Pages:
Author

Topic: Always inform your relative about your whereabouts (Read 324 times)

sr. member
Activity: 378
Merit: 259
E get one incident wey happen for my area last 3 weeks, wey 4 person for one quarter for my area enter kidnappers hand. The matter no be small ooo as Dem suffer them , even threating to kill them for bush for their. Community people rally round to gather money pay this kidnapper to release them. Make I no cap too much, the major thing wey make me yarn this matter be say, this people wey Dem catch no even tell their relative say them dey go somewhere. Thank God say people see Dem as Dem dey go. Na that one make people raise alarm say, where this guy's. 3 guys enter one bike why the other one enter inh own separate bike because their mission different but these same direction. Na dis same spot Dem for catch them.

Lesson
  Always inform your piple about your movement if you trust them or find person wey you fit tell like wife or parent or pikin if u no trust any friend.

 Always pass busy road, bush road wey be shotcut naim keep people for inside bush for seven days with beaten wey wrestlers self no collect for their life.

Dey vigilant and make u no who be your friend

This advice good ooo, kidnappers no go enjoy your Bitcoin money leave you for hunger ooo. Shae una kno say, kidnappers dey work with information, so keep your Bitcoin investment from people wey you no trust make them no keep u for bush then collect your investment.
 
Wisdom Dem say, e dey profitable to direct person.

Op this your matter make sense, there's many people wey be say this kind attitude don dey use to their body, their own no mind whether the area when dem dey try go dey safe or not. People they do things for this life sha, na for them community them dey wey kidnappers take carry 3 three guys, as community no dey safe, how about people wey dey travel from one place to another without information their relative go do? Some people get mind travel from your town to another place, based on say nothing go sup. Make we dey reason say even people wey dem kidnapp or kill no get two head.

I know say some people go dey reason am say dem don reach level wey be say their parents no deserve to know where they are going to because it makes them feel like mama boy, na person wey care about you be yourself own, let them laugh you say you still be mama boy at your age, if them kidnap you dem no go contribute anything give the kidnappers. Let us be safe because no be everybody wey dey laugh with us get good mind.
newbie
Activity: 21
Merit: 3
This talk na some people suppose to dey listen or hear, because I done come across where one of my neighbor say she dey trave go lagos. She only tell me she no tell non of her family members neither her relatives also, the day she dey trave all of a sudden her phone start to dey switch off. I tried calling her no way but later she reach she start to tell me say rubbers attack them for road and na the driver with the thiefs them collabo together plan everything, and her brother was so worried about her well being because she no tell any of them. Me self I dey very worried when I been dey call her, say those theifs even carry them go bush them collect all their phones she manage hid her small phone inside her private part. Assuming she no tell me and she come die for their how e for be, her matter for just go like without no one knowing e bad like that.

So my people make we dey try to dey inform our relatives or friends about our whereabouts, e dey very necessary and very helpful because e bad say something happen to anyone and family's no know our whereabouts.

First try get partner. Partner no mean say na only your wife or girlfriend, your brother or your friend fit be your partner person way the two of una fit dey share some kind things. E really matters a lot because our well being also matters to our families and friends some fit say because their no dey treat them well but no still try get somebody way you fit tell everything about your waka today. Because right now our security one e no dey safe for people and everybody won make money by all means, and so many things dey happen so try to dey tell your friends or relatives your actual place your going. You fit imagine say everyday people dey miss God won't allow it to be you but what if e con be say na you and you no tell anybody your whereabouts. Then you go start to keep your people on thinking all throughout their life's because e no possible say you miss person for your family and you no dey bothered, they must dey bothered about your well being.

