Some of us dun really experience wetin e mean to dey poor and hopeless, na why we nor dey carry bitcoin play because e dey give us hope say tomorrow go better. Before some of us wey come from really poor background dey always reason how tomorrow go better because we know say our family dey depend on us and we nor get any serious inheritance wey dem leave for us, and our families even suffer to carry us pass school, money nor even dey for dem to give us to start business, life hard been hard well well and we nor get hope on how tomorrow go be because we know say e nor easy to just get investment wey fit give person money tomorrow for this our country wey things hard, and oportunity nor dey avaialable for everyone.
Op na true you talk if person no the benefits where bitcoin done help people for this life you no go stop dey invest on it, but how our country dey like this money no dey many people dey find money dey use am dey feed him family for house economy dey hard nothing cheap for the country now again everything just dey increase price everyday, see how dollar just dey raise everyday our naira no even get value, na our leaders they make things hard for this country dey no want make the country better, many people no about bitcoin but no money to invest for long term and some others no fit dey patient for long term to get the huge profit, because the country hard dey are finding want dey go eat for house, and with the hardships where dey for the country poor people no fit dey think about investment because even waiting to eat dey hard them for the country, na people were get money dey do investment weller and na them he dey favour very well because dey get the capital to start, and how the economy dey now dey make some people dey do waiting know good to just get money and feed them self and family.
Bitcoin changed everything ooo, Bitcoin give us hope say tomorrow fit better, bitcoin give us opportunity to fit dey invest the small small money we dey get into bitcoin to fit make more tomorrow. Bitcoin give us hope for this our tight country.
Bitcoin investment change many people life because they have interest and trust on it that they will successful with it, if no be say Bitcoin investment dey many people no go no where dey dey now, how our country dey like this where job opportunities no dey because this our country if you no get long hand dey know go employ you for work corruption done full everywhere, if no be say Bitcoin investment dey and other restate like land investment where people dey put there money and make profit he for no better for us for this our naija, because people no dey depends on government work again na business where go bring money everyone dey find now, and doing some investment that will double their income, because if no be investment person go dey do for this our country were hard like this you no fit get any place where you go dey get better money, and scammers done full everywhere you go dey see many platforms where go tell you make you invest 10k you go dey get 5k daily without doing anything for them, but because of the economy dey bad some people go try invest in 4 to 5 days dey go crash many people dey fall in scammers because money no dey the country, dey go dey deserve person make them invest for them site and later on dey run with your money, if no be say we get they do transaction through P2P dey get buy coin since our government no like crypto we for dey in bad mood in this country na God go bless satoshi where bring Bitcoin investment because he make many people that are poor become rich now and he go dey continue dey changes things for us.