Pages:
Author

Topic: You really need to be careful (Read 160 times)

member
Activity: 28
Merit: 1
December 01, 2023, 04:59:05 PM
#21
How can someone be careful? In my opinion, no one can be careful enough. For the Christians, can Jesus who was betrayed be said to be careful? A friend can turn an enemy and that's an aspect of life we shouldn't worry about. Instead of being too careful, know yourself and do good because we are all in a vehicle and whose junction are we stopping next? Help a friend, help a family member, be at peace with all men, try not to be indebted to any man, show love and compassion to people because that's what counts after you alight. What if you are so careful that you exist and forget to live?
sr. member
Activity: 224
Merit: 195
December 01, 2023, 09:56:42 AM
#20
This na one big problem and challenges we dey face inside this our country, no be say e no dey happen outside, but the rate e dey happen for the country e dey so much alarming.
Person no go fit tell who be him friend anymore, you and your friend fit dey inside u self go dey conscious make him no from back stab you, una also fit comot go drink, as u turn head carry hand cover ur drink or want go urinate omor na to finish your drink or carry am follow body no even collect drink wey another person open.
Many yawa don gas base on this friend's stuffs, friend wey dey poison him friend, friend wey go fit sell you behind your back even u self fit dey progress but u no go fit tell your friend anything cos frenemies na him full now, laugh with you for ur face den stab u for ur back.
We no go judge all base on the good ones still dey but we still need dey guarded at all times, mind who we tell stuffs, either something good or bad.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
November 30, 2023, 10:16:47 AM
#19
Well I think at this point in time we go dey very careful with the people wey we dey call our friend or bestie because this particular set of people go fit do you waiting no good.
Yes, it true say we are to be very careful with the people wey we call our friends or besties, most especially when you are progressing, why they aren't, as that's where hatred, jealousy and evny start building it's foundation of destruction. And on that note, there are 3 things I have noticed you should never share with anybody , no matter the relationship, and they include;
1. How much you have in your bank account: Because you never can tell, some people could arrange with thieves to come robb you off your money.

2. Your next move or plan: Because most people are good at discourage people from executing a plan, but they never suggest a tangible solution to help you grow either financially or academically.
sr. member
Activity: 700
Merit: 429
November 30, 2023, 10:02:21 AM
#18
Las Las, I personally believe say we all supposed don know say we should be careful wit people around us, but  my main question now be say, wetin bring about this topic wey we dey discuss here right now?, @op, anything happen to you, shey any of your friends disappoint you, or treat you badly wey make you bring this topic of discussion come here?

If na "No" be the answer to any of those question way I ask above , then I dey sorry to say this, but this topic no dey relevant here, find something more important to discuss with us, no be something wey I believe everyone of us don already know.
Who at this time no know say he gats be careful for where friends, even family day? No be by force to create thread abeg, if you no get anything very important to discuss about, only dey comment for other people thread abeg, this to me na complete off topic.
sr. member
Activity: 588
Merit: 428
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
November 30, 2023, 09:31:58 AM
#17
Already someone need to dey very careful of what you do or what you are talking, because so many things dey happen now our days, even your blood brother self way you and am na the same mama the same papa self go still dey plan evil for you, talk less of and aside person so we just need to be extra careful.
This one na the fact you talk, we need to dey very very careful make we no dey entrust person fast fast make we dey observe am gradually and again even though we don observe am finish and no say in dey positive still make we no trust am past 50% because human being can change, as for me I no trust any body for this world, this one no means say I hate everybody ooo, I still have many friends that I do deals with but with caution, anytime we are doing anything together I make sure I have plan B if really dey change their mind against me so that I will not be in the risk part.
member
Activity: 784
Merit: 34
SOL.BIOKRIPT.COM
November 28, 2023, 05:48:21 PM
#16
Well I think at this point in time we go dey very careful with the people wey we dey call our friend or bestie because this particular set of people go fit do you waiting no good. Things they happen well well for this world,  some go dey behave like say them care but deep down dey wan cripple you.
Pesin wey you dey eat with for the same plate fit deny you tomorrow  say him/her no sabi or never see you before. Pesin wey you dey show your account balance fit arrange assassin for you and again pesin wey you call bestie or friend fit see something wey dey come your way him block am so make ona dey very careful even with things wey you dey share with them.