I come across some News earlier last week that some people where burnt in a fire catch, say pregnant women also dey involve for the fire some many people died at rivers state in portharcurt
https://www.bbc.com/pidgin/articles/cp0gj2rr6qzo
When I hear this story and see the people way die I no lie you I cry, some many people die okay just imagine say one of your relatives dey there and you no dey informed about their whereabouts e go pain die. So make we dey make try to dey inform our relatives or friends about your whereabouts because e help out too.
member
Activity: 406
Merit: 84
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Because of security not everywhere wey a person want to go him go tell his friends or relatives that is going so place, accept the friend that you really trust enough and with even thought a person trust his friends more than 100,% not all the secret you will been telling him. Because you don't those that are looking for you just to kidnap you and they might fit meet this your friends they understand that you guys always together in 24 hours they can only come to him and an conversation with him and decieve him if he definitely tell where his go they will give some amount of money and we all know money na it can simply change humans beings decisions with in 10 seconds.

But due to how the country his moving on currently now the country is not safe like before again is good to always inform our family members when we want or travel go so that Incase if something happens they can easily know or identify.
No matter what happens, be safe and easy going. This country comes with dangers and we ought to be strong if one's keen on surviving in Nigeria. It's not an easy job but we should always ensure to grab significant of growth. In every given point in time, we should always make sure we're in safe positions because this world have turned out to be a wicked place and I must say, there's enough danger out there in the real world. It's always more safer to totally abstain from social vices that bring negative effects to the society at large.
full member
Activity: 266
Merit: 140
Because of security not everywhere wey a person want to go him go tell his friends or relatives that is going so place, accept the friend that you really trust enough and with even thought a person trust his friends more than 100,% not all the secret you will been telling him. Because you don't those that are looking for you just to kidnap you and they might fit meet this your friends they understand that you guys always together in 24 hours they can only come to him and an conversation with him and decieve him if he definitely tell where his go they will give some amount of money and we all know money na it can simply change humans beings decisions with in 10 seconds.

But due to how the country his moving on currently now the country is not safe like before again is good to always inform our family members when we want or travel go so that Incase if something happens they can easily know or identify.
member
Activity: 103
Merit: 36
Lesson
  Always inform your piple about your movement if you trust them or find person wey you fit tell like wife or parent or pikin if u no trust any friend.
Na better remainder you come with so,  as the country no safe again at least make we dey try inform our love ones our movement especially if we dey travel, If dem know where we dey go e dey put dere mind at rest. Anytime wey i dey travel even if na 1day journey I dey try inform my parents because dere prayer dey important, so if you be child wey know wetin you dey do try dey tell ur love ones your movements make you use dere prayer guide body because our country no dey safe again..

Last two weeks, a 400-level student from a university in my state went missing. They looked for her everywhere, but she was nowhere to be found. It was only yesterday that they discovered her dead body. This shows that not only  not only kidnappers we should pray against, but also friends, boyfriends, and some family members.
Always pass busy road, bush road wey be shotcut naim keep people for inside bush for seven days with beaten wey wrestlers self no collect for their life.
Some times na we dey do ourselves for Naija we like shortcut and most of our shortcut road for Naija today na problem, I don't see the reason why I go pay driver full money and the driver go wan dey manage fuel sey e wan carry me follow shortcut wey no safe Angry If you wan talk dem go sey na God dey protect us my brother as God dey protect you try do your own part.
This advice good ooo, kidnappers no go enjoy your Bitcoin money leave you for hunger ooo. Shae una kno say, kidnappers dey work with information, so keep your Bitcoin investment from people wey you no trust make them no keep u for bush then collect your investment.
That one na true I no fit tell anybody about my investment, because not everybody dey happy with your success and some friends even dey even if you no tell dem about your things dem good in monitoring so we should dey careful with people we call friends
full member
Activity: 1176
Merit: 165
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
I know say this thing dey very important but e no dey easy to do.  E dey hard to tell your people every of your waka o. As a young bobo, once once you must involve in illegal movements,  how u wan take tell your people say you wan enter Casablanca?

Even as person wey don marry, you gat chill out sometimes make family stress no kill you.... base on that, how e go be to tell wifey say you dey enter some kind illegal place? Abi you wan scatter your family?

