So if I may ask, how can we identify this kind of fraudsters?
D first thing wey Dey na to discover the strategy wey dem Dey use scam, as you don sabi d strategy, d next thing wey you suppose do na to avoid it now, if anybody send you any link, no just click am, if you see any random link online, make sure say you Dey avoid am, because things like dis fit out u for problem.
If you be person wey Dey run all dis airdrops now, if dem ask you to connect wallet, and you wan run am, make sure say na new wallet u go connect, no go connect wallet wey money Dey inside ooo, make sure say you get new wallet if you wan particular in any airdrop, to avoid story that touches the heart at d end, because plenty airdrop wey Dey na just to scam, and d problem be say person no go sabi d one wey be scam, and one wey be legit.
I go tell you again say, anybody wey you meet on social media, take them like say na scammer dem be, even if you wan learn something from them, never trust anyone, because some people go make sure say dem earn your trust first, before them go come attack you.