Pages:
Author

Topic: A wake-up call for Nigeria youths - page 2. (Read 371 times)

sr. member
Activity: 966
Merit: 391
Underestimate- nothing
January 07, 2023, 03:26:45 PM
#11
if we settle down look this matter you get point, but nigeria of that time no be waiting we get now bwe that, the way this people they now It will be difficult for a youth to become president one election now ba thing of money how many people actually get money to buy the ticket talk more of the campaigning and the rest, it is going to be more difficult than you expected, with time we hope things can change.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
January 07, 2023, 08:21:35 AM
#10
Wetin I know be say Dem no dey tell person, person go learn lesson. As you rightly state, the first president of naija, Nnamdi Azikiwe was a youth and from the litter history we fit gather about am, na person wey try e best to not allow the Western ways, propaganda and manifestos sway am despite say nah their im do him education.
 Sorry to say but at present, a naija youth dey more concerned about the financial benefits wey go dey attached if given opportunity to enter power and I feel say doz our fadas Dem wey dey seat no go wan give up easily as e be like say no serious tin fit come out.
 For radio today, I hear wan youth dey boldly say e go collect in exchange for im vote if one of dis old daddies wet im pocket.
sr. member
Activity: 602
Merit: 306
January 06, 2023, 10:41:47 AM
#9
Waiting them dey think for this country politics na for an old age not for the youths that's why dem no want to give any youth to become a leader and make things easy mostly now  before you see any youth to become a leader him family member most be among the politics wey go do ojoro for am, we have to shine our eyes if we still not vote for the right person we are going to suffer for another good 8 years, na we go choose better person and make things better for this country.
sr. member
Activity: 742
Merit: 349
January 05, 2023, 12:10:06 PM
#8
Thank you my brother you use sense talk better as nigeria youth wey you be and you also know your right for the country and base on the matter wey you talk now ehn we get you and we go show them shege say na we the youth get power for the country because no matter waiting go happen for the country now the youth must attend to issues, so as he stands now make we try to get pvc because na the Main thing be that because some of the youth base on say they don see shege dey no wan do pvc, abeg as youth wey we be make we try do pvc make we vote for better person wey go change our lifes
hero member
Activity: 602
Merit: 442
A Proud Father of Twin Girls 👧 👧
January 05, 2023, 08:51:46 AM
#7
I like the way the youths dey really take this things upon themselves but most times the major problem we dey get na with the security agencies wey just dey after taking instructions without considering the consequences trying to please their leader.
This matter make me dey remember October 2020 when the shooting and killings was so open and uptill now nothing has been done about those killings and now those leaders are also coming out for some political positions and it seems we have forgotten about everything that happened then and now we are talking about another election, what a bloody country.
One of the major reasons I feel say dey deprive tye your for coming out for political positions is fear of the unknown and finance.
With this two reasons I think the youths are already crippled and only hopeful and most times we youth don't know how to use power and I could also remember a house of rep member who slapped a pregnant woman in a supermarket and I think we youths just have to be ready to be accountable for every actions and consequences of every action we take.
hero member
Activity: 1008
Merit: 702
January 04, 2023, 04:18:09 PM
#6
Everything wey you yarn for here now dey correct my brother. Dis na wake up call for us and we gats stand on the mandate of making the country a resourceful place for us all. Much don happen and still dey happen, we no suppose still dey fold our hands dey watch dey go. Our activeness for dis election period go help us make things better, hope we get d best change dis time around for the prosperity of the nation.
hero member
Activity: 1036
Merit: 675
January 04, 2023, 03:29:25 PM
#5
After Nigeria independence in 1960, the first people wey rule Nigeria then na the youths between the age of 27-35years. That time the youths were they ones wey d in charge and na them d take decision and talk wetin go happen for the country then although na military regime that time.
No be lie u talk. Sometime ago, I watch one documentary of d whole independence somtin nd e go shock u d ages way all these men bin dey wen dem come into power. Dem bin dey vry young nd d leadership was good not until, dem start to identify say, power get anode somtin way follo 4 bodi. As dem don taste am, dem no wan leave am again. E jst bad!

We need taste youth leadership again 4 dis country. Some set of ppl nd age grade mo need dey hold dis tin 4 hand as though, na dem sabi pass, na there own or dem get a define line 4 certain understanding on leadership qualities.
sr. member
Activity: 728
Merit: 354
January 04, 2023, 12:33:31 PM
#4
Op God will bless u for these thread I think these is the best time wey Nigerian youths go they wise and vote for better person because 70% of people wey no get job in this naija na youth then bii so make we they wise and choose good leader the country
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 04, 2023, 11:43:24 AM
#3
After Nigeria independence in 1960, the first people wey rule Nigeria then na the youths between the age of 27-35years. That time the youths were they ones wey d in charge and na them d take decision and talk wetin go happen for the country then although na military regime that time.

If una come check now, una go find out those people wey rule Nigeria that time in their 30's are still controlling and leading Nigeria till now. wey be sae dem no wan give the youths the mantle of leadership. wey be sae during their time na them d rule as youths and presently d wan d rule us wey be youths d go. Una see as the matter be so, as d wan continue to d do us shege d go.

Presently now, the economy of the country don turn many of the youths to be unemployed, for them not to be able to provide for themselves even for their family join. you go see 40years old man not married and still dependent on his parents for survival. if you come manage the successful as a youths, government or society go tag u as yahoo boi, based on u no fit d successful as a youth for the country due to the know how d country hard reach for you to be successful as a youth.

if to sae we d follow history we supposed know sae Obasanjo, Nnamdi Ezikiwe, Gowon, Ojukwu rule Nigeria at their youthful age at 30's. But in today realities youths are been used by old politicials to carry out their evil plans during election.

This is a wake up call for Nigeria youths during this election. Make we vote for the right candidate wey get a youthful energy for em body. Make we all know sae our future go be better than whatever decision we make today if we kukuma work harder and put things for perspective for our future
Well i wont say their is no sense in what you are trying to highlight because ever since our problems began as a  nation we have been ruled by this old men that have drag the our country into economic instability and crisis in all sectors of the government.

But the nations current situation is not only crowned to the fact that our leaders are old, a young and vibrant leader like you said can also put the nation into more problems so far as the individual is having the wrong mindset towards the country and being a great leader also is determined by your cabinet members and  we all know even the man with good intentions is still painted black because of the corruptful mind of his cabinet. So everything and everyone in Nigeria currently needs to participate in terms of making things right in country and i pray that we all change from our corruptful ways and always think positive and straight towards making the country a better place for both the youths and even the adults and elderly.

Nigeria currently now is on a crucial stage because any decisions made will determine the faith of the country either for good or for worse. So i would just urge very Nigerians to be very cautious of the future not today and vote the right person they feel can move the nation forward and not backwards. Forget about the money and yes the youth should wake up from their deep slumber and stop fighting and killing for those greedy politicians and think of how we can make Nigeria a better place for everyone.
hero member
Activity: 896
Merit: 654
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 04, 2023, 09:36:07 AM
#2
Wetin u talk make sense, na d time wey youth suppose take d mantle of leadership. But 4 naija, e no go dey easy like that, even d so-called youth no dey serious, dem be a betrayal of themselves, if dem see moni like dis, their wahala don finish. D task go hard bcos Poverty don eat deep 4 Niaja, and e don born corruption among d youth, so fighting for ourselves go hard even if some try 4 beta intention.

Youths wey won do am self no get d popularity, resources/money to do Naija politics, na make we dey look tins as e be like dis jare. Maybe if Obi fit enta, d political space go dey better, I no know. But d youth wey get moni and aluta spirit na dem fit reach there for high risk, how many of dem u don see?

hero member
Activity: 1064
Merit: 501
January 04, 2023, 08:45:54 AM
#1

Jump to: