be say e get some person's them no fit meet as needy".

I think those set of persons never dey handicap situations before.
This na same thing OP dey relate about here.
U no fit dey take because u dey stick to the hodl of your Bitcoin while u roasts. Life before Treasury pleasures oh my people.

Such situation na really why person no need to rely em source of earning on Bitcoin because the frustrations that is accompanied when u want to sell your Bitcoin for just small tin like hungry dey very unbearable when u stays behind in just no time after your selling and see the bull-run in the Bitcoin markets.
member
Activity: 153
Merit: 14
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
November 09, 2023, 12:15:12 PM
#16
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
No be lie say county hard especially now wey December celebration don dey reach and if you no dey careful you fit pull out your investments wey go benefit you for future.hardship for naija suppose don master all of us by now because no be today e start and we gats to use our head to dey do things to avoid regrets. Bitcoin investment na for people wey get other source of income make you no go sell your coins at the wrong time.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
November 08, 2023, 06:27:59 AM
#15
Country hard oo, this time wey we find ourselves in is a very difficult time, money no even get value and even if money dey to even business it is so difficult to think of the business to do . But since the country done be like this their is nothing one can do it is just better for one to remain positive that better things will come one day. The price of things in the market is very expensive that 500 naira no come get value again.  I think the hardship is really affecting everyone irrespective of the class you belong to. Government no even dey try to make effort for things to get better.
The height of economic hardship in the country is becoming unimaginable that you don't know where to place your hope in for a better tomorrow. Worst of it all is that the prices of goods and services are increasing 3x higher of it's previous price within the spate of every three months and the government with all the economic policies they are making we are not feeling a remedial effect.

The scary gull about this hardship is how it's penetrating into all economic class in the society with scarcely any person not complaining how's things has been tough their their livelihood. The rhetoric is that if the rich and wealthy are complaining about the hardship then how's the poorest of the poor surviving in this hard times. I am trying not to imagine it.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
November 08, 2023, 06:20:43 AM
#14
Quote from: Forever101
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.
If you are ready to invest in BTC in this bear run, I don't think the hardship will stop you not to invest because as some people are complaining about the hardship in the country,there are some people celebrating their different estates and other business they are establishing in the land. Harmattan is my best period but is not strong yet in my area but it look like what will increase heavy before the end of this week.
Quote
If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
I no fit sell my BTC I struggle to buy for dis bear season because of d economy situation than to bear d hunger and d hardship because I no dat our government go do something soon to remove dis inflation dat is causing many people to do bad things just to sustain for their living. Now dat will begin to dey see some signs in d crypto market that look like say d price want to go up like d way it go up last 3 years for those that invested to earn well.
full member
Activity: 560
Merit: 161
November 08, 2023, 05:03:04 AM
#13
Country hard oo, this time wey we find ourselves in is a very difficult time, money no even get value and even if money dey to even business it is so difficult to think of the business to do . But since the country done be like this their is nothing one can do it is just better for one to remain positive that better things will come one day. The price of things in the market is very expensive that 500 naira no come get value again.  I think the hardship is really affecting everyone irrespective of the class you belong to. Government no even dey try to make effort for things to get better.
full member
Activity: 266
Merit: 113
November 08, 2023, 01:12:04 AM
#12
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
e de very funny how topics relating to the hardship in the country don become the most comfortable topic for people to easily relate with. And some lazy people go even use this whole "the country is hard" stuff to support there laziness and won't go out there and look for something reasonable to start there lives with.

One thing we need understand for the situation of our country be say I no de even see any possibility say things go better like that anytime soon but you self fit make the decision to better your life by being intentional about your financial state and with time, if dollar like make e rise or drop, if fuel like maker e scarce or not or the price of yarn go as high as possible, e no go affect you that much.

And the thing about investing into bitcoin or any other investment you de do be say you no go see say hunger de show you shege and you know say you get wetin you fit sell use sustain yourself den still allow hunger to continue making mess of you. The temptation to use your investment take hold body for the moment go come to your mind and you might not be able to resist it.

What I'm saying in essence is this, regardless of the harmattan when de blow every where, make we still try find something wen we go do when go fetch us some money so our mind fit commot for our bitcoin investment.
Pages:
Jump to: