Pages:
Author

Topic: A wake-up call for Nigeria youths (Read 263 times)

hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
February 06, 2023, 05:59:55 PM
#27
U dey yan sae, u don't know di matter for di kwantri. No bi dis Nigeria some youth sae make do thing to make di country better nai some other youths from back yard and betrayed you and I. The old politicians know how dem dey divide di country.. dis economics situation wey dey happened now sef na for di election that is coming forth. Dem wan use am buy vote very well. Di politicians have enough of the new Naira banknotes in their possession.
full member
Activity: 238
Merit: 112
February 06, 2023, 05:46:12 PM
#26
This is a wake up call for Nigeria youths during this election. Make we vote for the right candidate wey get a youthful energy for em body. Make we all know sae our future go be better than whatever decision we make today if we kukuma work harder and put things for perspective for our future
What you have said is the truth and nothing but the truth. I would like to add that, I think that the youth of this generation is the youth that has seen the most shege. The youths of this generation have suffered so much. It seems like we are paying for the sins of the founding fathers and the fathers after them. We have endured too many BS and right now our backs are against the wall. This is how far we can go. One more nonsense(election rigging) from the "fathers" and we will have no other option than to turn back and fight.
Yes he's right. The youth of this generation is in a mess we all have suffered a lot.
That's why you see most youth doing fraud.
I listen to a song that says NIGERIA GA-GA, POOR MAN DEY SUF-FER SUF-FER PO-SA PO-SA
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
February 06, 2023, 05:24:28 PM
#25
This is a wake up call for Nigeria youths during this election. Make we vote for the right candidate wey get a youthful energy for em body. Make we all know sae our future go be better than whatever decision we make today if we kukuma work harder and put things for perspective for our future
What you have said is the truth and nothing but the truth. I would like to add that, I think that the youth of this generation is the youth that has seen the most shege. The youths of this generation have suffered so much. It seems like we are paying for the sins of the founding fathers and the fathers after them. We have endured too many BS and right now our backs are against the wall. This is how far we can go. One more nonsense(election rigging) from the "fathers" and we will have no other option than to turn back and fight.
member
Activity: 406
Merit: 84
Eloncoin.org - Mars, here we come!
February 05, 2023, 02:16:12 PM
#24
This thing wey you talk na better talk oo, as I read am my body really sweet me well well, but I really wish say all the youth go abide by it,
Papa wey don old no go retire and rest, Dem go want hold the power forever,
Make the youth come together make we collect this mantle of leadership from this old wicked leaders wey no care about us, no be fight we go use collect power oo, no be by talk talk oo, but na with our PVC, I urge all of us to get our PVC so we fit vote out this old men,

Make we shun tribalism, ethnic groups, religious group, make we stand and vote in our preferred candidates, so that we no suffer again, we Don too suffer now, na wa oo.

It's time for we to collect this mantle of leadership, na our turn ...
hero member
Activity: 742
Merit: 529
January 11, 2023, 04:27:59 PM
#23
Dis talk wey OP drop lik dis don burst my logo enta my bone marrow cum mk shame dey catch me on top seeing say even at dis youthful age wey I dey I no even get chance to even hold any leadership position for ma own comuniti not to talk of counsellor position sef for local level based on how dis old men dem wey dey for political positions since independence don mk am luk lik youths no fit get naytin useful to offa for governance until Dem done dey old. It dey pain me wen I hear dis proverb wey Dem dey tk deciv us say" wetin elder sit down see say small pikin no fit see am even if him climb tree", cos if wetin d elder dey see na beta tin den him for no sit down dey luk am him for get up.
So youths we gat change our narrative, perspective, paradigm and mentality towards governance, if not dis old men go continue to dey rule nd replace Demselvs with their children children while di common man continue bcomin common. If we all involve for di politics of our con3 directly or indirectly by the next decade to com we go see say youths go start to d man beta political positions for we con3.
Naija youths It's time to take away the FEARs!
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
January 10, 2023, 07:27:09 PM
#22
The real youth of Nigeria can't win election in Nigeria bcuz di bad Youth which is used by di politicians are using all means to win election for their corrupt leaders. But that not withstanding, this year election go be different all together. Peter Obi nai be di pple choice. And im go win the election.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
January 10, 2023, 03:37:13 PM
#21
Quote from: Marykeller
This is a wake up call for Nigeria youths during this election. Make we vote for the right candidate wey get a youthful energy for em body.
I believe Nigeria will surely get it right this time around, so that other countries wil not look down on us than to praise us anywhere we go. Now is 45 days to presidential election, i guess many youths are very ready to make things work smoothly in their various unit to ensure they monitor the election not to allow bad things happen. It will be difficult for the youths to miss it , becos the right candidate has already showcased what Nigeria want and he is ready to make them happen in his government.
member
Activity: 308
Merit: 26
January 10, 2023, 02:56:47 PM
#20
We no supposed they fear for our rights o, this is our country and together we will take it back.
Gone are the days the military ruled us and our rights were violated, now Wil are in a democratic government with a constitution to back up our rights and civil responsibilities.
This is our father land it's for the youths, the children and adults not for a particular set of people that have been in power recycling themselves.
This election is a different one and I know Nigeria youths will rise and make their votes count.
Voting competence over party factor. Voting a man that can pilot the affairs of this country not minding his tribe or religion
hero member
Activity: 532
Merit: 508
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 09, 2023, 05:31:08 PM
#19
Due to the military regime as of then, there was even fear among the leaders of then, and they obeyed the laws because if they neglected the law, they would face penalties ASAP. For example, even Obasanjo was a prisoner before Leta became president after his sentence was completed.

