Pages:
Author

Topic: 2023 Gubernatorial Elections Discussion Thread {Focus on Lagos & Rivers States} (Read 397 times)

member
Activity: 499
Merit: 16

Why we dey deceive ourselves, na only presidential campaign wey people vote individual wey be Peter Obi, the rest na party wey people vote, even where Labour party win as in positions no body sabi those wey dey there na just say dem be Labour party members so people begin vote them. Oya make we look Otti wey win for Abia state as governor under Labour party, that man was a APC member just few months back wey he last year but as him move go Labour party na so him begin gather followers and many people wey vite am just do so to pay back as dem wan both APC and PDP to commot for their state.

Typical no major new politicians was produced in this election which means we just recycle the old fools no matter the party then dey and we dey think say them go do better. The only politicians wey I know wey new na those labour party candidates wey win for north wey dem be nobody (dat story been trend for twitter wey him be taxi driver abi wetin self, I dun forget). Among everybody wey we vote for fir this election, abeg who be the youths abi we dun forget say na youthful leaders we been dey fight for.
The earlier we choose competence over party politics the better Nigeria politics will be. Most of those that came into power during this election running on the hype of labour party might be the flag bearer for APC or PDP in the next election.
These politicians rarely care about us the citizens like they care for the position they hold. And we should still choose competence over young leaders as well, Desmond Elliot is a a good example of young and incompetent leader we have in this country based on how much the people of his constituency hates him
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
The governorship election don run for many of the states for Nigeria and em remain some few states like Anambra, Imo, Bayelsa(na d states wey I know wey no follow for d just concluded governorship election) wey remain to carry out their own election.

News wey d reach be sae the EFCC boss, Aldulrasheed Bawa don reveal that the agency would arrest corrupt governors who's tenure ends on May 29.

How una take see the matter as EFCC boss going after corrupt governors after May 29? Cos Wike don talk sae em go honour the invitation if the invite am over.

Link to info: https://m.facebook.com/story.php?story_fbid=pfbid02uTArrZyg9UsADZBWH9ei8NBrxstWnv5VeMwcsNz9wJuGgTTuD6iZ9DtXxJtHPTfel&id=100050487580007
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I see say many people don Dey ember the aparthy thing but I will say make we no give up. Even as INEC bin just Dey do anyhow I see positive changes this year. People bin come out to vote and then no just vote party na candidate.

Why we dey deceive ourselves, na only presidential campaign wey people vote individual wey be Peter Obi, the rest na party wey people vote, even where Labour party win as in positions no body sabi those wey dey there na just say dem be Labour party members so people begin vote them. Oya make we look Otti wey win for Abia state as governor under Labour party, that man was a APC member just few months back wey he last year but as him move go Labour party na so him begin gather followers and many people wey vite am just do so to pay back as dem wan both APC and PDP to commot for their state.

Typical no major new politicians was produced in this election which means we just recycle the old fools no matter the party then dey and we dey think say them go do better. The only politicians wey I know wey new na those labour party candidates wey win for north wey dem be nobody (dat story been trend for twitter wey him be taxi driver abi wetin self, I dun forget). Among everybody wey we vote for fir this election, abeg who be the youths abi we dun forget say na youthful leaders we been dey fight for.
full member
Activity: 303
Merit: 136
Defend Bitcoin and its PoW: bitcoincleanup.com
I see say many people don Dey ember the aparthy thing but I will say make we no give up. Even as INEC bin just Dey do anyhow I see positive changes this year. People bin come out to vote and then no just vote party na candidate. This BVAS actual curtail mass voting, if na b4 we go Dey say one state carry millions of votes give one candidate. But not anymore. The manual coalition of result bin cause problem but once we fit address that issue we go see front wella. Watin sweet me be say sitting Governors bin Dey lose senatorial seats and governorship seats to mostly unknown candidates. PDP and APC no be the only political party wey get force now, others don join. I know most of us Dey vex because of how presidential election play out but make we no forget about politics because weather we like am or not we need people to represent us
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
Na me go tell una as my state be and as everything take played out for my state during the House of Assembly election. No be una go tell me otherwise sae it's possible for one particular party to claim all the Local Government for the state without having other parties like one or two that win election of the House of Assembly.

In House of Assembly, there supposed to be a minority group(parties) that will be in the House at least. Not having a ohh yes parties members that go with what the governor says.

In the history of my state House of Assembly, never has a particular party claim all the 27 local government of the state. Em never happen before. My state people go attest to it, sae this election wey happen this time, our governor do so many woroworo inside to elect em party members inside against the governorship election wey go happen for November

Make I clear una mind; As my state d so, na the peso wey come 3rd for governorship election, na em Supreme Court say make em rule us and una d hear wan tell me sae it's possible sae get free and fair election wey happen for my state via House of Assembly.
I get your point my broda nor be lie you talk. Even me shock sef when I see the news, I say how this take dey possible. Because na the first time me dey hear or see that kind tin sef. And as e be now nobody wey dey honest go fit beat hand for chest say no wuruwuru enter become how come? And for you state wey e be say the people and the government no dey align, the people wey nor trust or like the government at all neither the party. Dem nor fit try vote that party again. We see alot of irregularities sef and that one dey enough to tell us say both INEC dey complicit for the matter like this. And dem sabi why dem do am, vey soon una governorship election go hold and one way wey the incumbent fit retain power na if him get the support of the members wey dey the state house as na dem go do better underground work. We dey observe sha we hope say him plan go fail.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
>snip<
>snip<
Na me go tell una as my state be and as everything take played out for my state during the House of Assembly election. No be una go tell me otherwise sae it's possible for one particular party to claim all the Local Government for the state without having other parties like one or two that win election of the House of Assembly.

In House of Assembly, there supposed to be a minority group(parties) that will be in the House at least. Not having a ohh yes parties members that go with what the governor says.

In the history of my state House of Assembly, never has a particular party claim all the 27 local government of the state. Em never happen before. My state people go attest to it, sae this election wey happen this time, our governor do so many woroworo inside to elect em party members inside against the governorship election wey go happen for November

Make I clear una mind; As my state d so, na the peso wey come 3rd for governorship election, na em Supreme Court say make em rule us and una d hear wan tell me sae it's possible sae get free and fair election wey happen for my state via House of Assembly.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
The kind level of political apathy wey go follow after this disgrace wey INEC call election ehn, next four years if you tell person say make e come out come vote, e go ask you why e go waste him time when him vote no go count, and that is true, it is a sham, and INEC should be ashamed of itself for spending billions of taxpayers money, only to conduct this nonsense.

I sure say e go pass four years, because like this ehn, as for myself I nor sure say I nor even wan vote again with the yeye rubbish dem do for presidential election. And just as you have said, make everybody just find way focus on their life for this our country because with the level of apathy that this election has inspired, you see that interest in politics that the youths have, It is being suffocated already, and in no time you will see that only a few youths will be interested in anything politics or selection, sorry election. Cheesy

I no even bother myself yesterday, i no even waste my time to follow the election online or to go out and vote, Feb 25th show me say na evil people get this country, so why i go enter polling unit go waste my time when the results can be manipulated with ease,
When the result can be manipulated right in your face to show you that you cannot do anything. Our politicians need to be studied, their confidence level is very high.
hero member
Activity: 812
Merit: 725
It's a shame that our country don become another thing when it comes to election matter. Peso go vote finish, em vote no go count atal. Check out nah, for my state the whole house of Assembly election wey happen, na APC win all the 27 local governments wey d for my state. No single one wey other political parties win despite not voting for APC.
*Na only House of Assembly election wey my state do. No governorship election happen
Reminder: My state governorship election go happen around November. Based on sae na that time wey my state governor tenure(4years) go expire.

You see this our election matter, INEC don write the result finish for the highest bidder before the election happen sef.



From what I can grab from this our election be sae, our election doesn't count. Na selection of candidates wey d happen for the country during election.
As you cast your vote finish, you no no Wettin other people vote, therefore we need to de speak for ourselves.
I notice say we don de get transparent election for dis country because we don de see changes from d candidates wey de win the election.

Sometimes, me and you fit de shout d same party, but wen it come to voting we fit get different candidate for mind, wetting make una get house of assembly for 27 states mean say una people still de do APC na only you fit de think say dem don divert if not at least some parties suppose win, but e show say una really vote them in, therefore, make we get positive thoughts about dis election make we no de always reason say na rig dem de rig am.
member
Activity: 700
Merit: 30
It's a shame that our country don become another thing when it comes to election matter. Peso go vote finish, em vote no go count atal. Check out nah, for my state the whole house of Assembly election wey happen, na APC win all the 27 local governments wey d for my state. No single one wey other political parties win despite not voting for APC.

You see this our election matter, INEC don write the result finish for the highest bidder before the election happen sef.



From what I can grab from this our election be sae, our election doesn't count. Na selection of candidates wey d happen for the country during election.
Like seriously, I really no know how you people dey reason at times. Always ready to call Nigeria with all sorts of defamation and disrespect. No matter what is happening, it is still our father's land and na we go make am better. For the fact that your prefer candidate won in your PU no means say they go win the overall election. Na game of number. E no be new thing for one party to win all the seat. In my state, the previous council election held in November/December last year deliver SDP in one local government from council chairman to all the councilors in that LG despite my state is an APC control state and nobody talk. Again na SDP won the assembly election in that LG but APC won the governorship. My point is that you no vote a particular party no means say others no go vote them. It's simple as that.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
It's a shame that our country don become another thing when it comes to election matter. Peso go vote finish, em vote no go count atal. Check out nah, for my state the whole house of Assembly election wey happen, na APC win all the 27 local governments wey d for my state. No single one wey other political parties win despite not voting for APC.
*Na only House of Assembly election wey my state do. No governorship election happen
Reminder: My state governorship election go happen around November. Based on sae na that time wey my state governor tenure(4years) go expire.

You see this our election matter, INEC don write the result finish for the highest bidder before the election happen sef.



From what I can grab from this our election be sae, our election doesn't count. Na selection of candidates wey d happen for the country during election.
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
The kind level of political apathy wey go follow after this disgrace wey INEC call election ehn, next four years if you tell person say make e come out come vote, e go ask you why e go waste him time when him vote no go count, and that is true, it is a sham, and INEC should be ashamed of itself for spending billions of taxpayers money, only to conduct this nonsense.

I no even bother myself yesterday, i no even waste my time to follow the election online or to go out and vote, Feb 25th show me say na evil people get this country, so why i go enter polling unit go waste my time when the results can be manipulated with ease, as e be now so ehn, make all Nigerians just they find way to escape poverty individually, because this nation really has nothing to offer to us, only shege.
I join you for your rant my brother. This election wey take place on Saturday really show say our contri don cast to the point say important day like that, peeps bin prefer to play ball or wash cloth dan to go vote. The one wey dey hurt my feelings nah say them go tell you for there say make them give you so so amount to use buy your vote! Then what's the point? Most of the contestants know say if na by merit, dem no reach, dey just want use mago mago enta power.
 I still dey wait the period corruption go waka comot and instead of hating on different tribes, we fit join hands make the contri grow.
INEC is the worst and most corrupt body in Nigeria because na them dey put us for all these hardship and poverty for this country dey make the youths no get choice on what to do. ICC need to judge their matter because if the masses vote for Mr A, INEC go lie say na Mr B win and this way the bad government go still remain without a change when the people needed change. I just dey vex that body INEC need to dissolve because they are all bunch of bad people wey no want our country to grow so that make the common mass no benefit but only them. The one wey them do for presidential election no do them,instead them still do the worst because nobody do them strong thing. Election for this country na show just to deceive the foreign nations.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
The kind level of political apathy wey go follow after this disgrace wey INEC call election ehn, next four years if you tell person say make e come out come vote, e go ask you why e go waste him time when him vote no go count, and that is true, it is a sham, and INEC should be ashamed of itself for spending billions of taxpayers money, only to conduct this nonsense.

