Pages:
Author

Topic: [End] Post Quality Review [Monthly BTC Reward] - page 2. (Read 601 times)

hero member
Activity: 854
Merit: 1246
e make sense this way make we dey motivate the low ranking members, something i was also planing to implement on the other merit award competition, i hope everybody dey okay with my last comment on weytin i plan to do with the hangout mega thread?
Na so do thing supposed be, when I dey see anoda house piple dey give dia rewards di way dem want, I come dey think 4 we corner, how we dey take do am. As I luk am finish, we dey learn 4 dia corner. So things like dis go dey make dem 2 do quality post 4 we board.


Any policy wey go make the reward dey very quality are welcomed, nothing bad to ignore the hangout thread, I suppose lock that thread self but I just leave am since e dey do the job of hosting newly welcomed members and maybe dem fit dey read through the thread to see how we start and got to the promised land wey we dey so today. Any thread wey no make sense is also okay if you ignore them. We can't get rid of worthless thread entirely, and they're also needed to distinguish between the good and the bad.
Abeg no lock day thread because if u lock am everyone go carry dia head come here dey do gbegbeolo gbekolo, weti u too sef e no 2 bad but make those wet dey tok those worthless comments and threads also try to adjust, no be only dem be di newbies wet dey di forum.

Since you dun take the job, no wahala, I believe others believe you go run am without ojoro as you dey do the merit thread as well. As for the high ranked users I think only legendary should be removed, no commot reach hero as dem need the merits as well. Legendary fit do well on their own and no need merits self but we dey highlights their regular post since as we dey see them since quality deserve to be recognized but as for the monthly award, e goes well to comot d rank, atleast my name no go dey appear without receiving any reward again, lol.
E gud well well, an dis kind things we dey find. Me sef I fit run one programs for lower ranks but no bi now, make I still dey gada some strength so I go dey gidikpa. Santoprinces thanks u once again.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
e make sense this way make we dey motivate the low ranking members, something i was also planing to implement on the other merit award competition, i hope everybody dey okay with my last comment on weytin i plan to do with the hangout mega thread?

Any policy wey go make the reward dey very quality are welcomed, nothing bad to ignore the hangout thread, I suppose lock that thread self but I just leave am since e dey do the job of hosting newly welcomed members and maybe dem fit dey read through the thread to see how we start and got to the promised land wey we dey so today. Any thread wey no make sense is also okay if you ignore them. We can't get rid of worthless thread entirely, and they're also needed to distinguish between the good and the bad.

Since you dun take the job, no wahala, I believe others believe you go run am without ojoro as you dey do the merit thread as well. As for the high ranked users I think only legendary should be removed, no commot reach hero as dem need the merits as well. Legendary fit do well on their own and no need merits self but we dey highlights their regular post since as we dey see them since quality deserve to be recognized but as for the monthly award, e goes well to comot d rank, atleast my name no go dey appear without receiving any reward again, lol.
full member
Activity: 798
Merit: 134
e make sense this way make we dey motivate the low ranking members, something i was also planing to implement on the other merit award competition, i hope everybody dey okay with my last comment on weytin i plan to do with the hangout mega thread?

My eyes  never even reached that side self so i no too get idea of wetin you talk there, but Thank God say our brother @Charle-Tim don quote am here so i believe say e make sense well well.
Self voluntary work no dey easy o but i believe as na you give yourself the task e no go too heavily you for body than the ones wey people carry give you to do without anything being attached to it. Keep it up big man! I dey fans your way of operations as oga botz wey we get here. lol.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
I will be grateful to use two hours of my time to scrape out data, do some manual cleaning, and ignore some threads, including the Hangout mega thread and others that will be made public.

i hope everybody dey okay with my last comment on weytin i plan to do with the hangout mega thread?

This is nice. I do not see anything more valuable on the hangout mega thread than introducing oneself and welcoming posts.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
However, op don already remove a higher rank members make e only come from newbies to member ranks.
You are making the past confusing as some people may think that SatoPrincess edited the OP and changed that, but she did not do anything like that.

https://ninjastic.space/topic/5448773

I think this would best be answered by SatoPrincess (or Igebotz) based on what they discussed, but I guess that it is Igebotz that did not know before that it is for member rank and below.

