Pages:
Author

Topic: Battle of why we dey earn but no progress (Read 294 times)

sr. member
Activity: 1288
Merit: 231
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
April 19, 2024, 05:01:27 AM
#22
The answer to this thing simple if country change everything go change, good government better living.

Make I give you wetin dey ground, how you wan save if you go buy fuell 5000 per day -costly price of fuel, feed yourself and family 3 square meals with the costly price of good and services, pay other miscellaneous with the value of Naira.

If you check am wella everything  dey attached to country and government, go out most people dey live on debt currently without a means weybi sey dem go pay back dem just dey hope sey everything go get better over the time,so na that kind of people go get savings?. Na wetin me I think be dis ,if we get good governance everything go dry okay then people go think about saving

My brother, you don talk am finish, make we reason am, how person go think to dey save for which country? For this country wey be price of things just dey go higher, no be say na betterment of the country dey go higher o but na suffer dey go higher, as e be say dey know say people no fit do without goods and services na e mk dey just dey carry us dey do anyhow, any time dey like dey increase price of things knowing fully well say no be everybody get better work or dey rich to settle their bills whether e cost o or no cost o, so na person wey chop well dey reason to save, as far as life dey person must surely eat and if you say you won save, na who won give food to chop, na still your savings you collect chop because hunger dey kill. So na person wey dey alive dey chop na go still save, beside bible talk am say there is time for everything.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
October 13, 2023, 09:42:12 AM
#21
With the facts of observations and my research, once u start dey hustle as an oyibo, u hustle on ur own and u owe no one responsibilities of bills bcuz every 1 dey ok &  contented with themselves without living to hope say anyone go take charge of their bills for them where family and relatives takes their financial responsibilities upon themselves.
I am sure this situation alone go allow person plan himself as him want.

Com to Africa, our 9ja in question, we dey papa house marry, bear kids and grand Pa takes all responsibilities.
How him want take establish or make increments in his income?

Pikin or person go dey in position of earning attractive amount of money, na so u go see responsibilities spreaded from the East, West, North and the South for u.
No just space for savings in order to establish and reach to a dream.
By this, I find out say responsibilities dey play a major role in our societies when we considers about forward ness.
Believe me, this na the legit. Everything way you cap here dey within the context of watin dey worry us and very valid at that.
Despite the fact say, we no get a very good or leveled foundation for success in we country, the load of responsibility way dey on top man Pikin head too plenty. In fact I believe say the poor get rest of mind via say, people dey just believe say them no get and cucuma leave them alone to face there wahala way no dey pass watin them go eat to pass the day.
Once e con be say you dey make small money way never even set you up, na there you go see responsibilities coming left, right front, back and center. No be just one man needs you dey carter for but, a generational need. That kind thing, e cast wella.

To escape this, one needs to make hard choices because. When you fail if you fail, them no go still recall the helping hand way you give them. Na the one way you no give and the one way you give other people aside from themselves go dey there head. Human being na just something else!
E Dey very important say make you grow yourself and help only with what you can leverage. No go dey over do yourself because, responsibilities no dey finish for the life.

Make them call you wicked even, accept am with pride and improve yourself, make watin people go talk or feel about you no stop you from the progress you got bring to yourself. When you archive, them go try associate and learn from you. This life, na per head!
sr. member
Activity: 476
Merit: 307
October 13, 2023, 08:34:28 AM
#20
This topic is a serious one that need more discussion because it could actually address many problems that a lot of Nigerians. It is no longer news that Nigeria is now the poverty headquarters of the world owing to failure in leadership. So, the reason why our there are no much progress both in the country and the lives of the citizens is failure of leadership in part and poor orientation of the citizens in the other vein. Of a truth, Nigerians are trying but most of our effort only amount to self sustenance struggles... we hardly think about making it big from the onset. Check farmers, traders and what have you; just to eat and stay alive is the main focus

This is a major problem that is partly responsible for the average life that is prevalent in Nigeria.
sr. member
Activity: 490
Merit: 346
Let love lead
October 12, 2023, 11:56:35 PM
#19
OP, you try well well for this your topic, one person no dey know everything and thats why topics dey up for discussion and contribution in this prestigious forum.

firstly, I support the notion say lack of structure don totally harm our country no be small and this na the thing wey dey make billing increase for people wey dey see small lavida for their hustle as compared to some more structured country. things like retirement plan for the aged wey dey take billling of old people off the shoulders off their children, and even elderly care homes that are sponsored by the government in advanced countries like US.
https://www.washingtonpost.com/us-policy/2021/04/02/caregiving-elderly-white-house-infrastructure/.

some public schools in structured countries provide totally free education for under-privileged children whom cannot afford to pay tuition fees and they are still standard and supervised. Unlike down here where free education will be proclaimed, and the students are left to pay exam fees and toiletries because the government does not provide these to the schools, and they are as good as abandoned to the mercy of some lazy teachers. These students are extorted until almost the same cost of fees are taken from their parents with sometimes little or no value added.

when it comes to hustle, the government wey dey structured countries dey create favorable policies to encourage startups and entrepreneurs to help boost the economy and encourage people with great ideas with the required boost in their endeavors. the UK government just increased their budget for that and targets more projects to benefit.   
https://www.gov.uk/government/news/40m-boost-for-cutting-edge-start-ups.
for our own country, na just to dey campaign loans up and down and still people no get access to it. the grants that are available na private individuals like Tony Elumelu dey give am and the thing no go fit reach person wey no go school hand cos na so many stages dey involved and the competition high. most of those loans na still them staffs dey collect am cos them know say them no go pay for am. If you start a business, na soso tax you go pay fear life with little or no support from the government.

As for the hustle part, them Oyinbo them no dey hustle pass us, them just get favorable environment for the hustle pass us. like their own hustle dey fall on loamy soil, while our own dey fall for rocky ground. you go see for yourself as the government don make their matter stew small come comot most billing for their head, them go dey more focused to dey hustle dey bring better Ideas to dey make more money with free mind. No be like us wey you go want concentrate do better thing, na then calls go come from home say one problem or the other dey, you go come leave wetin you dey focus on come begin solve family own first before falling back to yours.
sr. member
Activity: 420
Merit: 253
October 12, 2023, 05:01:52 PM
#18
[quote author=Sim_card link=topic=5467611.msg62951263#msg62951263
Oyibo don make everything easy for their citizens by structuring their country so that no matter the population wey them get, government go fit still dey capable to take care of majority of her citizens. For here out government fail to plan for their citizens, buy instead them dey after themselves alone, which make things dey hard because and no jobs wey go fit make people to fit depend on themselves. Secondly, na we be the problem to ourselves, because if you know say your family background dey poor and everyone dey rely on you, you go know the kind of life to live with the economy situation. Wetin I mean be say know the kind friends wey you dey keep, make e no be the friends wey dey like flex all the time, if not them go make you dey spend too much. Then when it comes to your family, attend to the important problem and leave the rest because, even though you be billionaire, you no go fit solve all your family problem finish as more problems to dey come.
[/quote]

Yes you're right, not only our government but some of our parents follow for people wey dey this category of earning without progress. For oyibo land, when I child graduate from school, their parents either open business or company for them to manage and fetch money for themselves but here in our country, most especially all these our big men will not allow their children to do anything at all they will provide everything their children require without teaching them how to make money as well that's why when most of this big men dies, their business crumble because their children has no idea of how to manage their businesses, some of the children might even sell of their parents properties because they don't know the worth and value before you know it they start suffering during the long run.

Another factor is hoarding knowledge, this one our people are very good at hiding their knowledge from others instead spreading their knowledge across they hide it and when they die, they die with their knowledge without transferring it to another person.
sr. member
Activity: 182
Merit: 120
October 05, 2023, 02:32:32 PM
#17
Sometimes sef family planing dey sef oh but e get wetin follow for this your matter ohh, you dey use oyibo man as reference and you don forget say naija dey different from those side. Due to how the country economy dey. Why family man go work from morning till night and no quality pay, na why anybody wey dey depend on only monthly salary dey find am very difficult to survive for this hard time. When salary come only feeding don finish salary, check the price of bag of rice for market now na 50,000, one liter of fuel na #600 something wey people be dey buy #80 before. But things no cost for that side like naija
One thing I observe for naija anyhow you earn big monthly if you no get wetin to support your salary your money go still finish. Just like wetin you talk papa/mama in need, brothers/sisters in need, I no blame them ohh. And I don see situation wey papa, mama, brother, sister no disturb but money still finish because of the poor economy. Na why empowerment good for society ooh. If at least some few people fit get empowerment or acquire different skills that one go better.
This your topic dey remind me of one meme say hard times no dey last forever but be like naija own come with power bank, and that's just the truth.
hero member
Activity: 560
Merit: 511
October 05, 2023, 01:57:31 PM
#16
Cuz I observe most of these oyibo(s) say them dey archive great thing's and living a comfortable life with lesser stresses unlike us for 9ja.
Then I observe say no be really by how much got paid or hard harder working but the caused of responsibility costs.
Oyibo don make everything easy for their citizens by structuring their country so that no matter the population wey them get, government go fit still dey capable to take care of majority of her citizens. For here out government fail to plan for their citizens, buy instead them dey after themselves alone, which make things dey hard because and no jobs wey go fit make people to fit depend on themselves. Secondly, na we be the problem to ourselves, because if you know say your family background dey poor and everyone dey rely on you, you go know the kind of life to live with the economy situation. Wetin I mean be say know the kind friends wey you dey keep, make e no be the friends wey dey like flex all the time, if not them go make you dey spend too much. Then when it comes to your family, attend to the important problem and leave the rest because, even though you be billionaire, you no go fit solve all your family problem finish as more problems to dey come.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
October 05, 2023, 12:54:02 PM
#15
Na for this our country I know sae problem no d finish. No matter how you make money for the country reach, naso different kinds of problems go d arise come your side from different areas like family, friends and well wishes, and no how you go escape am. Em go come be like sae the money wey d collect no d reach you anywhere because so many bills d come your side wey suppose get fixed.

This earning of a thing without progress for our country makes me to remember year's back wey peso d earn a little as a salary for where em d work. Then peso d earn like 30k as salary and na from that em 30k salary, em transportation for work d, feeding also, call card, cream and soap d inside am. Peso go still d manage em life with 30k till d next month wey dem go pay peso another salary.

As God may have it, peso situation come change financially. Could you believe that peso no fit manage 30k in a week again. Na soso different family problem and what to fix and buy for house d come peso way on a reg. Em go d like sae d money wey peso d get again no d dey enough for am again. Peso need mega money wey go make peso family matter disappear for life(that's impossible cos problems no d finish).

Wetin I wan talk in essence be sae, the money wey you make for this country can never be enough for you to know you d make progress or not. The more money you make, the more responsibilities d come your way. You no go ever run am from am, no matter how you try, unless you japa leave the country. Your japa no mean sae you no go d drop give your family in year's to come.

The idea to way wey I go suggest in this situation be sae, make peso no go blow em trumpet sae you don make am financially cos d moment you do, you don invite family and friend bills come your side. So em better to act poor while you invest codely without their knowledge
full member
Activity: 952
Merit: 232
October 05, 2023, 11:53:59 AM
#14
I don dey, wonders how many of us dey realize attractive amounts of money(payment) either on daily, week or monthly basis but yet enough to establish our lives (dreams).
E com be like say we no dey hustle or do our best to reach the hills yet.

I com ask myself say... Oyibo people dey hustle pass us? Abi na our money way no get value dey cuz us the unforward ness?
Cuz I observe most of these oyibo(s) say them dey archive great thing's and living a comfortable life with lesser stresses unlike us for 9ja.
Then I observe say no be really by how much got paid or hard harder working but the caused of responsibility costs.

With the facts of observations and my research, once u start dey hustle as an oyibo, u hustle on ur own and u owe no one responsibilities of bills bcuz every 1 dey ok &  contented with themselves without living to hope say anyone go take charge of their bills for them where family and relatives takes their financial responsibilities upon themselves.
I am sure this situation alone go allow person plan himself as him want.

Com to Africa, our 9ja in question, we dey papa house marry, bear kids and grand Pa takes all responsibilities.
How him want take establish or make increments in his income?

Pikin or person go dey in position of earning attractive amount of money, na so u go see responsibilities spreaded from the East, West, North and the South for u.
No just space for savings in order to establish and reach to a dream.
By this, I find out say responsibilities dey play a major role in our societies when we considers about forward ness.

Imagine this>>>
Papa/mama in need, brothers/sisters in need, uncle's/aunty's in need, cousins in need, nephews/nieces in need,  relationship in need, friends in need other relatives and unknown are in need.
With this situation, how him want take plan himself?
The possibilities of the way forward to progression here would be extremely challenging unless you have to Play an ignorant across but is getting ignored a solution?
Of course not but calling upon them when you learns about any means to empowerment, do get them empowered for stress eases else it lingers as long na 9ja we dey but otherwise u owe no  one nothing.

We can also minimize responsibilities by :
*Having a child's plan before putting to birth such as your readiness to have a child (s) and number of childs better fits for you to take care of.
*Elimination of unnecessary friends and relationships
*Delegate action(s) to others
*Avoidance of of unredeemable promises and
*Conciousness of liabilities
*Ability to withstand pleasures.

This one na obvious truth. The extended family system wey we dey practice for Nigeria dey make money no dey for person hand. So many responsibilities from both immediate family members and distant relatives.  Once you no meet up, they tag you 'stingy uncle'.

E no good make person dey in competition with anybody. We do things to impress people. Spend money on things wey we no need. Throw loud party with plenty people to feed and entertain. Oyibo people no do any magic, they spend wisely and na why dem no dey stress themselves. And na this wise spending dey make dem get savings to use do investments.

For this our country,  we no get better savings culture. We dey operate around wetin oyibo call " vicious cycle of poverty ". Everyday expenses,  little or no savings and little or no investments. How we wan take progress with this kind of lifestyle?
The truth be say we too Sabi do pass ourselves many of the times, that na why we dey always dey broke or sad because of expenses or bills wey full ground to settle.
That's poverty mindset. Na still people wey no sweat make money or just hit small racket, dey always make the loudest noise just to pepper them neighbors.

The saving culture no need too much noise, na low key life. Then anything wey don reach the level of us to get am, go just come because we get the money saved up or DCAd up.

Progress in finance entails money discipline. Spend on what is needed not what is wanted. Don't compare yourself with others also and just do you.
 You go see progress tire.
hero member
Activity: 1134
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
October 05, 2023, 11:10:01 AM
#13
I don dey, wonders how many of us dey realize attractive amounts of money(payment) either on daily, week or monthly basis but yet enough to establish our lives (dreams).
E com be like say we no dey hustle or do our best to reach the hills yet.

I com ask myself say... Oyibo people dey hustle pass us? Abi na our money way no get value dey cuz us the unforward ness?
Cuz I observe most of these oyibo(s) say them dey archive great thing's and living a comfortable life with lesser stresses unlike us for 9ja.
Then I observe say no be really by how much got paid or hard harder working but the caused of responsibility costs.

With the facts of observations and my research, once u start dey hustle as an oyibo, u hustle on ur own and u owe no one responsibilities of bills bcuz every 1 dey ok &  contented with themselves without living to hope say anyone go take charge of their bills for them where family and relatives takes their financial responsibilities upon themselves.
I am sure this situation alone go allow person plan himself as him want.

Com to Africa, our 9ja in question, we dey papa house marry, bear kids and grand Pa takes all responsibilities.
How him want take establish or make increments in his income?

Pikin or person go dey in position of earning attractive amount of money, na so u go see responsibilities spreaded from the East, West, North and the South for u.
No just space for savings in order to establish and reach to a dream.
By this, I find out say responsibilities dey play a major role in our societies when we considers about forward ness.

Imagine this>>>
Papa/mama in need, brothers/sisters in need, uncle's/aunty's in need, cousins in need, nephews/nieces in need,  relationship in need, friends in need other relatives and unknown are in need.
With this situation, how him want take plan himself?
The possibilities of the way forward to progression here would be extremely challenging unless you have to Play an ignorant across but is getting ignored a solution?
Of course not but calling upon them when you learns about any means to empowerment, do get them empowered for stress eases else it lingers as long na 9ja we dey but otherwise u owe no  one nothing.

We can also minimize responsibilities by :
*Having a child's plan before putting to birth such as your readiness to have a child (s) and number of childs better fits for you to take care of.
*Elimination of unnecessary friends and relationships
*Delegate action(s) to others
*Avoidance of of unredeemable promises and
*Conciousness of liabilities
*Ability to withstand pleasures.

This one na obvious truth. The extended family system wey we dey practice for Nigeria dey make money no dey for person hand. So many responsibilities from both immediate family members and distant relatives.  Once you no meet up, they tag you 'stingy uncle'.

E no good make person dey in competition with anybody. We do things to impress people. Spend money on things wey we no need. Throw loud party with plenty people to feed and entertain. Oyibo people no do any magic, they spend wisely and na why dem no dey stress themselves. And na this wise spending dey make dem get savings to use do investments.

For this our country,  we no get better savings culture. We dey operate around wetin oyibo call " vicious cycle of poverty ". Everyday expenses,  little or no savings and little or no investments. How we wan take progress with this kind of lifestyle?
sr. member
Activity: 462
Merit: 355
The great city of God 🔥
October 05, 2023, 05:21:21 AM
#12
Nothing chop money reach family problem. Another thing
too na spiritual problem. But the most common Naija problem, na inherited poverty. See as e dey carry start, you go Hustle make your papa dey proud of you, for the train him train you. By then your father no get business and him don dey old and him dey rely on you, because him don train you and deserve to be taking care of.

Now you don become the bread Winner and you never stand. You dey plan make you arange your life your family and relatives go dey worry you and the economy no dey friendly. Even your fiancy dey expect from you and naso time dey go.

Later you come Mary say make you no dey think family and old age dey come. When you Mary you go born responsibilities go compile again that is now
FATHER+MOTHER+WIFE+YOU+CHILDREN if you are not careful what happens to your father will also visit you. Taking Cate of everybody becomes a problem children start another journey afresh without holding from what there father left.
hero member
Activity: 966
Merit: 620
October 05, 2023, 04:28:23 AM
#11
 So many factors dey behind why we dey earn and not progressing. @CryptoprenuerBrainboss don mention say economy folo put hand for the reasons person no fit look back point the valuable thing him use money do.
Another thing be say some get the belief say to get more money, you have to spend but den, nah the wrong means them dey use get am, and where I dey drive go? Gambling! Some individuals nah chronic gamblers and you no say everywhere dey red; family dey bill and on top that them get that unhealthy habit them no go fit save.
 Another factor wey I feel dey affect our progress nah say we dey put our efforts in the wrong venture. Small change fit come out and them go feel say nah patience for pay, but time and effort go dey go.
sr. member
Activity: 420
Merit: 253
October 05, 2023, 03:08:45 AM
#10
To be the reason why we don't progress even when we're earning more is just basically some of our mentality of not lifting others. Imagine were you're the only big man in your family and maybe you have brothers and sisters, relatives and well wishers who are looking to you instead of you to "teach them how to fish you will prefer to give them the fish".

It is very sad how majority of us that are successful don't want to carry others along with the mentality that if you do that they might be better than you tomorrow. The reason why the westerners are more successful than us is because they don't hide their knowledge they make sure that what they know the next person also knows it. Imagine were everyone is doing what you do and you all are successful, who is gonna worry who? No body but instead of impacting what we know to the next person we will prefer to be like Oba (king) to them. We want everyone to always come to us for financial help. And as you keep helping people financially that is how your financial power is reducing but if people know what you know the financial burden will reduce and everyone will take care of themselves thereby giving to liberty to invest on more important things that will aid your growth.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
September 24, 2023, 11:29:51 AM
#9
Baba dis your write up dey biased, you no do any research and na purely assumptions. You just dey generalize di word oyibo, e get some oyibo countries wey Nigeria suppose beta pass if no be bad leadership and no be all oyibo as you dey claim na him things gel for them. So you for try dey specific and mention di countries, even for UK e get some english citizens wey dey homeless, so no think am say e dey rosy for everybody.

We get our challenges as a nation and just as BrainBoss talk, di structure of our country no good. Di rich people no want rub showers with di poor and dem come up with policies wey dey favour dem. Even if you dey earn beta money at di end of di day, nothing go dey to show for because family mata like bills and responsibilities. No be only one family, your own family, your wife family, your papa family, so di load dey to much for some people.
sr. member
Activity: 504
Merit: 254
September 24, 2023, 01:43:14 AM
#8
The answer to this thing simple if country change everything go change, good government better living.

Make I give you wetin dey ground, how you wan save if you go buy fuell 5000 per day -costly price of fuel, feed yourself and family 3 square meals with the costly price of good and services, pay other miscellaneous with the value of Naira.

If you check am wella everything  dey attached to country and government, go out most people dey live on debt currently without a means weybi sey dem go pay back dem just dey hope sey everything go get better over the time,so na that kind of people go get savings?. Na wetin me I think be dis ,if we get good governance everything go dry okay then people go think about saving
The government na the source of the whole scenarios oh but at times too na we dey say make we no hope in the government again bcuz na failed government. So na to fold hands make we perish be the only option? Of course not. Make we dey entrepreneuly creative to other means of finance after all we get the required abilities to create wealths by ourselves. The government is clearly seemed to be a doomed.
The overloaded responsibilities on 1 man is a set back to him success. Make we help ourselves and while considering our sources.
sr. member
Activity: 504
Merit: 254
September 24, 2023, 01:27:00 AM
#7
I don dey, wonders how many of us dey realize attractive amounts of money(payment) either on daily, week or monthly basis but yet enough to establish our lives (dreams).
E com be like say we no dey hustle or do our best to reach the hills yet.

To summarized the whole thing ehh, why we dey earn and yet no dey progress all come down to how the the country is structured because when things no dey well arranged, e no matter how you plan reach but you no go dey go forward and that's why people dey japa commot for the country because the majority no fit make am here as the battle ground isn't been fair and only those that has the advantage progress. People wey dun go away say immediately you leave the country, e go belike half of your problem are solved because away, dey plan everything for the country in a way if you hustle, e no go hard you to make am. Check out some kind country, loans are accessable but for Nigeria, you need know person wey know person or get ready to put down something wey worth pass dat loan wey you want by far before you go fit get better money to start business to hustle to make am.

Quote
With the facts of observations and my research, once u start dey hustle as an oyibo, u hustle on ur own and u owe no one responsibilities of bills bcuz every 1 dey ok &  contented with themselves without living to hope say anyone go take charge of their bills for them where family and relatives takes their financial responsibilities upon themselves.
I am sure this situation alone go allow person plan himself as him want.

You no too get this research well because even say those people dey more educated then us, dem plenty wey get families wey be say dem dey carry family problems put for person wey dun dey get small bread especially the bank America. Abi you never watch documentary wey be say one man go dey work multiple jobs to dey take care of him family. Wetin important here na one thing which is planning but e come hard for your plans to work as for this country, everybody just dey do as dem like and when you come plan, the structure for this country doesn't encourage getting out of poverty as everything here just dey anyhow. If the country was structured fine, as you hustle you supposed commot for poverty but you fit hustle all your life and at the end dem no pay you your pension wey you fit use arrange business for yourself when you retire. For here as you dey retire, you need dey find another hustle wey you go do or you're on your own with no source of money for you to live well.
Ok. My no argue but to raise my points of view. Sir eehh.... U know say some of us dey get opportunities to success but we dey lost dem by unseriousness or by lack of planing strategies? Na equivalent to my point here where someone go dey overloaded with necessary & unnecessary responsibilities.

Even if da oyibo man for the documentary u talk about, him responsibilities as a big earner even dey few.
Imagine me way no get shishi like this, papa, mama, families, relatives and friends dey look up on me for financial resolutions so... If a dime comes to me, instead of a minimum responsibility way supposed give me breathing planning, I go just returning back to my extravagant responsibilities.

I go rest my case by saying.... Responding to an extravagant responsibilities in 9ja don bcom a necessity inheritance. E just be like u carry overload for back struggling to Waka while oyibo people responsibilities dey minimal but all the same, I stil point at the "economy" & "government" way no send for the masses bcos if e beta 4 all, no 1 go look upon others for assistance on what u fit do for urself.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
September 23, 2023, 05:30:14 PM
#6
Don't blame the family,  blame the government,  we have bad structure and nothing can be build on that structure,  even if you try as an individual to fixed your life,  your efforts will just be like a drop in an ocean it won't work,  since the system is bad,  first before anything can work,  we have to make it works and before we can make it work,  we need to have a working system.

But in Nigeria today,  the leaders have failed losed focus and that have pushed Nigerians to the limit where survival is now a great deal,  that is why we have high level of crimes and other activities just to meet up with demands by illegal means, when we talk about dependency on a family member, is not only in Nigeria that we have such communal living, in other societies like in the Indian their also leave in such settings. 
sr. member
Activity: 476
Merit: 299
Learning never stops!
September 23, 2023, 04:47:59 PM
#5
The answer to this thing simple if country change everything go change, good government better living.

Make I give you wetin dey ground, how you wan save if you go buy fuell 5000 per day -costly price of fuel, feed yourself and family 3 square meals with the costly price of good and services, pay other miscellaneous with the value of Naira.

If you check am wella everything  dey attached to country and government, go out most people dey live on debt currently without a means weybi sey dem go pay back dem just dey hope sey everything go get better over the time,so na that kind of people go get savings?. Na wetin me I think be dis ,if we get good governance everything go dry okay then people go think about saving
sr. member
Activity: 476
Merit: 276
September 23, 2023, 04:23:43 PM
#4
The reason why e they like that be say our obodo Nigeria no they like obodo oyibo way be say when you done come of age u no go they stay with your parents u go go hustle to build your own home but our obodo Nigeria na place way be say if u they try to they meet up small small na that time way family go carry all there shoulder put for your head so as u they struggle na so bills they suck am so na waiting make e come be like say some people they hustle but e come be like say nothing they come out.
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino
September 23, 2023, 08:31:49 AM
#3

With the facts of observations and my research, once u start dey hustle as an oyibo, u hustle on ur own and u owe no one responsibilities of bills bcuz every 1 dey ok &  contented with themselves without living to hope say anyone go take charge of their bills for them where family and relatives takes their financial responsibilities upon themselves.
I am sure this situation alone go allow person plan himself as him want.


This na part of the issue. The things wey no dey work out so na because of the way the country dey structured and Africa at large. Nigeria get a dependent family system and na that one be the thing. For oyibo land, the government plan certain support system for young and old and infact most people dey get different types of sustainable benefit from government, I know no how many of us here dey get something from government. Na every family by its own.

Solution na make the person wey don rise for the family try to establish others so that them no go continue climbing on his shoulder because if that shoulder go dislocate, the family don go back to square one and that one no good, make person dey chop on top table and later shift enter for floor no good. So apart from say government no dey try, we self go try support people in the family to grow no be to dey give them fish but to teach them how to fish.
Pages:
Jump to: