Exchanges na dem still be d best to use wen it comes to p2p services. Na dem dey provide d best service and dem go help safeguard your money make scammers no woo you with your money which everybody no fit take am. If you no know vendor neh physically, e no get use to go set trade with dem because you go dey on d verge of losing your money to fraud which many people don dey use take advantage of crypto people. Na dem dey contribute join to d bad name wey people dey attach to bitcoin. If everybody dey just and honest, we no go dey face all dis blackish for bitcoin matter, but as everybody wan dey claim wiseness criminally, e go continue dey affect everybody even d one’s wey no know anything about am.
Aside all the dangers on these exchanges, there have been really helpful to us, How do think Nigeria would have gone in our bitcoin adoption without CEX and also how bad would be the scamming rate on p2p ?
Sincerely speaking, scamming rate on p2p go don dey high and dis na bad signal to d people wey go wan join and start dey use bitcoin. Also, d level of adoption wey don dey now no go don imminent by now. Despite say all dis centralised exchanges no dey trusted to leave money inside, people wey go dey careless with their keys go dey somehow safe while using and operating with a trusted exchange with reputation for the time being. Just take a look at Binance, if not everybody, almost everybody wey dey into crypto dey use that exchange and some people no even know say decentralised exchanges dey sef. So tey d government been accuse Binance of having effect for d depreciation of naira to dollar that time. No matter d bad names attached to centralised exchanges, dey don play their own path in Bitcoin adoption for the society which we fit see and actually confirm am.