Wetin I go advise be say, person suppose get one trusted person wey you go dey relate your illigal movements to wey no go cast you o. Then wifey and family members fit know the normal movements them. Na sense them take dey survive for this life,  meanwhile, my comment na for the guy men them... no be for our Deeper Life members o  Cheesy Cheesy Cheesy

Lol, u funny I swear but truth dey for wetin u talk so, because e get some kind things wey dey happen for man life, wey u go need to comot clear your small make person no kpai because of stress or frustration or e get some waka wey person dey waka, oyibo people call am strolling for example u just won waka around the area and may be your wife dey inside, e no dey compulsory say u go tell am and e good make person keep some kind movement to oneself, because them dey fit trace person movement through person wey u trust or ur relatives, and e dey also cause see finish although e dey also good to let people know ur way about incase any unusual thing happened or say u don too stay long so that dey fit help in time, sha many advantages and disadvantages but in all make we just dey careful.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Dey vigilant and make u no who be your friend


Na better advise be this. Some friends dey do illicit activities but the other friend no go no but na when casala burst then police con dey involved story go change but you wey dey answer friend go follow enter. Such situation dey worse if to say that friend don even give you some things wey him still hold and police con truly see am with you or you provide the thing, hmmm case go increase. That's why Dem say show me your friend and I go tell you who you be. We need dey vigilant true true
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
E dey advisable for us to dey always tell our loved ones where we dey go because e get why. Dis world dey wicked and many bad things dey happen dis days. Armed rubbers fit waylay you for road, collect everything from your hand come leave you stranded, kidnappers fit obtain you, carry you go unknown location or bad friends fit do you evil too. Everyday evil for the country dey increase and na different different bad news we dey hear for radio and tv. So like dis na good thing to tell our family members of our movement, paraventure anything bad happen to us dem fit use the information take find us quickly.
sr. member
Activity: 560
Merit: 408
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
E get one incident wey happen for my area last 3 weeks, wey 4 person for one quarter for my area enter kidnappers hand. The matter no be small ooo as Dem suffer them , even threating to kill them for bush for their. Community people rally round to gather money pay this kidnapper to release them. Make I no cap too much, the major thing wey make me yarn this matter be say, this people wey Dem catch no even tell their relative say them dey go somewhere. Thank God say people see Dem as Dem dey go. Na that one make people raise alarm say, where this guy's. 3 guys enter one bike why the other one enter inh own separate bike because their mission different but these same direction. Na dis same spot Dem for catch them.

Lesson
  Always inform your piple about your movement if you trust them or find person wey you fit tell like wife or parent or pikin if u no trust any friend.

 Always pass busy road, bush road wey be shotcut naim keep people for inside bush for seven days with beaten wey wrestlers self no collect for their life.

Dey vigilant and make u no who be your friend

This advice good ooo, kidnappers no go enjoy your Bitcoin money leave you for hunger ooo. Shae una kno say, kidnappers dey work with information, so keep your Bitcoin investment from people wey you no trust make them no keep u for bush then collect your investment.
 
Wisdom Dem say, e dey profitable to direct person.

This your matter need to be taking serious because no place safe this country now ooo. Last week a friend of mine call me tall is friend was missing, which dey know were him go and him no inform any body where him dey go and e tell me say e never ty wen they had contact and then said may God guide him home, as am speaking now he came back yesterday which I dey very happy to hear the good and I didn't bother to ask about wetin do am because so many things have to kept screat because well have ears.

It very important to tell your people where you are go so that if dey wan find make e dey easy for them, also warn your family members to usually keep there were about screat, this happened to me which I lost my uncle that his neighbour make arrangements with the kidnappers am, to cut the story shout my escape from the hand of the kidnappers and my uncle try to inform his people about is where about and that how the neighbour try and inform the kidnappers and they wet there to kill him.
member
Activity: 784
Merit: 34
👉bit.ly/3QXp3oh | 🔥 Ultimate Launc
E get one incident wey happen for my area last 3 weeks, wey 4 person for one quarter for my area enter kidnappers hand. The matter no be small ooo as Dem suffer them , even threating to kill them for bush for their. Community people rally round to gather money pay this kidnapper to release them. Make I no cap too much, the major thing wey make me yarn this matter be say, this people wey Dem catch no even tell their relative say them dey go somewhere. Thank God say people see Dem as Dem dey go. Na that one make people raise alarm say, where this guy's. 3 guys enter one bike why the other one enter inh own separate bike because their mission different but these same direction. Na dis same spot Dem for catch them.

Lesson
  Always inform your piple about your movement if you trust them or find person wey you fit tell like wife or parent or pikin if u no trust any friend.

 Always pass busy road, bush road wey be shotcut naim keep people for inside bush for seven days with beaten wey wrestlers self no collect for their life.

Dey vigilant and make u no who be your friend

This advice good ooo, kidnappers no go enjoy your Bitcoin money leave you for hunger ooo. Shae una kno say, kidnappers dey work with information, so keep your Bitcoin investment from people wey you no trust make them no keep u for bush then collect your investment.
 
Wisdom Dem say, e dey profitable to direct person.


And all these things dey always happen when wey don dey middle of the year especially October, me like this i no fit commot wey my Girlfriend no go ask me and me i no fit keep my mouth shout if i wan drive out, even as she dey school she no dey with me na so she go dey call me to dey check on me if i don reach or i don come back, even one of my guy house wey him invite me over on to say the guy dey owe me money and small misunderstanding come follow dey inside the money matter so as this my gee invite me over i come tell my gf na so she dey panic, na so so call my gal give me even as i reach there come back. so definitely THIS THING YOU TALK IS A REAL DEAL 🤝
sr. member
Activity: 812
Merit: 257
Eloncoin.org - Mars, here we come!
kidnapping with the mode of knowing the bitcoin balance in my opinion is quite extreme, or is bitcoin that popular there? That means assuming everyone has bitcoin and wherever they go they can take it anytime and anywhere?

It's best if friendship is better not to know about finances and what is invested including social media because it can trigger someone to collect home information, names, cellphone numbers, activities from time to time and even signs of bitcoin ownership, can be from screenshots or status (threads) on social media that are shared.

telling if possible to the home person before leaving for the destination and the road taken can be a solution and can use hidden cameras such as cctv on clothes, pants, rings etc. which may later be useful for searching or becoming evidence.

This type of crime is quite high in other countries, although the motive is different but preventing and anticipating when it happens can make handling and searching faster. may we all be blessed friends.
member
Activity: 334
Merit: 27
OP this topic make sense o but make I tell you the truth, no be everybody wey like to dey tell person where dem dey go o. Some people own be say na don't tell anybody.  Anywhere dem dey go no concern you.
But e no make sense,  if you wan commot at-least make u tell one person where u dey go incase if anything happens your family members go sabi where dey go find you go, the way insecurity they increase for dis country, e better make u they security conscious if u they waka and make u make sure say people sabi ur where about. I know say even to trust people with ur movement na problem now, but at least you suppose get like one person wey u go trust wey fit dey know where u dey go.

As I dey school dey get one guy I sabi then, even if d guy dey go house for break, him no dey inform him parents say him dey come back house. How u go take dey travel and u no go inform anybody e no make sense now country no dey safe again.