Chai i feel your pain O.P, the way you take dey talk am trust me i feel how e dey be when things like this just fall apart, me i dey always tell peaople say you see humans which is you and i ehh na just clothe dey cover us like this, if make one or two show you their inner self my dear you will understand say many get different colours of skin within them.
full member
Activity: 770
Merit: 180
Eloncoin.org - Mars, here we come!
November 28, 2023, 05:45:04 PM
#15
Na same wavelength we dey on OP, because as you talk the matter, na so e just be. Many friends wey I don get experience from na because of money make dem show me their true character.
The worst part be say na Dem go first show say Dem dey in need of help, only to just become spy and bone for neck wey person no fit vomit.

This yuletide season na even when e dey more important to adhere to personal security tips so as to dey careful, so as not to fall victim to unsuspecting devices wey fit come from close friends and even relatives.
full member
Activity: 322
Merit: 206
November 28, 2023, 04:51:19 PM
#14
People just need to understand that human can change, this should be the reason why people needs to be reserved and not to be too open to everybody they meet. Their are some things that needs to be personal and their somethings that are meant for people to know,  it is not every thing people needs to disclose to friends and family members.  Privacy matters alot and it is good to keep somethings to yourself if not letting other people to know about it can be use as a tool for destruction.
   Well, being open comes with some consequences, both good and bad. First the good consequence of being unreserved or open aids ones ability to socialize, foster good relationships with people and even grow a community of like minds. For the bad consequence of being unreserved, there may be people that have unhealthy intentions towards you and then would want to take advantage of your friendliness and interactive nature to put you in a state of worst regrets per say. At the same time, you may tend to say a whole lot of things that'll render you vulnerable to backstabbers and evil hearted people that disguise as good to you.
    There's no compulsion to staying reserved, interact, be jovial but be mindful of speech, do not let out things and don't loose guard in communication. Talking excessively can be avoided. Sometimes it's very much good to listen than to speak. To much of details about you should be avoided unless you will be prune to attacks. Know the kind of people you share your personal life with, the world is a cold world. And everyone is only out for themselves.
sr. member
Activity: 350
Merit: 335
November 28, 2023, 11:16:17 AM
#13
Well I think at this point in time we go dey very careful with the people wey we dey call our friend or bestie because this particular set of people go fit do you waiting no good. Things they happen well well for this world,  some go dey behave like say them care but deep down dey wan cripple you.
Pesin wey you dey eat with for the same plate fit deny you tomorrow  say him/her no sabi or never see you before. Pesin wey you dey show your account balance fit arrange assassin for you and again pesin wey you call bestie or friend fit see something wey dey come your way him block am so make ona dey very careful even with things wey you dey share with them.
Omo Las Las na Baba God get power over our life. E no get how you wan take dey careful reach wey bad things no fit reach you if God no dey your side. You go must commot for house, associate with people and do things... you no fit hide from life itself. The only  thing I dey do na to set limits and take care of the level of information I give out to people.

If we dwell for the mindset say friends are evil, how then we go take get peace of mind? This one na bondage by itself because you go just dey hate people up and down.

Bad things go continue to happen as well as good things. The best we can do na to shine our eyes and pray to God for protection.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
November 28, 2023, 11:07:10 AM
#12
My brother, all this thing's start now no be today, not even people you call your beastie or friends sef, even the blood one's are not to be trusted this days, I have seen many people today that got kill by their blood, and the reason no pass because of wealth, that is why this days you don't need to let people know where you are getting your money from, life is a something that you live and still be using your sense because if you no use your sense they go use am chop fish.

I don't know for anybody but for me I no trust anybody including my brother talkless of my friends, if any of my friend ask me where I dey get money from, my answer na God dey do am, because I dey fear make person no go run me street by stealing my phone and get into my phone and took away what i have work for a long period of time.
full member
Activity: 560
Merit: 161
November 28, 2023, 10:59:55 AM
#11
People just need to understand that human can change, this should be the reason why people needs to be reserved and not to be too open to everybody they meet. Their are some things that needs to be personal and their somethings that are meant for people to know,  it is not every thing people needs to disclose to friends and family members.  Privacy matters alot and it is good to keep somethings to yourself if not letting other people to know about it can be use as a tool for destruction.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
November 28, 2023, 09:32:48 AM
#10
This matter of a Truth you nailed it because Judas Iscariot as Bible called him was a carbinate member of Jesus but do him waiting no good for life sold him to enemies that killed him, God himself see heart of man regret why because so so wickedness him see for men's heart. Cain the only brother Abel killed him even when he was asked about his brother his still defend himself of not being his security or keeper the world have increased in diverse wickedness that even wife don't need know all about take example what Delilah did to Sampson after knowing his secret as wife many death of hero today are curse by close relationship unguided mouth always landed into destruction one must guide it mouth not revailling all his life no matter how closer the person may be because it hurt from past event and experience of others who have fallen victim.

Truth be told naim you just drop here so, even the so called people wey dey like say na dem loyal pass, na dem fit even be the the ones wey dey back stab us, no matter how close we feel say others dey close to us, but we nor no their belle. Just like one post wey I dey see online sa make we act foolish to fool the fool wey think say e dey fool us. So make as we dey follow everybody dey flow, make we still take time to select the type of persons wey we dey tell some certain things.

I go like add something for the part wey you say Cain kill em only brother. Though as at that time wey em kill am, na em only brother but later eve come still born another boy named Set, you go fit see am for genesis 4:25.
member
Activity: 153
Merit: 14
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
November 28, 2023, 08:57:19 AM
#9
Well I think at this point in time we go dey very careful with the people wey we dey call our friend or bestie because this particular set of people go fit do you waiting no good. Things they happen well well for this world,  some go dey behave like say them care but deep down dey wan cripple you.
Pesin wey you dey eat with for the same plate fit deny you tomorrow  say him/her no sabi or never see you before. Pesin wey you dey show your account balance fit arrange assassin for you and again pesin wey you call bestie or friend fit see something wey dey come your way him block am so make ona dey very careful even with things wey you dey share with them.
U do well because so many things dey happen now our days,so e better say make will no dey put our trust for were anybody dey again because the person can file you at any given time.
member
Activity: 224
Merit: 35
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
November 28, 2023, 04:51:27 AM
#8
Well I think at this point in time we go dey very careful with the people wey we dey call our friend or bestie because this particular set of people go fit do you waiting no good. Things they happen well well for this world,  some go dey behave like say them care but deep down dey wan cripple you.
Pesin wey you dey eat with for the same plate fit deny you tomorrow  say him/her no sabi or never see you before. Pesin wey you dey show your account balance fit arrange assassin for you and again pesin wey you call bestie or friend fit see something wey dey come your way him block am so make ona dey very careful even with things wey you dey share with them.

Trust na rare commodity from di time of creation, because jealousy, envy, greed, selfishness and many oda wickedness follow inside human nature, we no de learn am from anywhere. And na by di grace of God, na im we fit to take live above this negative attitudes, come begin to de live life of contentment and integrity. As we no fit open person mind to know wetin de inside, weda na good or evil, so e de important make we no carry all our mind take trust anybody 100%.

By dia fruits we shall know dem, so if you and person be friend, make you de take note of how di person de react and talk about very small matters, na from dia you go know im true character. Because from di abundant of di heart di mind speaketh, so from dia you go determine your trust rating for dat friend.

This matter of a Truth you nailed it because Judas Iscariot as Bible called him was a carbinate member of Jesus but do him waiting no good for life sold him to enemies that killed him, God himself see heart of man regret why because so so wickedness him see for men's heart. Cain the only brother Abel killed him even when he was asked about his brother his still defend himself of not being his security or keeper the world have increased in diverse wickedness that even wife don't need know all about take example what Delilah did to Sampson after knowing his secret as wife many death of hero today are curse by close relationship unguided mouth always landed into destruction one must guide it mouth not revailling all his life no matter how closer the person may be because it hurt from past event and experience of others who have fallen victim.
sr. member
Activity: 364
Merit: 220
November 28, 2023, 04:21:51 AM
#7
Well I think at this point in time we go dey very careful with the people wey we dey call our friend or bestie because this particular set of people go fit do you waiting no good. Things they happen well well for this world,  some go dey behave like say them care but deep down dey wan cripple you.
Pesin wey you dey eat with for the same plate fit deny you tomorrow  say him/her no sabi or never see you before. Pesin wey you dey show your account balance fit arrange assassin for you and again pesin wey you call bestie or friend fit see something wey dey come your way him block am so make ona dey very careful even with things wey you dey share with them.

Trust na rare commodity from di time of creation, because jealousy, envy, greed, selfishness and many oda wickedness follow inside human nature, we no de learn am from anywhere. And na by di grace of God, na im we fit to take live above this negative attitudes, come begin to de live life of contentment and integrity. As we no fit open person mind to know wetin de inside, weda na good or evil, so e de important make we no carry all our mind take trust anybody 100%.

By dia fruits we shall know dem, so if you and person be friend, make you de take note of how di person de react and talk about very small matters, na from dia you go know im true character. Because from di abundant of di heart di mind speaketh, so from dia you go determine your trust rating for dat friend.
full member
Activity: 182
Merit: 120
November 28, 2023, 03:28:23 AM
#6
Dispose of friends with bad character because one day dem go also do am to you. As dem dey show other people attitude for your front na so dem go still do same to you when e reach deir throat.

Some people sabi say dem get bad friends but becos of wetin dem dey benefit dem go still dey hang around. Things like protection and security. You go know say your friend dey carry gun comot for night while you no dey do so but you go still dey hang on with the person forgetting say d day wey hang go hold am, you too go enter. So be wise and careful in all your dealings.
The truth is if you're friends with a thief or cultist there's no way them no go influence you so is better not to make friends with a thief or cultist, even within this group of people them dey evil conspire against themselves.
The issue with friend making, no be everybody dey qualify to answer the name friend. I no dey put mouth for friend wey dey show friend shege because the person see the life of that person before he make friends with am.
For example I get friend and anytime he dey fight with people he love to dey use cutlass or knife fight just imagine I fight with that kind of friend na die be that na. It's better not to make friends or go close to bad and envious people.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
November 28, 2023, 02:36:33 AM
#5
Dispose of friends with bad character because one day dem go also do am to you. As dem dey show other people attitude for your front na so dem go still do same to you when e reach deir throat.

Some people sabi say dem get bad friends but becos of wetin dem dey benefit dem go still dey hang around. Things like protection and security. You go know say your friend dey carry gun comot for night while you no dey do so but you go still dey hang on with the person forgetting say d day wey hang go hold am, you too go enter. So be wise and careful in all your dealings.
full member
Activity: 266
Merit: 113
November 28, 2023, 02:14:33 AM
#4
The heart of an average men is desperately wicked and couple with the reality that things is very difficult for most persons, people can't be trusted that much in the society. When it comes to being careful about how we relate with those that are very close to us, I feel this is very difficult because you don't want them to know that you are obviously according them but you are actually staying with them and might even be eating with then in the same plate, his do you even cope with this? Na just God and maybe it good deeds fit protect us from our internal enemies if not we cant just be careful enough.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
November 27, 2023, 10:24:22 PM
#3
Definitely we sopos dey very careful this days, because man's heart is full of evil. The more days dey go the more people becomes angry for nothing. Sometimes the hardship of the economy is driving of people Gaga and changing there thinking faculty to something else. If they know yo doing something that is giving you cool money without stress it seems that your life is better than theirs, do dey become envious of uoi you and strategist on The way to harm you. So we really need to be careful.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
November 27, 2023, 07:24:33 PM
#2
This one no be small matter oo, but some person dey look am common, the people wey we dey tell some certain things matters a lot, some times we dey tell the wrong persons very useful information wey no suppose be so, some times I fit say na because of happiness naim make us dey over share some kind things, but if at all make we dey very careful. Sometimes the people wey we think say na our friend na just Hippocrates, na only when dem dey around us naim dem dey talk good about us, or that time naim dem dey act friendly, but for our back, dem be like enemy of progress.
Na why even the bitcoin wey we dey hold e no good make we even tell some family members, not to come talk of friends. I for my self, like make my bitcoin holding dey as anonymous as my seed phrase, make e be say na only me know where I keep am.
Pages:
Jump to: