~snipped~
How much research is needed before investing in a Memecoin?
If na memecoin wey don already dey listed, you go check dem on their SM handles and more importantly you go check them Onchain to see stuff like – how many active wallets dey hodl what percentage of the token, d buying and selling pressure, if people dey only buy but nobody dey sell, run. It means sey na only the Dev or team go fit sell later. D project only whitelisted their own wallets. Anybody wey buy apart from those wallets, na exit liquidity (money for boys) dem go be. On d oda hand, if more sellers dey there than buyers, of course e go mean sey d project dey dump. Nor buy at dat moment. Wait and monitor d project more and decide whether na good project to buy or not.
If d meme project neva dey listed, you go need to be an insider or you go sabi someone wey be insider for d project before you go fit invest. Ordawise, na liquidity you fit turn to.
What is the possibility that after much research that the particular meme investment will yield profits?
Every investment for dis industry na risk, including dat of Bitcoin too. D only difference between odas and Bitcoin be sey, at least you dey sure sey if you fit wait d next three to four years afta you buy Bitcoin from top without selling off you go recover ur loss.
from the image presented by OP, the investor never sounded too shocked about the outcome, he made a post concerning his loss but i felt he has experience of course and yet he still lost all he had.
Yes, you observed am well. E go mean sey e go don get times wen him made so much profit from memecoin investment too. So, im understand d game well.
Is taking the risk really worth, aside settling on Bitcoin investment that has less or no risk of limiting our profits as long as we hold compared to the shitcoins that can similarly change lives but at most RIP to our funds.
If u be persin wey get BP, e go dey good to stick to Bitcoin. But if you're a risk taker, nothing dey bad trying out memecoins with money wey you can afford to lose.