Yeah that's on me, i missed that part of the requirements on OP, nothing was edited its just me being a bot and skipping some part of the OP by default. Cool

e make sense this way make we dey motivate the low ranking members, something i was also planing to implement on the other merit award competition, i hope everybody dey okay with my last comment on weytin i plan to do with the hangout mega thread?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
However, op don already remove a higher rank members make e only come from newbies to member ranks.
You are making the past confusing as some people may think that SatoPrincess edited the OP and changed that, but she did not do anything like that.

https://ninjastic.space/topic/5448773

I think this would best be answered by SatoPrincess (or Igebotz) based on what they discussed, but I guess that it is Igebotz that did not know before that it is for member rank and below.
full member
Activity: 798
Merit: 134
Boss reason am with Igehbotz him do am although Charles-Tim too go handle well but Igehbotz good for that movement, make e no be say we don too give am work.

It must not be any of the two of them, I just used them as a point of reference, anybody wey SatoPrincess feel say go deliver fit run am even herself too (I just no wan make she put herself in a situation wey people go talk say, she just dey give herself the reward) that's why I suggest she use third party. Igehh self get him other technique to find quality posts and na key words, maybe another person for come with another technique and SatoPrincess use am as basic for her reward so nobi only one set of people go dey received the reward but still on the quality criteria. Dis campaign na SatoPrincess own so las las na she get final say, we go just dey add wisdom as the program dey go on.


Na true you talk boss, I believe you.



OP Pm'ed me earlier, and I accepted to run the show; I also suggested the techniques I would use, and she agreed. I will be grateful to use two hours of my time to scrape out data, do some manual cleaning, and ignore some threads, including the Hangout mega thread and others that will be made public. This is a good initiative, and it will only get better from here. Please no alts, I have great eyes, and it would only take me 2 minutes to fish out, and nobody is above DT penalty. I shall be omitting myself from the awards for the purpose of transparency.


Oya na case don close no issues i like as she already pick you by herself so that e go dey good make e no be say na the forum suggest whom to use.
Quote
This campaign na for member rank and below, I believe say anybody way fit achieve 100 merits na good poster, na the newbies we need to look till their leg strong

However, op don already remove a higher rank members make e only come from newbies to member ranks. Meaning say from Full members up no follow at all talk less of your wey be Legendary baba @Igehbotz, so the show nothing for us anyway but we go still strive to make good post and maintain the cleanliness of the board.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
I shall be omitting myself from the awards for the purpose of transparency.
To avoid confusion, I think the monthly reward are for member ranks or below?

must be member rank or below
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Boss reason am with Igehbotz him do am although Charles-Tim too go handle well but Igehbotz good for that movement, make e no be say we don too give am work.

It must not be any of the two of them, I just used them as a point of reference, anybody wey SatoPrincess feel say go deliver fit run am even herself too (I just no wan make she put herself in a situation wey people go talk say, she just dey give herself the reward) that's why I suggest she use third party. Igehh self get him other technique to find quality posts and na key words, maybe another person for come with another technique and SatoPrincess use am as basic for her reward so nobi only one set of people go dey received the reward but still on the quality criteria. Dis campaign na SatoPrincess own so las las na she get final say, we go just dey add wisdom as the program dey go on.

OP Pm'ed me earlier, and I accepted to run the show; I also suggested the techniques I would use, and she agreed. I will be grateful to use two hours of my time to scrape out data, do some manual cleaning, and ignore some threads, including the Hangout mega thread and others that will be made public. This is a good initiative, and it will only get better from here. Please no alts, I have great eyes, and it would only take me 2 minutes to fish out, and nobody is above DT penalty. I shall be omitting myself from the awards for the purpose of transparency.

__________________________+++++++++++++___________________________

Please check my personal text space there is a $50 lottery going down this weekend, hosted by JollyGood- sponsored by Igebotz management and Utopia Ecosystem. Cool
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Na beta yarnings be this. I dread the idea..make we see weda e go work, the kind topics wey dey the territory dey taya person some kain times but wetin man go do. At all at all na winch, as Brainboss tok na small small we go balance well. Time don reach wey our people way dey create those sweet topic for bitcoin discussion to dey carry am come here especially those one wey say them just open new business and them dey accept bitcoin as payment. Abeg next time try post am for our board, na we go still patronize your business if at all.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Boss reason am with Igehbotz him do am although Charles-Tim too go handle well but Igehbotz good for that movement, make e no be say we don too give am work.

It must not be any of the two of them, I just used them as a point of reference, anybody wey SatoPrincess feel say go deliver fit run am even herself too (I just no wan make she put herself in a situation wey people go talk say, she just dey give herself the reward) that's why I suggest she use third party. Igehh self get him other technique to find quality posts and na key words, maybe another person for come with another technique and SatoPrincess use am as basic for her reward so nobi only one set of people go dey received the reward but still on the quality criteria. Dis campaign na SatoPrincess own so las las na she get final say, we go just dey add wisdom as the program dey go on.

I see say you dun change some kind things like now the price dey in a fixed form. E make sense like dat so e no go worry you wan Bitcoin rise or fall. We dun dey enter very volatile times as either the market go pump or dump soonest. The title of thread still no make sense that much to me, I no be mean make you change all words with my last suggestions but make you just add this Monthly Bitcoin Reward so people know wetin dey sub. If you dey find title, how about something like this, SatoPrincess Quality Review [Monthly BTC Reward]. Na just suggestions, anything wey work for you dey okay but to attract people to know wetin dey sup for the thread, the title are perfect tools to use.
full member
Activity: 798
Merit: 134
NOTE
This campaign no be about highest number of post but na about quality, person way make 1 quality stand better chance than person way make 50 low quality posts. I go announce the winner for month end and give am e prize. This campaign go start from 1st May 2023 and go will continue for at least 3 months till I fund am again…..

First of all thank you for this initiative, edit topic add am 'monthly BTC reward'. Also I hope if Bitcoin over pump you no go reduced the BTC value wey you dun put so. Also I hope you no go forfeit any payments. All month started must be accounted for, if you know say you wan end am, update us at the end of the month before the new month start. No go do wetin go make people question your credibility and it results to red tagged abeg.

You no fit dey give the award they check the quality as well e fit dey biased, you can ask someone to do that for you and we get Charles or Igehh wey go help you since they can identify quality posters with ease, other senior members dey here too wey fit handle the quality checking although if the community dey okey with you reviewing and awarding no shaking. For your rules you no put no alts but you for add am because if you use your alts to come BTC and dem catch you na red tagged supposed reach your account.

Make we engage this campaign with good heart to help raise awareness of quality posts been awarded in both merit wise and BTC wise. If the three months end and people see the impact of the campaign, we fit push small BTC to help the ministry to continue. My eye dey the thread, and I go dey follow up as the months dey go bye, thank you for this.

Ps: No put giveaway oh for title, the forum dey against giveaways hosted on the forum, dem fit give you temporary ban if you try am.

Boss reason am with Igehbotz him do am although Charles-Tim too go handle well but Igehbotz good for that movement, make e no be say we don too give am work. Lastly I go also like to appreciate the princess to clean our board small so that we go get correct people for here wey be say if them talks about posters we go be number for the forum. And I really love the way we take dey spread everywhere just take a good look at whilewind we people dey there as well so na the results of quality posting.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
Have there been any bitcoin giveaway that you know of that led to temporary or permanent ban?
If you call am giveaway thread wey dey give out Bitcoin, then e suppose dey Games and Round, i no think say e dey allowed to run giveaway for any other section of the forum, but no be say e go lead to ban oh. Whilst Altcoin giveaways dey completely banned, and like you said, na wetin fit lead to temporary or permanent ban; person no fit pay people to post rubbish or anything wey no too make sense for their thread, but none of these is what SatoPrincess is doing.

Having said that, SatoPrincess you dey consider only posts wey the user make for local board, or you dey consider all the boards wey dey for forum? Mind you also say to select the best go always dey somewhat subjective, so e good to add for rules say na you or whoever go choose who be the best na im get the final say on that, and e no dey up for any debate/discussion/arguments.
full member
Activity: 770
Merit: 180
Eloncoin.org - Mars, here we come!
This is a very good and welcomed initiative and I believe say the funds go dey available to see am through as long as you seem fit. You fit even get sponsors wey like this idea, because e dey in tune with the idea of the Bitcoin talk forum in the first place.
This our Nigerian board need great quality post and so far just a handful of us dey really put in the best to keep us informed and motivated to do better.
Me self go like dey involved as long as na reward for quality service and a way to grow the quality of my content.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
You no fit dey give the award they check the quality as well e fit dey biased, you can ask someone to do that for you and we get Charles or Igehh wey go help you since they can identify quality posters with ease, other senior members dey here too wey fit handle the quality checking although if the community dey okey with you reviewing and awarding no shaking.
Igebotz will be the best for this, I only read few posts and there are some threads that I do not visit at all after just seeing the title alone, some are even having quality, but not that related to bitcoin and crypto and I may not visit. Igebotzis the best for this in my opinion.

I think and I will advice SatoPrincess to PM anyone or people he thinks can do the work if nobody respond to this.

Ps: No put giveaway oh for title, the forum dey against giveaways hosted on the forum, dem fit give you temporary ban if you try am.
Let us consider this my post to be off-topic.

According to the 15th rule, this forum is against altcoin giveaways

Quote
15. No on-forum altcoin giveaways. [6][e]

Have there been any bitcoin giveaway that you know of that led to temporary or permanent ban?
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Our boss "CryptopreneurBrainboss'' don talk am finish based on the initiative wey carry come for the forum so. Although the result wey we receive at the end of the first to third month go determine whether we go continue to the run am every month or not to support low rank members for making Bitcoin related post for this our forum.

In continuation of this your initiative(if it should continue), I go like make we add first, second and third position join. That must have been when the three months initiative wey you bring on don elapse. We go fit do am like first position to receive $15 worth of btc, second position $10 btc and lastly third position $5 btc. How una take see am? Na suggestion I bring so sha
hero member
Activity: 966
Merit: 701

First of all thank you for this initiative, edit topic add am 'monthly BTC reward'. Also I hope if Bitcoin over pump you no go reduced the BTC value wey you dun put so. Also I hope you no go forfeit any payments. All month started must be accounted for, if you know say you wan end am, update us at the end of the month before the new month start. No go do wetin go make people question your credibility and it results to red tagged abeg.
Thank you, base on the price way no dey stable I been reason to use usdt but I really want make e me bitcoins the prize go dey fixed, the best option now na to edit the OP to $15 btc/month.

E make sense make e be say another person dey hold the funds and give the reward. I dey hope say we fit get 2-3 persons way go gree take charge, one go hold the bitcoins, the other two go decide the best poster so that wayo no go dey.


You no fit dey give the award they check the quality as well e fit dey biased, you can ask someone to do that for you and we get Charles or Igehh wey go help you since they can identify quality posters with ease, other senior members dey here too wey fit handle the quality checking although if the community dey okey with you reviewing and awarding no shaking. For your rules you no put no alts but you for add am because if you use your alts to come BTC and dem catch you na red tagged supposed reach your account.

Thank you na true you talk. Na why I push am to next month so time go dey for everybody to talk their mouth cos one person no fit know everything finish. I go happy if Charles-Tim or Igebotz go fit accept to take this work, Igebotz na official spam buster and Charles-Tim na odugwu for anything bitcoin. I no add that rule cos I feel say I no go fit control or know the alt accounts. I go add am now.

Satoprincess this is a very good and a welcoming idea. Although It is not a normal campaign in the main board but it looks like a bounty campaign because the idea of the campaign just as the bounty type. There are some factors that I used to analyze the idea. Normal campaign payment is weekly while bounty campaign payment is monthly though I have not visited bounty section but I know that their campaigns pays monthly.
Thank you Agbe, this no be signature campaign or bounty abeg no mind the title. You no go compare paid promotions with this one na biko. As you know weekly reward no dey sustainable even if na 1 merit I won give, hopefully the low rank account way many of them never dey see campaign chopings go appreciate am. And na only post for local board go count. Na for users to dey post as them dey do on a normal day but make the quality dey better na wetin I dey talk.

 
snip
I been never see the thread before oo, them been don dey observe the account for plagiarism and ban evasion but evidence no really clear, this na lesson make everybody the kind thing them dey do, e go work for uche nor mean say you go work for you. The parable rhyme with the account name lol

snip
Good thing no dey hide, our board get some of the best posters for forum these people na once newbie..anybody way serious to improve himself go fit do am.

Thank you very much our Princess for this initiative. This step wey you take show say you get good intentions for our local board. This initiative no go only help to make our local board to be spam free but e go also help to encourage new members to dey post quality posts so that them go fit get the prize.
Thank you sokani for your support. I appreciate!

To some extent, I think say na people wey de introduce this people to this forum no de give dem the main guidance wey dem need, but I come see am say, if you introduce some people, them go want make you carry the through all d forum due process which sometimes will not be possible because you self go get wetting u wan do for d forum, so i de think say na why some of them de shitpost, but i am sure this will encourage them to de write quality posts.
Thank you, na person dey show person road, some people no be say them no guide them na stubbornness just dey do them. Who never go meta go think say plagiarism na small matter until e happen.


Anyhow Satoprincess you try because even me at times dey tire to post here because I know say na still repeated topics and post I dey see everytime
Thank you my brother, e taya me too as you dey feel am na so me sef dey feel am for body. For the signature code e go fine ooo and still give the board small leg but I no want make people come dey think say we dey rent their signature space, the smallest campaign dey pay member $20 weekly. This our small movement never big reach like that, we go cut our coat according to our size.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
Satoprincess this is a very good and a welcoming idea. Although It is not a normal campaign in the main board but it looks like a bounty campaign because the idea of the campaign just as the bounty type. There are some factors that I used to analyze the idea. Normal campaign payment is weekly while bounty campaign payment is monthly though I have not visited bounty section but I know that their campaigns pays monthly. That not withstanding. The initiative is good one. I like people that are trying to make the local board clean.
But even as this, those who like to spam the board will still do it and I know them very well. And also your rules, you didn't state it clearly that the posting must be in the local board because some members and newbies would think that they can post for any board.
And I ask want to appeal to others that anyone who can sponsor the campaign can also join Satoprincess in this new development.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
NOTE
This campaign no be about highest number of post but na about quality, person way make 1 quality stand better chance than person way make 50 low quality posts. I go announce the winner for month end and give am e prize. This campaign go start from 1st May 2023 and go will continue for at least 3 months till I fund am again…..

First of all thank you for this initiative, edit topic add am 'monthly BTC reward'. Also I hope if Bitcoin over pump you no go reduced the BTC value wey you dun put so. Also I hope you no go forfeit any payments. All month started must be accounted for, if you know say you wan end am, update us at the end of the month before the new month start. No go do wetin go make people question your credibility and it results to red tagged abeg.

You no fit dey give the award they check the quality as well e fit dey biased, you can ask someone to do that for you and we get Charles or Igehh wey go help you since they can identify quality posters with ease, other senior members dey here too wey fit handle the quality checking although if the community dey okey with you reviewing and awarding no shaking. For your rules you no put no alts but you for add am because if you use your alts to come BTC and dem catch you na red tagged supposed reach your account.

Make we engage this campaign with good heart to help raise awareness of quality posts been awarded in both merit wise and BTC wise. If the three months end and people see the impact of the campaign, we fit push small BTC to help the ministry to continue. My eye dey the thread, and I go dey follow up as the months dey go bye, thank you for this.

Ps: No put giveaway oh for title, the forum dey against giveaways hosted on the forum, dem fit give you temporary ban if you try am.
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
#SWGT PRE-SALE IS LIVE
The way most of the beginners just dey spoiled everything dey worry us well due to this shitposting and spamming. This one wey you put like that go really help us clean up small and remain free from anything than shitposting and spamming, and I go really like make them read people topics here before dem go rush go make new topics. I dey see say our brother Uche6215 don go raise dust for topic him go create and if time not taken him fit collect wotowoto from people wey dey forum because him no sabi organized him post, how him go lie that kind lie forget say here na forum.

Abeg make una try organized things I know say every body dey hustle and I no go like say we spoiled our names in name of hustling. If you wan make post try dey recall things you don talk and things you never talk make you no go conflicts issues for yourself otherwise you fit no last here after all your struggles to build up and e happened say na just small mistake you do go carry you go home like that. Usually I dey happy say na 9ja no dey carry last but things wey me dey see fit be like say e go really worry most of us here if we no maintain our standard as Giant we be.
Pages:
Jump to: