No matter how technology or the Internet may seems to have some negative impact on humans, I still applaud the introduction of internet and technology because if no be dis things me and you for just dey waka like blind people wey no no where we dey go. Technology or rather the Internet don help human being in so many ways to solve human problems because sometimes I dey imagine weda this internet na witch or wizard wey e be say almost anything wey you tell am make him do for you in go do am.
Okay for example let's take the tracking reference you just gave, you no say the heart of man na evil and if no be for the internet and modern technology wey e be say if you commit crimes e get how Dem go take find you out you no no say human being for dey kill each other almost on daily basis because how you wan take no who kill person or how person carry die like for example as Dem dey perform autopsy for person wey don kpeme to know exactly wetin kill am, so all those technology na in dey put fear for people wey get bad motives for where there fellow human being dey so no how wey internet go dey bad wey e go pass the good wey dem dey do or wey dem don do already for human being.
I know say you day try make point about how easy the internet don bring to us and no doubt no body go wan deny the fact say our daily lives don improve because of the invention of the internet, but i still feel the same internet way you day praise still don cause harm to some, even with the internet crime still day go down on the steady, this same example way you give about autopsy and forensic analysis, you still know say innocent people fit still fall victim of some circumstances, in a case where person day innocent but due to ignorance or maybe being in a right place at the wrong time they come punish the person just because result say so person way commit crime go just day free day chop him life.
You don see say anything way get advantage must get disadvantage, the internet good but he also get him own disadvantage, the only thing way we go just need do na to try to keep clean so that you go fit get peace of mind rather than leaving in fear. These technologies are cute and all, it has made life more organized for all and but then can still be dangerous at the same time, make we sha do am for good.