The only time wey I go d happy of this judgment of old naira notes, na when the supreme court go questioned the FG and CBN governor seriously on why they go allow Nigerians suffer and pass through hell because of this old and new naira notes notes.
CBN still dey win oh from the update wey I hear. I hear say the CBN been anticipate all this fight back and that's why them make am mandatory say we return all the money to banks and them dun take am out of circulation so even though dem allow old note, e no go dey everyway as e been dey before, we go still get cash shortage so at the end of the day, their cashless policy go still dey functional. Na who hold old note when everybody been dey para na him benefit pass. So af the end of the day the moral lesson na say make we dey hold lol.
Even after the update form supreme court and CBN, Nigerians still dey overdo their own as dem no dey accept the old note. See news wey dey reach my ear so;
Fuel stations, others reject old notes, banks ration cashThe fresh move by some Deposit Money Banks to re-circulate old N500 and N1,000 notes suffered a setback on Tuesday as motorists, fuel stations, retailers, traders, and other categories of bank customers rejected the old currencies.
The development came about 48 hours after some commercial banks, particularly Guaranty Trust Bank Plc, Zenith Bank Plc and Sterling Bank, began the disbursements of the controversial N500 and N1,000 notes across their branches in major Nigerian cities. Commercial banks’ decision to re-circulate the old notes followed last week’s Supreme Court order approving the use of old N1,000 and N500 and N200 notes as legal tender for 10 months. The Supreme Court had last Friday ordered that the old naira notes should be allowed in circulation along with the new notes until December 31, 2023.
Source:
https://punchng.com/fuel-stations-others-reject-old-notes-banks-ration-cash/?ampWell I no blame them because who wan lose na, what if the CBN just change mouth that means all those wey get old note go get small comman as dem go either dey wait for line to deposit their money for banks or lose am totally. Sha I believe everything go return to normal after some weeks wey people dun sure say true true the old note dun dey circulate again and e dey okay to accept am. Nigeria no go kill person.