Pages:
Author

Topic: Continue to accumulate Bitcoin, till bull run or take break and enjoy Christmas - page 2. (Read 236 times)

sr. member
Activity: 266
Merit: 276
As you talk am like this e sweet me well. But the problem wey they be say no better money wey they for hand now to use buy bitcoin. And the price of bitcoin done high, the value of dollars to naira too theu high. If i get 100k like this nah about 80$ of btc ah fit buy and if you check am e no much. Especially for those person wey just start to buy bitcoin, e no go they so easy for them this period. But if we look wel inside wetin you talk, e get this assurance wey you they show say bitcoin go do well next year so we no gat reason the current price whether e big or small. If not we fit no come buy am then later we go come de regret.

As OP, done talk am. Make we reason the thing, even if na small make we buy am. We no go regret at all, as long as we dey hold am till next year ending.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
Brother you know say a typical Nigerian wey we be, we no go fit forgo enjoyment season just like that, and besides if you don dy accumulate btc since January through the DCA method, den you have nothing to worry about, because in as much as we fit recover money, we no go fit recover time, so for me,  even though I know say I go still allocate some of my salary to get more Bitcoin, I already get budget plan of how I spend money monthly, I no go alter that DCA money, but I go do some changes to some, to create more room for the celebration.I no go forget Christmas celebration because you no go fit recover time back, but all in all, I go spend wisely.

My brother you don talk well, na the best answer wey dey for this kind of question be this. First of all Bitcoin holding and accumulation na to use am take do something for your life, no be say we just dey accumulate blindly when our holding nor get purpose, person wey don dey accumulate for long wey don dey into the system supposed know how em go take package this seasonal celebration wey no go affect em holding. The ideas of using DCA na because of make your Bitcoin accumulation no affect your normal sending, and aside Bitcoin holding person supposed to get savings wey e go take they package himself.

But person wey never dey into the system for long, make e nor go carry all em investment take chop Christmas oo,
full member
Activity: 196
Merit: 123
December, na special month wey many people de do expenses pass, because of Christmas and new year celebrations wey de for di month. Na time wey many people de travel pass to go visit loved ones for village and other states. Na time to buy new clothes, shoes and other beautiful things to take celebrate di season. Abi na for food matter, di celebration no go complete without falling live chicken and buying drinks and oda delicacies. All these things dem wey I mention so na plenty money to take purchase dem, plus say them prices go increase because of the festive season.

I come de reason say as halving be next year and after dat we de expect di highest ATH, and di advice for people wey know wetin de for crypto space be say make dem no slack to de accumulate and hold Bitcoin, because di coming bull run no go get mate. We de expect say btc go pass $100k and many investors go make plenty profit.

Di matter now be say dis December, celebrations fit to affect our plans and we fit no meet the target of our planned btc accumulation before di bull run. So e go take great discipline to forgo di enjoyment of dis festive season with family and friends, and focus on the investment plan.

So how una reason am, for person wey don plan to de continue accumulating btc nonstop till bull run, weda im fit take break for December, enjoyment, or leave enjoyment and continue to de accumulate?
Brother you know say a typical Nigerian wey we be, we no go fit forgo enjoyment season just like that, and besides if you don dy accumulate btc since January through the DCA method, den you have nothing to worry about, because in as much as we fit recover money, we no go fit recover time, so for me,  even though I know say I go still allocate some of my salary to get more Bitcoin, I already get budget plan of how I spend money monthly, I no go alter that DCA money, but I go do some changes to some, to create more room for the celebration.I no go forget Christmas celebration because you no go fit recover time back, but all in all, I go spend wisely.
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!

Jump to: