Mr @Agbe so nah so you dey take tell fine pikin like @Perfectbaby say she do well or she try, wahala heheh😅 wayo man... Abeg tell her something for ear jor.
Well for me I no see any limit to post per day oh is just that nah when you enter campaign and e get some wey go say you must post at least a max of 5 post per day, and if you post pass nah you and the manager go know if nah you be manager or nah him, hope I correct for this one oh because nah wetin I see for some instructions for some campaign.
But as e be now just dy post as e sweet you for belle but add am plenty sweet sweet spice make the post sweet people for eyes.
I wish you good luck but no be Jonathan oh... @Perfectbaby
Hehe, I get una lyrics I know say e no easy sha but that notwithstanding, I don see some campaign too like this few days of being here I just try to dey move round the forum without posting I come see say na mostly campaign dey get those rules oo. Like this me no fit talk about those ones because I know say my level never near there but I believe say one day one day me too go pick the calls from Oluwa.