Pages:
Author

Topic: A Skill or a degree - page 3. (Read 340 times)

hero member
Activity: 700
Merit: 577
January 17, 2024, 04:05:44 PM
#8
I no know how I want take start this argument because all of them he dey important but for now wey things e no dey all right e be like say we go take skill first before we go settle the matter for future. Even di skill sef we need knowledge so degree e good but certificate e no dey help matter. People don graduate tay Tay some don turn to billionaires without using their certificate so skill ni be konkon for now. Skillful workers are the best both in abroad and home.
sr. member
Activity: 182
Merit: 120
January 17, 2024, 03:29:37 PM
#7
If I'm not mistaking we've debated about skill and education before, the common mistake wey people dey make them dey choose one and condemn the other like choosing skill then forgetting about education, I don't blame people with this idea because naso we see the country and sometimes the price of school fees dey discourage people wey get the aim to go school so they decided to learn hand work, I never know why some people dey discriminate education for naija but some educated people still get job but it's very rare, even with job or no job education is power and the skill you mentioned na dey help plenty people for this country, the part you mentioned about skill and job I never hear anything like that, if I may ask which kind skill wey employee need wey graduate no fit offer  and mostly computer skill wey you fit learn for school and attending online class. With better skill you no need to wait for employment cause you fit start with any little capital na why people dey choose skill but for me I go like the both and na wetin people dey do, if doubting ask people around they will tell you they're graduates.
sr. member
Activity: 588
Merit: 338
January 17, 2024, 02:46:43 PM
#6
Skills and degrees de very important, as the world be today if you specialize for one skill and you get certificate to back am up, you go get a better chance of work than person wey get only skill, so di combination de better. Education de very important, e suppose be di foundation for everybody, e go help somebody to de enlightened and to see things from a broader view, but education alone no be guarantee for wealth, person suppose get di mindset of making money to de wealthy. Because you fit see Igbo men wey no go school but dem de very successful for business, also skills fit to guarantee person wealth because no be everybody fit to perform dem work, therefore dem money de sure.

So in conclusion education na important foundation for everybody, but no be only am be di road to success, who no get di opportunity to go school fit to learn better skill, in di end both of dem de important to succeed and increase our income.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
January 17, 2024, 10:31:56 AM
#5
Op be like say you don too see Nigeria finish naim make you write this kind of post. I been dey expect something like, skill and degree vs degree aguement before, but this one wey you come dey against degree my brother you dey wrong but not totally wrong.

The aguement of skill and degree which one beta pass, no suppose be aguement at all if you o say our country get good reffinary and good company wey go help reduce unemployment. Small OND degree dey earn half a million for multinationals. So na that kind thing you wan use compare skill wey no fit pay you reach 300 a month. My brother even if my statistics dey wrong, for real life you no go fit compare person wey use degree get work and person wey na just skill e get take get work unless you you mix the two against one. Na there real aguement dey.
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
January 17, 2024, 09:54:02 AM
#4
My brother wetin you dy talk no dy far from the truth, but you also need to know say e depends, like what kind of skills are you talking about? See a skill like coding fit stand shoulder to shoulder with any degree,  even masters, but you also need to know say masters degree in medicine or the surgical department fit compete with any skill in the world, but we as a person e dy normal say we dy mostly go for wetin we get passion for, no be everything be money, most people go for wetin dem get passion for, so take note.
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
January 17, 2024, 09:52:32 AM
#3
~

Well, for this one I no go agree with you. That wan be becos both skills and degree dey very important for the country wey we dey so. As Dem dey talk am for we country, person supposed get pass two source of income wey e fit dey survive put for this hard economy. Normally, the rate of unemployment for we country dey very high as work no dey, government no dey provide job for the youths. Person go suffer go school for how many years come out as a graduate with certificate wey no get use. The thing dey pain so many of our brothers and sisters well well for body.

For job market today, employers dey find people Dem wey get experience for many aspects. If as a graduate, you no get skills wey dey based on watin you study for school, e fit hard you as these employers Dem dey always find experienced people. This na why e dey advicible for parents to carry Dem children go learn work at a very young at, as this wan go later come in handy for future.

Without skills, you fit no get work. without degree, you fit get work but you no go fit grow go higher ranks. Both skills and degree dey work together as one. And for person wey wan reach correct position for work, e supposed get both.
legendary
Activity: 2184
Merit: 1302
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
January 17, 2024, 09:44:51 AM
#2
You no suppose select one out of the two, get the both of them. If you get your BA or MSC and also a skill alongside it, that is great, i know say as our society dey now, to find job dey hard and people rely on the skills wey dem don garner, but that one no make us leave education, go check the number of people wey dey take Jamb every year, you go understand say we still value education, which is great.

Getting a degree go also give you better exposure and even help you to understand the skills wey you wan learn, for example e go hard for you to see person wey get tech or computer skills wey no be graduate, so make we embrace both getting a degree and a skill too.
member
Activity: 308
Merit: 32
January 17, 2024, 09:29:05 AM
#1
Plenty reasons why skill dey important pass degree na say di job market dey always change. Wit new technologies and methodologies wey dey develop every time, many of di skills wey people bin dey consider important before fit no dey relevant again. As result, employers dey look for candidates wey fit quick quick learn and adapt to new skills, instead of people wey get degree for specific field.

Again, degree dey often refer to broad category of knowledge, while skills dey refer to specific ability or expertise. Employers dey find people wey get specific skills wey go fit meet di exact needs of their company, instead of general knowledge wey fit no dey useful.

For conclusion, even though degree still fit dey important for many people wey dey find job, e no be everything when e reach to get job or move forward for career. Employers dey look more and more for people wey get specific skills wey go fit apply directly for the job and fit help the company succeed. For today job market, e dey important pass ever to focus on develop skills wey dey demand, so you go fit increase your chance to get job and move forward for your career.
Pages:
Jump to: