2. Obari [12]
3. Hyphen(-) [11]
*Brainboss excluded
Well done Igehhh, I no know wetin you change your name to (that one concern you lol). Well big congratulations (more change of name to come lol) okay joke apart I think na top 3 we dey usually reward that's 5, 3 and 2 respectfully so the users supposed be 3 not 4. I dey out of merit now but immediately I get some (like 10) I go do the needful and update here when done.
Even though we dun get our board, the reward no go stop since enough merit no dey around to the merit normal posts at this time. Na only thread I dey focus on so the monthly reward go belike a way to encourage users to dey active on the board.
How you see to put something wey go indicate say monthly merit reward dey go on, on the title of the thread so people go easily see am and put effort into getting shot at winning. Something like [CHARTS] Monthly Overview Of Nigeria Local Board📈 - Monthly merit reward. By God grace if theymos approved new merit source for this board or upgrade my allocation the rewards will be increased as well. Well done as always.
@igebotz chairman I dey really appreciate the work you dey do here and I don really see am say e no easy at all with all of this codes and charts and I pray you reap your rewards bountifully.
Amen.
@brainboss, you na chairman wey everybody all know for the forum and you dey always top chart and yet you no dey receive any reward but still dey give out reward, I'm sure God will never fail you, Amen.
I wan say very big thank you to all my Naija people wey dey the forum because by now we suppose know say e no easy especially for persons like myself wey no dey good with writing but we no dey relent Sha and I want plead say make we try our best to bring out the best in us to this board because na here be our village for the community.
I no even expect say my name go dey for last month of December because since this year na from one problem to another and currently now I dey under treatment and I pray for speedy recovery too.
I love you all and I hope to see we all at the top.
~OBARI.