After the military regime, things were still much better, but as time went on, things changed, and up until now, corruption, looting of money, and killing are at high rates.

One problem I see with Nigerian politicians is godfatherism, which makes the leaders misbehave most of the time. The problem of Nigeria triggered by the leaders mindset can equally affects the youths because if they possibly attain power, they are going to have their own selfish interests too.

Pet Obi is going to have the majority of votes; I pray he wins.
hero member
Activity: 812
Merit: 725
January 09, 2023, 04:00:33 PM
#18
This is a wake up call for Nigeria youths during this election. Make we vote for the right candidate wey get a youthful energy for em body. Make we all know sae our future go be better than whatever decision we make today if we kukuma work harder and put things for perspective for our future
As I read this thin, my bodi weak because we youths don too give dis old men time to de rule us anyhow.

For School, dem de tell us we be leaders of tomorrow, but people wey dey since yesterday never leave space for people wey de today talk less of us we go de expect to lead tomorrow.

We really need to wake up and make decisions ourselves, because the way d way technology don advanced, na we youths know how we go take move dis country go another level because all dose advance countries na youth de lead dem, so for we to move go were people de go na to follow who know road, therefore we need to wake up.
full member
Activity: 798
Merit: 134
January 09, 2023, 03:25:19 PM
#17
This is a wake up call for Nigeria youths during this election. Make we vote for the right candidate wey get a youthful energy for em body. Make we all know sae our future go be better than whatever decision we make today if we kukuma work harder and put things for perspective for our future

If we really wan wake up the youth then we no suppose dey suggest Peter obi as candidate to them to vote. Peter obi isn't a youth, he's 61 years officially and who knows if that age has been faked or not as 90% of Nigerians no dey use their real age. The faking dey start from university days so dem go dey longer for government work wey Politics na also one of them. This election isn't about youthfulness because if na him none of the 3 top candidate qualified.

We go fight for youth president later and make the youth start they put interest so we go get them plenty and get option to choice from instead of falling back to who we think is closest to a youth. That year wey this youths rule, nobody give them na dem stand up fight for am so if we want the same thing then make we stand up our own and fight for it .

Boss sorry oo
We no dey support Obi because him be youth but we dey put for front because na him dey trusted and educated among those three old men, basically e get some things wey boiz dey want make him go, but wetin i noticed be say this old men no gree removed hands make youth take over why because dem believe say if we take over nothing for them again and some people take as in heritage, weda we like it or not dem must be president, oya think wetin this kind person dey talk and if e happened say him go now wetin you think say we go be for him eyes, and besides dem never really give us chance to rule for this we country rather na only one sets of people dey always rules abi we no follow this we country again?
hero member
Activity: 644
Merit: 544
January 09, 2023, 04:52:24 AM
#16
Op this matter you brought up really make me think tins plenty. Na a better tin to they see youth they rule ooo, and
we need seriously to wake on top that matter to fight for the opportunity. but my question is that will that solve our problems in this country? The Youths of nowadays are not like  those youths that rule doing the military region, and infact na military region they were, where military control and do whatever they wish.many youth of nowadays are so eager to make it make it at once, so many of them have failed the opportunity given them from ground.

Many youth have been given opportunity but they fuckup due to their selfishness.let make dimeji bankole for example he was given opportunity once to become speaker of house of representatives but last last he fuck up by involving in fraud. Many cases like this done happen for even my local government.they always miss uses the little opportunity they get from masses. The mean thing make just vote for the right person.

sr. member
Activity: 560
Merit: 418
January 08, 2023, 08:03:07 PM
#15
For this naija I no sure say that line wey them say "we are the leaders of tomorrow" e still dy oh because if you check am well the youth dy even find am hard to see for chop self, after you manage escape school finish work self you no go see, tell me why some youth wey hungry and depression don scatter there brain-box no go accept to do dirsty job for politicians all in the name of to get the least #1500 make them take sustain?

The matter wey we dy try discuss here no be come chop oh, we youth wey think say e go better tomorrow don give up that hope oh, I mean some youth. No matter how we youths wake up reach e still get some youth wey never ready to wake up because that bad side still dy itch them for head, for person to tell me say make I just go stand for one line say the least #500 go reach me for my own thumb printing too, ah, nah sell I sell myself if I try am oh. This contri difficult like video game wey them put for VERY HARD oh.
member
Activity: 308
Merit: 26
January 08, 2023, 06:06:22 PM
#14
At this point of our country. Every youth gats wise up for this country because normally we done too suffer, These old politicians no they carry our matter for mind, them no reason us o, weda we dey suffer or not, they just dey after there personal interest,

Now e no go be business as usual, wey we dey sit down for house watch movie on election Day, with the mindset say our votes no go count,
This time we gats ready come out vote for the candidate wey we know say e go move our country forward, no sell your vote for peanuts, becos na another 8 years of suffering be that,  make we vote who fit move this our country forward so things go better for all of us.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
January 08, 2023, 07:14:31 AM
#13
This is a wake up call for Nigeria youths during this election. Make we vote for the right candidate wey get a youthful energy for em body. Make we all know sae our future go be better than whatever decision we make today if we kukuma work harder and put things for perspective for our future

If we really wan wake up the youth then we no suppose dey suggest Peter obi as candidate to them to vote. Peter obi isn't a youth, he's 61 years officially and who knows if that age has been faked or not as 90% of Nigerians no dey use their real age. The faking dey start from university days so dem go dey longer for government work wey Politics na also one of them. This election isn't about youthfulness because if na him none of the 3 top candidate qualified.

We go fight for youth president later and make the youth start they put interest so we go get them plenty and get option to choice from instead of falling back to who we think is closest to a youth. That year wey this youths rule, nobody give them na dem stand up fight for am so if we want the same thing then make we stand up our own and fight for it .
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
January 07, 2023, 06:46:43 PM
#12
Youths for Nigeria na dem don sell their right of leadership give these old men wey come turn am to their family right. After the Military Regime wey Obasanjo win na that time the youths suppose to start to ginger but fear say I no won die,I won enjoy life,I never marry,I never born pikin e.t.c make we look this old men turn this country upside down. Obi na the man wey go fit help this country small,so make we go vote am and counsel those political thugs on the leadership of youth government instead of them to dey gamble with their future. No be to buy form,people dey wey fit sponsor elections.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
January 07, 2023, 04:26:45 PM
#11
if we settle down look this matter you get point, but nigeria of that time no be waiting we get now bwe that, the way this people they now It will be difficult for a youth to become president one election now ba thing of money how many people actually get money to buy the ticket talk more of the campaigning and the rest, it is going to be more difficult than you expected, with time we hope things can change.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
January 07, 2023, 09:21:35 AM
#10
Wetin I know be say Dem no dey tell person, person go learn lesson. As you rightly state, the first president of naija, Nnamdi Azikiwe was a youth and from the litter history we fit gather about am, na person wey try e best to not allow the Western ways, propaganda and manifestos sway am despite say nah their im do him education.
 Sorry to say but at present, a naija youth dey more concerned about the financial benefits wey go dey attached if given opportunity to enter power and I feel say doz our fadas Dem wey dey seat no go wan give up easily as e be like say no serious tin fit come out.
 For radio today, I hear wan youth dey boldly say e go collect in exchange for im vote if one of dis old daddies wet im pocket.
sr. member
Activity: 378
Merit: 259
January 06, 2023, 11:41:47 AM
#9
Waiting them dey think for this country politics na for an old age not for the youths that's why dem no want to give any youth to become a leader and make things easy mostly now  before you see any youth to become a leader him family member most be among the politics wey go do ojoro for am, we have to shine our eyes if we still not vote for the right person we are going to suffer for another good 8 years, na we go choose better person and make things better for this country.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
January 05, 2023, 01:10:06 PM
#8
Thank you my brother you use sense talk better as nigeria youth wey you be and you also know your right for the country and base on the matter wey you talk now ehn we get you and we go show them shege say na we the youth get power for the country because no matter waiting go happen for the country now the youth must attend to issues, so as he stands now make we try to get pvc because na the Main thing be that because some of the youth base on say they don see shege dey no wan do pvc, abeg as youth wey we be make we try do pvc make we vote for better person wey go change our lifes
Pages:
Jump to: