Pages:
Author

Topic: 6 AM to 4pm job - page 2. (Read 269 times)

full member
Activity: 252
Merit: 157
October 09, 2023, 09:17:44 AM
#6
Omo that kind of work na Ogweja work ooh, e no make sense at all, how them go pay person 30k for one whole month when you get family way you they take care of plus house rent, before one month go finish you done borrow tire, is better to find better work or skills way go help you than go suffer for this kind of work way no they pay better money.
hero member
Activity: 812
Merit: 675
October 09, 2023, 06:46:18 AM
#5
Jobs for our country here sucks , just imagine person comot for house as early as 6 A.M go work and e comot for work by 4pm enter road, meet traffic congestion, come reach house by 6pm. Does it really worth it with The minimum wage of 30k naira. This working system no dey favour our country piple. Na still same thing with company work.
Some work self no get  resting day , from Sunday to another Sunday.

No be say Nigerians like most of dis works wet dey stress dem out o, but dem no get options dat is why dem settle for such type of works. I no think say dem go get any government work wey dey tedious like dis sef, 6AM-4PM no be joke oo. Most of companies dat do dis type of work na private companies and wetin dem dey do be say dem dey take advantage of dis worker because dem no get any oda choice asides working with dem, only few private companies put dis into consideration. And for government work wey require working round d clock or for a long time like dis, most dey be shift for dem to be having enough rest. Even though d government dey put dis into consideration, the minimum wage no still fit compensate all of dis, I hope dem go look into dat soon and increase d minimum wage because even if na me dey dat shoes, I no go like am like dat.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
October 09, 2023, 03:45:34 AM
#4
 First of all, no be the company fault say traffic dey road. If you check, that nah issue wey consan the government of the country. Again if you reason am, some people dey work over time and yet nothing to show as appreciation for their hardwork. Somebody tell me say salary is a drug your employer gives you to forget your dreams and for this naija wey hardship don tie us like wrapper, some people go take the #30k with joy, dey call am big money but dem forget say nah for that moni transport, feeding, house rent and other small bills go dey and before you know, nothing remain.
 Wetin I don observe be say some people dey wait for the right time to set up something for themselves, but forget say time waits for no one.
Nigerians dey very talented and gifted but some factors folo dey hinder them from achieving their goals nah make them go say "mai take dis one dey hold body so I fit save small".
sr. member
Activity: 476
Merit: 337
October 09, 2023, 02:42:04 AM
#3
Omor, watin you talk nah true and I side am, those kind of jobs no dey good at all because I done see to couples way dey brawl because of day either the woman or the mand on of them dey come back home late from work.
This nah something way even the management of the place way person dey work supposed to consider for the help of their workers, like for other countries, I believe say some of those gobs for there get day and night workers and they no dey too start early because for some places nai evening and night nai be there morning, so them fit open by 10 o'clock am then night workers come by 4 o'clock pm and that there side a lot of roads dey way go make them reach there vicinity early.
This traffic matter nah watin government supposed to put in other for this we country, more especially for states way get a lot of populations like the Lagos state, so that pipo no go dey suffocate for traffic.
sr. member
Activity: 322
Merit: 224
October 08, 2023, 10:17:14 PM
#2
Jobs in our country here suck, just imagine a person who comes to the house as early as 6 A.M. go work, and e comot to work by 4 pm enters the road, meets traffic congestion, come reaches their house by 6 pm. Is it worth it with The minimum wage of 30k naira? This working system no dey favor our country people. Na still the same thing with company work.
Some work self no gets a resting day, from Sunday to another Sunday.

Abi na like this e is for other countries?.
No wonder many people like dey self-employed.

Me I believe say among those of us wey dey here fit hold political office tomorrow, abeg make we reason this matter.
The 30k salary no worth this kind of job but e better past to stay idle, and be do nothing, and you no go worry person for money every time to avoid see finish. Even as you dey suffer dy go the work try to look out for skill way be hot cake to learn and save the money small small from your salary to use learn the skill.
member
Activity: 334
Merit: 27
SOL.BIOKRIPT.COM
October 07, 2023, 10:25:57 AM
#1
Jobs for our country here sucks , just imagine person comot for house as early as 6 A.M go work and e comot for work by 4pm enter road, meet traffic congestion, come reach house by 6pm. Does it really worth it with The minimum wage of 30k naira. This working system no dey favour our country piple. Na still same thing with company work.
Some work self no get  resting day , from Sunday to another Sunday.

Abi na like this e be for other countries?.
No wonder many person like dey self employed.

Me I believe say among those of us wey dey here fit hold political office tomorrow, abeg make we reason this matter.

Added:
If you are offered 20million naira to start a business or to take a government job that pays 30k monthly, which one will you opt in for considering the economy situation of this country. Let's see your opinion regarding this cause we do see a lot of people craving for government work. We have also seen people been sick for not been employed as government worker. If there is no opportunity to get the offer of 20million naira, would you rather take a loan to start a business or continue waiting for government work

Give reasons to your answer and the benefits attached to it.
Pages:
Jump to: