Good day my country people, compliment of the season. I carry one ogbonga advise come board today to share with my fellow bitcoiners. Normally we know how things hard generally no be only for our country but na for everywhere, and to even see food chop sef na by the grace of God. But I still gat advise say make we no fail to remember or forget say next year na the halving event go take place, and based on history the halving dey prove to boost the price of bitcoin,
Dis advise wey u carry come na better one ooo, we all know say things no funny for dis country now, to even eat once in a day dey hard some people, but if you get opportunity wey u dey get money, make sure say no be all you dey use chop finish, even if na small make u dey try invest in bitcoin, no be till you don get money wey u go use buy one bitcoin before you go talk say u go invest in bitcoin, even if na small small amount you fit dey invest, na still something. After halving now we dey expect make bull run happen, halving na next year, but nobody sabi when bull run go start, but we dey expect say after halving, bull run fit start any moment.
and the sweet part na be say even for those wey dem just like to do trading and not long term holding, the halving still dey bless dem.
If you be trader, you go enjoy bull run ooo, because market go dey move well that time, but if you be trader, e no go still bad if u fit hold even if na small bitcoin, just buy that one ignore am for your wallet, na still nice idea, it won’t stop you from trading.
Also as we dey hold for this period make we no let the happiness of the season allow us to loose focus to sell our precious coin any how oo, and make we no still keep our private key any how, because if you keep am anyhow or you fail to backup your coins go loss for good.
No be to buy bitcoin alone, we suppose try secure our bitcoin well, if bull run start now scammers go dey look for possible ways to steal from us, they will be coming up with different format to steal from us, na y we suppose dey careful and smart be that. Make we make sure say we properly back up our private key, and make we make sure say we no leave am online, and if we dey back am up for offline, make sure say na plenty places we go keep am incase if one lost, others go still dey.