E com be like say we no dey hustle or do our best to reach the hills yet.
To summarized the whole thing ehh, why we dey earn and yet no dey progress all come down to how the the country is structured because when things no dey well arranged, e no matter how you plan reach but you no go dey go forward and that's why people dey japa commot for the country because the majority no fit make am here as the battle ground isn't been fair and only those that has the advantage progress. People wey dun go away say immediately you leave the country, e go belike half of your problem are solved because away, dey plan everything for the country in a way if you hustle, e no go hard you to make am. Check out some kind country, loans are accessable but for Nigeria, you need know person wey know person or get ready to put down something wey worth pass dat loan wey you want by far before you go fit get better money to start business to hustle to make am.
I am sure this situation alone go allow person plan himself as him want.
You no too get this research well because even say those people dey more educated then us, dem plenty wey get families wey be say dem dey carry family problems put for person wey dun dey get small bread especially the bank America. Abi you never watch documentary wey be say one man go dey work multiple jobs to dey take care of him family. Wetin important here na one thing which is planning but e come hard for your plans to work as for this country, everybody just dey do as dem like and when you come plan, the structure for this country doesn't encourage getting out of poverty as everything here just dey anyhow. If the country was structured fine, as you hustle you supposed commot for poverty but you fit hustle all your life and at the end dem no pay you your pension wey you fit use arrange business for yourself when you retire. For here as you dey retire, you need dey find another hustle wey you go do or you're on your own with no source of money for you to live well.