My brother u dey same page with me, after I make this post, kidnappers don con intensify their operation , as at yesterday evening another operation of kidnapper na ihm vigilante and police abort , Dem nearly move people inside forest , if no be the help of security men no be wetin we for dey talk now. If u still get parent, at least tell one of them ur movement, if you get wife or husband, try tell them, make we leave the issue of illegal Waka, no be when the country security dey hard now. If e happen finish, na Dem go still bear the pain and struggle for the person release. Shae you know say, sometimes Dem fit discourage you for some kind Waka wey u like Waka or Dem get information say dat road dey , dangerous.
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
OP this topic make sense o but make I tell you the truth, no be everybody wey like to dey tell person where dem dey go o. Some people own be say na don't tell anybody.  Anywhere dem dey go no concern you.
But e no make sense,  if you wan commot at-least make u tell one person where u dey go incase if anything happens your family members go sabi where dey go find you go, the way insecurity they increase for dis country, e better make u they security conscious if u they waka and make u make sure say people sabi ur where about. I know say even to trust people with ur movement na problem now, but at least you suppose get like one person wey u go trust wey fit dey know where u dey go.

As I dey school dey get one guy I sabi then, even if d guy dey go house for break, him no dey inform him parents say him dey come back house. How u go take dey travel and u no go inform anybody e no make sense now country no dey safe again.
sr. member
Activity: 434
Merit: 500
A lot of things de happen for this country ooo and if i hear about kidnapping e no de surprise me like before again because for my place now kidnapping don even de turn normal thing, almost every month we de hear new cases of kidnap. Na only God fit save us for this country like this, people just fit go any length just for money na why every time we go just de hear different things wey de happen and e de fear me seriously like why do we have to hurt anyone just to make money. Why can’t everyone just work legally for money as it is supposed to be.

We just have to be careful wherever we are and always be at alert, we should always be vigilant and just as op suggested we should always make sure a friend or relative is aware of our whereabouts and most importantly we should always pray for God’s protection.
full member
Activity: 238
Merit: 151
E get one incident wey happen for my area last 3 weeks, wey 4 person for one quarter for my area enter kidnappers hand. The matter no be small ooo as Dem suffer them , even threating to kill them for bush for their. Community people rally round to gather money pay this kidnapper to release them. Make I no cap too much, the major thing wey make me yarn this matter be say, this people wey Dem catch no even tell their relative say them dey go somewhere. Thank God say people see Dem as Dem dey go. Na that one make people raise alarm say, where this guy's. 3 guys enter one bike why the other one enter inh own separate bike because their mission different but these same direction. Na dis same spot Dem for catch them.

Lesson
  Always inform your piple about your movement if you trust them or find person wey you fit tell like wife or parent or pikin if u no trust any friend.

 Always pass busy road, bush road wey be shotcut naim keep people for inside bush for seven days with beaten wey wrestlers self no collect for their life.

Dey vigilant and make u no who be your friend

This advice good ooo, kidnappers no go enjoy your Bitcoin money leave you for hunger ooo. Shae una kno say, kidnappers dey work with information, so keep your Bitcoin investment from people wey you no trust make them no keep u for bush then collect your investment.
 
Wisdom Dem say, e dey profitable to direct person.


E dey very important to relate our movement to our loved ones o we no say nobody wey no go die but make we use our head correctly. The way the world be now things dey happen well well and na most of those people wey we trust dey betray us so that is why there is need to inform people around you about your whereabouts as it will be easy to run investigation incase of any difficulties. No claim say you be big boy or big girl o, at least if you no value yourself e get people wey value and look up to you so no make them look confused because of your careless ness.

Moreover, it is important to tell people around you about your activities as they might also guide you incase they sense danger. And again make we also be our brothers keeper as in we ought to know about the whereabouts of each other as this practice brings about love and unity among one another.
full member
Activity: 392
Merit: 236
Bitcoin in Niger State💯
I know say this thing dey very important but e no dey easy to do.  E dey hard to tell your people every of your waka o. As a young bobo, once once you must involve in illegal movements,  how u wan take tell your people say you wan enter Casablanca?

Even as person wey don marry, you gat chill out sometimes make family stress no kill you.... base on that, how e go be to tell wifey say you dey enter some kind illegal place? Abi you wan scatter your family?

Wetin I go advise be say, person suppose get one trusted person wey you go dey relate your illigal movements to wey no go cast you o. Then wifey and family members fit know the normal movements them. Na sense them take dey survive for this life,  meanwhile, my comment na for the guy men them... no be for our Deeper Life members o  Cheesy Cheesy Cheesy

I enjoy how you take nack the nail on top the point even though I no like the name illegal sha. Person wey dey innocent or old school  fit translate am something else. But na the koko and matter be that. As we dey young so, na so we dey hunt for our freedom. Freedom of speech, freedom of expression, freedom of association and freedom of movement.

As person dey mature na so him want make them allow am talk. Na so him wan contribute for every conversation whether e consine am or not. Him wan chuk mouth for any Mattias. But as person don dey grow old again, na so him go know say, there's power and wisdom in silence. When you don't talk necessarily, you save more words for the future use. And na so u go leave people inside incognita mode. E dey okay make life be like that.

As for freedom of association and movement, as plenty of us dey mature na so we wan dey jump from one place to another con dey wan make plenty OGs at same time. We want make people dey hail us, make.dem sabi say we dey exist. Always trying to become relevant and get some validations or blueticks from people. But as you don dey grow, na so you go still realize say e no be anything. Na as we dey get that freedom of association, na so we dey pursue freedom of movement.

Every place we wan go, we wan follow-follow and we wan dey waka, waka go different places, including places wey fit spoil our character (na that one be the illegal place wey u mention). We wan pull up with guys, we wan make dem hear us for street and na plenty reasons why youngsters dey quick-quick push themselves go early grave be that.

Clearly at OP, ur family and trustees no fit save guard u where dem supposed harm u just by telling them ur whereabouts. Just as ur storyline, if the guys has told their parents (trustees) about their where to or whereabouts and they kidnapers hit them, how the family (trustees) want take give save guard response to that scenes?

You talk am well, mate. Telling your family your whereabouts is not just enough. Being able to identify your boundaries as in places and periods to move around will be very helpful. Also make you try to understand the terrain wey u dey enter go really help a long way because most places wey these kind things they happen deybget signature (track records) unless on exceptional cases. So e good make we discipline ourselves well and monitor our movements as well as people around us (the passersby) and the environment at large. When you notice Surugege dance (suspicion), no body need tell you japa.

Prayer na the roadblock to any evil and devil irrespective of how much them be or the number of attacks. No weapon that is fashioned against you shall prosper, and you shall confute every tongue that rises against you in judgment which also includes ill-fated attacks from enemies and frenemies. Person wey God don protect, man no fit harm am no matter how them gather.

As a person you suppose get this mindset after you don exhaust all other precautionary measures because for this our country, not even the family and friends, dey secure again. And kidnappers no dey send numbers of target before them hit.

To back up your prayers na to set up emergency numbers for your phone so you fit phone a friend or family when you're in danger. Also try make you know how to dial the 911 number so that you can reach out to the security deposits close to your vicinity. Some of them they work and dem fit rescue you sharply. No just underrated any options in the event it happens (God forbid) and learn how to shout and cry out loud when that could bring a solution to the situation.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
E get one incident wey happen for my area last 3 weeks, wey 4 person for one quarter for my area enter kidnappers hand. The matter no be small ooo as Dem suffer them , even threating to kill them for bush for their. Community people rally round to gather money pay this kidnapper to release them. Make I no cap too much, the major thing wey make me yarn this matter be say, this people wey Dem catch no even tell their relative say them dey go somewhere. Thank God say people see Dem as Dem dey go. Na that one make people raise alarm say, where this guy's. 3 guys enter one bike why the other one enter inh own separate bike because their mission different but these same direction. Na dis same spot Dem for catch them.

Lesson
  Always inform your piple about your movement if you trust them or find person wey you fit tell like wife or parent or pikin if u no trust any friend.

 Always pass busy road, bush road wey be shotcut naim keep people for inside bush for seven days with beaten wey wrestlers self no collect for their life.

Dey vigilant and make u no who be your friend

This advice good ooo, kidnappers no go enjoy your Bitcoin money leave you for hunger ooo. Shae una kno say, kidnappers dey work with information, so keep your Bitcoin investment from people wey you no trust make them no keep u for bush then collect your investment.
 
Wisdom Dem say, e dey profitable to direct person.


Especially girls and everyone is feeling too big to say they are going out but the country is not even that safe, taking serious security measures is the best thing to do, and the issue of kidnapping has even reduced I remember days when they were operating seriously, especially in that Kaduna road and were requesting for a large amount of money from the families of victims and if they don't comply they end up killing them. and the measure you stated will be helpful, especially when trying to pass busy roads most importantly you need to people of your whereabouts, because people that were kidnapped hearing from them you will know that it is not a good experience at all so when we are on the street we should be careful.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
E get one incident wey happen for my area last 3 weeks, wey 4 person for one quarter for my area enter kidnappers hand. The matter no be small ooo as Dem suffer them , even threating to kill them for bush for their. Community people rally round to gather money pay this kidnapper to release them. Make I no cap too much,

Kidnapping still dey happen very well for this country, make we no dey mind media say dem no dey report am again but it's still a big issue and the rich no be their only target again as anybody now na target and the kind money this kidnappers dey call to release their victim you go begin think say money full this country like dat. Just few weeks ago dem kidnapped one journalist for my state and na so so millions dem dey call, e come belike journalism dem get money. Some of this kidnappers no ever need the money but are after the body parts of humans because dem dun dey cost for market now and some evil man (both politicians and business Man are using it for money ritual), we just need dey careful on how we dey walka and atleast make our people dey know where we dey go.

Quote
This advice good ooo, kidnappers no go enjoy your Bitcoin money leave you for hunger ooo. Shae una kno say, kidnappers dey work with information, so keep your Bitcoin investment from people wey you no trust make them no keep u for bush then collect your investment.

Keep your Bitcoin investment secret make nobody know how much wey you dey invest, dem fit know say you dey invest in Bitcoin or other cryptocurency but make dem no know how much you dey invest inside because most of the kidnappings wey dey happen na inside information due to envy from your friends as you dey do better than dem and dem go come set you up. Whenever you dey go anywhere try make one trusted person know where you dey go so if something happen and dem wan look for you dem go get idea where to start from. This life na God dey protect so make we dey seek God protection as we dey commot because na only him fit guide your going out and coming back
full member
Activity: 448
Merit: 117
OP this topic make sense o but make I tell you the truth, no be everybody wey like to dey tell person where dem dey go o. Some people own be say na don't tell anybody.  Anywhere dem dey go no concern you. If you like ask dem no expect dem to answer you and If dem reply you forget wetin dem talk because no be the place dem tell you dem dey go so.  Truth be told, e good make person get one Padi wey him dey get good rapport with so as to keep track of am if alarm blow.  As a guy man too even if you no fit alert anybody to know about your Parol make sure say your Padi know what's up and too make your family too  know that Padi so that them go call am if e happen say nobody knows your whereabouts.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
Omor, you talk well Sha, but e no dey easy bro, you fit tell your people your way about for complete 1 month but you no go fit continue to tell them for complete 3 to 4 months because e no dey easy to do so.
You no say sometimes, if you won comot and people no dey your house, who you go tell? Abi you go write letter keep? No nah, the thing he say your mind no go tell you whather you won enter problem or not, but on a second thought, if you get cellphone you fit make call either you call any of your love ones or somebody close, but that one self nah another tin way we no go fit keep, sometimes we fit no get recharge card to use make call.
As long as say we they leave for environment way other people self dey, anyhow we Waka eyes must see us even though say them no know were we they waka go, as long as them see the direction way we enter if something happen people way observe go raise alarm.
Pages:
Jump to: