Pages:
Author

Topic: [End] Post Quality Review [Monthly BTC Reward] - page 3. (Read 601 times)

sr. member
Activity: 574
Merit: 308
This one na better initiative wey go help clean our board but na still for people wey their mind dey ooo. Some people no dey even bother to read at all in order to add value to discussion. My question be say na how the post go dey? Na under this thread or to create another post? If na latter Omo plenty rubbish and duplicate post go soon full this board. I go suggest make everything dey under this thread in order to maintain orderliness in the board. By the way, your wallet no go ever dry for taking such amount out to help better the board. I see plenty comments wey dey in support and also having same thought of making this place a better one. Una all weldon.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
Thank you very much our Princess for this initiative. This step wey you take show say you get good intentions for our local board. This initiative no go only help to make our local board to be spam free but e go also help to encourage new members to dey post quality posts so that them go fit get the prize.
hero member
Activity: 812
Merit: 675
The most activity in this local board has always been post repetition, low quality posts, and political discussion.
OP, SatoPrincess; you have a fantastic initiative for the local board, as well as great rules that anyone can easily understand. I'm hoping that this will help reduce spam and achieve great results for the purpose for which it was intended. 
hero member
Activity: 812
Merit: 725

NOTE
This campaign no be about highest number of post but na about quality, person way make 1 quality stand better chance than person way make 50 low quality posts. I go announce the winner for month end and give am e prize. This campaign go start from 1st May 2023 and go will continue for at least 3 months till I fund am again…..
This one na great idea SatoPrincess, because e go help our local board de clean and e go also encourage our newbies and low rank members to look very serious and write quality posts so that they can stand out in the general threads and sections with good write up.

To some extent, I think say na people wey de introduce this people to this forum no de give dem the main guidance wey dem need, but I come see am say, if you introduce some people, them go want make you carry the through all d forum due process which sometimes will not be possible because you self go get wetting u wan do for d forum, so i de think say na why some of them de shitpost, but i am sure this will encourage them to de write quality posts.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Always Act Smart and Play Safe With Your Funds
Anyhow Satoprincess you try because even me at times dey tire to post here because I know say na still repeated topics and post I dey see everytime, if e no be politics e go government no try ect and e dey weak body.
Quote
It would have been better if you use 'bitcoin giveaway for quality posts/posting' as the topic title, or 'quality post competition', or something related to reward etc.
here them no too like giveaway matta @Charles-Tim so I go suggest say e better as op give am that name so that e no go too attract eyes say otherwise. I really appreciate you op for this contribution and I know say people go also touch their minds to help increase the payment. Abeg anybody for we board wey sabi do signature code make him help give us one better code so that those newbies go apply am then make we know people wey really dey pool to receive the award or possibly make them apply our local board code, I think brainboss fit help quote am here for them to wear am.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
This is not a campaign in my opinion, although maybe as you want to achieve a goal which is quality posts and more of bitcoin discussion to reduce spamming.

Assuming you want to become a president, you campaign for people to know you and your agenda when you become a president. Assuming you are a company, you can campaign on this forum for members on this forum to know about your products and services. Another is Bitcoincleanup.

It would have been better if you use 'bitcoin giveaway for quality posts/posting' as the topic title, or 'quality post competition', or something related to reward etc.

But let us leave it to what you want to call it.

It would have been better if we have more merit sources. I have exactly this plan in mind many weeks ago, to quality posts that bitcoin is included, but I am not a merit source. It would have encouraged people to post contents that are more related to bitcoin on this forum. I mean merit giveaway to quality posts.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Winner for the month of May
Code:
Kelward  
Transaction id: https://blockchair.com/bitcoin/transaction/2e099162fac65bc4eaf3056217f0d00d3551d551577cd7038004f213a38fa323

Winner for the month of June
Code:
Kelward
Transaction id: https://blockstream.info/tx/b4f00f934183461772031ab61e5414556501ce8c278d07ea0f4a2328644cf57f
hero member
Activity: 966
Merit: 701
As we dey get more newbies for forum many of them way be Nigerians dey find their way come here to start post till them dey okay with the general board, but recently the spam for the board been high and na those kind things dey weak quality posters way dey active for the board. Local moderator never dey and e go dey bad say bounty hunters come carry our corner do spam fest where them go dey meet post quota and increase their activity.

Thanks to Igebotz, the monthly merit reward don help increase quality for the board, but e get limit e go fit help because no be merit source e be. Nai make I channel this one to ginger quality posts from low rank accounts cos na them create topic pass for here. This na my own way I feel say I fit help the board and still make the newbies know say we too dey see their handiwork. This campaign na for member rank and below, I believe say anybody way fit achieve 100 merits na good poster, na the newbies we need to look till their leg strong

CAMPAIGN REWARDS
15$ btc/month

RULES
• must be member rank or below
• No alts allowed
•comments for threads must dey on point
• only bitcoin related topics and comments go dey considered (posts about politics & society, off-topic posts nor go count)
• make your topics interesting, no be newscaster or commentator way go carry articles come post here and you no go add your own reason.
• start posts way dey bitcoin related or way concern blockchain, derogatory topics like yahoo is not welcome.
• No negative feedback from DT.
• Plagiarism or text spinning no dey allowed.
• Do not bump useless threads
• Report scams like this one
• No duplicate posting


NOTE
This campaign no be about highest number of post but na about quality, person way make 1 quality stand better chance than person way make 50 low quality posts. I go announce the winner for month end and give am e prize. This campaign go start from 1st May 2023 and go will continue for at least 3 months till I fund am again…..
Pages:
Jump to: