make we no carry desperation and hustling for merit take spoil ourselves give this people abeg.
One thing about this kind of people be dem no waste time ban dem na dia eyes go open to start learning their corrections, anyhow e be i just post am here so dat any other person fit learn from this post but if the guy dey form donjazzy den make go him way who cares and who sabi am? Even d merit wey him dey hustle for go hardly meet am bicos him no wan follow better ways.
Lastly, make the guy post apology under this thread because we deserve it from him or her and delete that disgusting post. Locking the thread is not enough because e go dey break my heart if I waka jam am anytime. I'm very disappointed in whosoever is behind that account.
Well him no fit come here to write any apology post bicos him still dey claim right meaning say he is not ready to learn and me no even care about am rather if other reputable members do care about am too. So no reason am just let go so that we no go get personal beef with am, this forum is a free place to do whatever we want but doesn't mean we should disrespecting the entire nation in the name to seek for merits just as The Sceptical Chymist talk for him comments i really love the wey him take talk and handle the mata, this is to show say him still love Nigerians and not like others wey hate us.
I no wan talk much but anyhow una fit comment here make we reason the matter.
d truth be say, I no really blame d guy, na person wey introduce am enter forum na e I go blame. I sha know say e no even still be dat one fault o becos from waitin d guy talk for there, e show say d person be dey try help e life but I swear na wrong person e go help.
Na wetin make if we dey help person make we find smart people come here if at all you must help any person otherwise i no see any reason to carry graduated fools come full here to dey spoil we names for the forum. I believe say those people wey stick around we local board has learned something and those things dey really help them out.
I think is time we have a group outside here to know how to tackle this kind of issues of introducing incompetent people. If we go fit bring them to a group first for orientation before them register for the forum. Make una think of this idea.
Bring inside group is not the really the problems but what happened there is that this said person has refused to learn even at his rank as newbie still claiming right, do you think this rude person should be added to any group if there where any?
No! I no see am as person worth to belong to any group because na problems him/she go cause since him like arguments and na one thing wey me so much dislike even though me get that kind space to add am I no go even try am because na waste time and energy to bring such person to community group since him dey claim about his Degree meaning say people na nonsense for him eyes. Make we just free am then we wey don see this nonsense make we try make the correction before something like this go repeat itself again.