Billionaire wey dun make money always talk say na boring investment dey give money pass but we dey claim like say we sabi pass them.
Them say that business wey you dey overlook so na him get better ROI pass because e go dey consistent in a long timr and na wetin dey for inside Bitcoin because dat. You fit dey go get dem X's wey you dey find but you no get guarantee say you go make profits but e sure for Bitcoin side. Wetin sure pass that kind update eh?
Make we no dey chase them 1000% increase come miss to make profits in general. Better go for wetin dey stable but sha you fit still risk small somewhere but make e be pure gamble.
Altcoins no be wetin you go put hopes for. People dey lose their life savings because them invest inside altcoins but you ko fit hear say person lose when e invest inside bitcoin and him just hodl not trying to outsmart the market or do anything like that.