I no even bother myself yesterday, i no even waste my time to follow the election online or to go out and vote, Feb 25th show me say na evil people get this country, so why i go enter polling unit go waste my time when the results can be manipulated with ease, as e be now so ehn, make all Nigerians just they find way to escape poverty individually, because this nation really has nothing to offer to us, only shege.
I join you for your rant my brother. This election wey take place on Saturday really show say our contri don cast to the point say important day like that, peeps bin prefer to play ball or wash cloth dan to go vote. The one wey dey hurt my feelings nah say them go tell you for there say make them give you so so amount to use buy your vote! Then what's the point? Most of the contestants know say if na by merit, dem no reach, dey just want use mago mago enta power.
 I still dey wait the period corruption go waka comot and instead of hating on different tribes, we fit join hands make the contri grow.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
The kind level of political apathy wey go follow after this disgrace wey INEC call election ehn, next four years if you tell person say make e come out come vote, e go ask you why e go waste him time when him vote no go count, and that is true, it is a sham, and INEC should be ashamed of itself for spending billions of taxpayers money, only to conduct this nonsense.

I no even bother myself yesterday, i no even waste my time to follow the election online or to go out and vote, Feb 25th show me say na evil people get this country, so why i go enter polling unit go waste my time when the results can be manipulated with ease, as e be now so ehn, make all Nigerians just they find way to escape poverty individually, because this nation really has nothing to offer to us, only shege.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
For my area people no too come out and people self been go play football this morning. I think the reason for the poor turn out of voters na because of the outcome of the presidential election. People just believe say INEC fail dem so wetin be the need of coming out to vote wey dem go still do the same thing... Na for beer parlour na im many people dey this evening dey chill because dem see today as a work free day to relax at home.

I no so many people no go believe but you see this postponement of election also played a part for this political apathy wey we dey record for this gubernatorial election. Even though people been dey vex for the presidential election, e get some wey been dun talk say dem go get am right for this governorship election but after the postponement, I believe some kind people go dun lose their moral and then no go even wan take the election serious again. Also this postponement destabilize many people business so people for dun use vex say no no go come out come vote.

Shey make we know say the cabals win for this one. They plan am well and use our inexperienced to their advantage. They really play us and now dem dun get all the freedom to rig election as much as they can. See results wey I dey see from Rivers State and Lagos. Everything just dey favor the ruling party. I think say dem say Labour Party been win for presidential election for those States, so now those people no come out again come vote their givernors into power. We never serious for this country if our focus na only presidential election.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
For the past 7 years I have stayed in Port Harcourt Rivers State during election, I have never seen an empty election over few pulling unit as am seeing today in this Rivers State Governorship and Senate election. Have visited over 4 Pulling units across Rumuokwuta Port Harcourt, I barely see a crowd waiting for their turn to cast their votes, in my pulling unit the INEC official over their is even begging to see at least 40 voters which their is no hope of achieving unless things turn around later in the day...
What's exactly is the reason why voters are not willing to come out and vote their preferred candidate this time around ?
For my area people no too come out and people self been go play football this morning. I think the reason for the poor turn out of voters na because of the outcome of the presidential election. People just believe say INEC fail dem so wetin be the need of coming out to vote wey dem go still do the same thing... Na for beer parlour na im many people dey this evening dey chill because dem see today as a work free day to relax at home.
hero member
Activity: 532
Merit: 508
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
For the past 7 years I have stayed in Port Harcourt Rivers State during election, I have never seen an empty election over few pulling unit as am seeing today in this Rivers State Governorship and Senate election. Have visited over 4 Pulling units across Rumuokwuta Port Harcourt, I barely see a crowd waiting for their turn to cast their votes, in my pulling unit the INEC official over their is even begging to see at least 40 voters which their is no hope of achieving unless things turn around later in the day...
What's exactly is the reason why voters are not willing to come out and vote their preferred candidate this time around ?

LOl, Your narration is kind of funny to me when you say the INEC officials are begging to see 40 voters. Though these politicians are good at rigging elections, at least people not going out to vote will give them a good chance to do what they have always been doing. But what I think is that citizens are not very happy with INEC based on what happened in the presidential election result, so they just decided to rest at home.
full member
Activity: 1176
Merit: 165
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
For the past 7 years I have stayed in Port Harcourt Rivers State during election, I have never seen an empty election over few pulling unit as am seeing today in this Rivers State Governorship and Senate election. Have visited over 4 Pulling units across Rumuokwuta Port Harcourt, I barely see a crowd waiting for their turn to cast their votes, in my pulling unit the INEC official over their is even begging to see at least 40 voters which their is no hope of achieving unless things turn around later in the day...
What's exactly is the reason why voters are not willing to come out and vote their preferred candidate this time around ?
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
Una see the kind waka wey Lagos governor, Sam Olu dey waka?
From pillar to pole, from church to church and in every ceremony. E be like the guy don feel the heat say Saturday no go just easy for him o.
No be lie say power dey for people hand o.

But still Sam of APC wey be incumbent governor fit still win if Labour Party and PDP candidates no do merger support each other. If them no support, dem go share the votes of the people and e go simple for APC to rig
No be small thing bro... Serving governors dey kiss their senatorial ambition goodbye, okada rider dey replace a renowned politician, political heavy weights dey lose their seats any how, women self dey win too. Na d shocking results wey we see for the just concluded national assembly election. Many Nigerians don realize say the power dey their hands and not the politicians. The outcome of the election don really put fear for Sanwo Olu body sotey d guy come turn to phone repairer, mechanic and barber just to buy the heart of the electorates. This election is very interesting.
Boss CryptopreneurBrainboss you correct say Jagaban as a wise man suppose commot hand for lagos case as presidency don settle him. But another talk be say the presidency raise plenty dust wey be say him never too sure until him sit down for sit.
So him no go joke with the one wey him sure of first.
Another political wave just dey blow across Nigeria, so everyone should expect anything anytime.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
Una see the kind waka wey Lagos governor, Sam Olu dey waka?
From pillar to pole, from church to church and in every ceremony. E be like the guy don feel the heat say Saturday no go just easy for him o.
No be lie say power dey for people hand o.

But still Sam of APC wey be incumbent governor fit still win if Labour Party and PDP candidates no do merger support each other. If them no support, dem go share the votes of the people and e go simple for APC to rig
No be small thing bro... Serving governors dey kiss their senatorial ambition goodbye, okada rider dey replace a renowned politician, political heavy weights dey lose their seats any how, women self dey win too. Na d shocking results wey we see for the just concluded national assembly election. Many Nigerians don realize say the power dey their hands and not the politicians. The outcome of the election don really put fear for Sanwo Olu body sotey d guy come turn to phone repairer, mechanic and barber just to buy the heart of the electorates. This election is very interesting.
hero member
Activity: 742
Merit: 529






As I dey see this photos self I come understand say lagos don get another gubernatorial candidate for pdp wey no be Jimi Agbeje. Jimi don too much hold the ticket. Wey be say Fashola won him, Ambode won him too and Olu won him. ThankGod new person don enter.

But for overall,  I don lose interest. I no go travel and I no go vote after wetin INEC do, e dey obvious say our votes no dey count.
This your top candidates for the Rivers gubernatorial election them no complete in the sense that in my observation one of the top candidates too is omitted among the picturesque you display. And that person is no other person than the candidate of the Labour Party in the person of Beatrice Itubo. And this omission just dey show say some people don already dey underrate the influence of the woman for the state and even the influence of the Labour party through the Peter-Obi-effect. One bitter truth be say many persons for we Rivers state son even tire for all these same faces of politicians and political parties wey don dey since 1999 and we need new visionaries.
Me I just believe say dis Rivers election the outcome go shock plenty people cause all the mago-mago wey Dem do for presidential election don open people eyes.

And for the one wey you say u don loss interest, my guy abeg never loss interest yet, dis country na our own and na only we go fit mk am beta and one of such ways to mk am beta na through the ballot... Wen we com out in mass vote it dey hard for politicians to rig am compared to wen few people com out. For example  no see as people com out for the presidential election com vote, na mk as Dem try to rig am Dem mk plenty errors n mistk way open their yansh for the world eyes say Dem rig d election wey even Dem no even get excuse to take deny am. So bro abeg try com out mk we do it one more time , our country need us now more than ever!
Pages:
Jump to: