No be even the price wey dey go up and down be my problem here the problem be say some people dey act like say person wey them know wey never invest in Bitcoin never start life unto say them don try abi wetin Bitcoin dey all about as them get the opportunity to join forum wey dey give them detailed information. Some of us here self fall under that category of people wey dey always talk to people about the importance of investing in Bitcoin but some of us dey find am very difficult to explain the other part say your money fit go if the market bloody and person wey no understand go wam kill em self because of lack of experience, I think we can do a proper advertisement for Bitcoin but we shouldn't act like it's a do or die affear cause not everyone can afford losing money for investment like some of us has lost before we understood the market very well.