Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin (Read 9496 times)

sr. member
Activity: 546
Merit: 418
April 06, 2024, 06:36:39 AM
Proverb: Picture better pass thousands of words.

Meaning: An image can tell a better story than words.

Dis one enter me well, I remember back in the days when dem dey use drawing dey teach us plenty tins I bin dey understand tins faster dat time I still remember when my uncle been dey teach me tins with drawing book e help me to fit remember tins easily because once my mind go wia the pictures dey I go come recall wetin dem been teach me.

E get some things wey we need make them tell us in words dan or pictures dis one depend on how deep the thing be you no say words dey change person mind so if you show person wey dey blind picture em no go no wetin you dey show am but if you tell am word em go flow faster with you.

No be lie my broda, pictures dy make pikin recall past evemor something wey dem teach dem for school pass wen you dey read book without picture, e dy hard to recall.


Proverb: Every good things must come to an end one-day.

Meaning: Good times don't last for ever.

Make una add something different abeg.
member
Activity: 308
Merit: 26
March 29, 2024, 05:55:38 PM
1. Pikin wey like party rice no suppose fear dance
Meaning: if you want a result then get ready to face the sacrifices

2. Na who wear shoe know where e dey pain am
Meaning: you don't know much about a situation until u find urself inside
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
March 28, 2024, 12:46:05 PM
Proverb: Picture better pass thousands of words.

Meaning: An image can tell a better story than words.

Dis one enter me well, I remember back in the days when dem dey use drawing dey teach us plenty tins I bin dey understand tins faster dat time I still remember when my uncle been dey teach me tins with drawing book e help me to fit remember tins easily because once my mind go wia the pictures dey I go come recall wetin dem been teach me.

E get some things wey we need make them tell us in words dan or pictures dis one depend on how deep the thing be you no say words dey change person mind so if you show person wey dey blind picture em no go no wetin you dey show am but if you tell am word em go flow faster with you.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
March 28, 2024, 10:41:28 AM
~
Only a fool tests the depth of a river with both feet.
Meaning: You don't jump straight into a situation without thinking about it first.
D format here na to put d proverbs for pidgin, even d wan wey you quote there dey obvious but you nor still follow d rule. Amaka, why na?
sr. member
Activity: 546
Merit: 418
March 26, 2024, 05:44:46 PM
Proverb: Picture better pass thousands of words.

Meaning: An image can tell a better story than words.
member
Activity: 70
Merit: 10
March 25, 2024, 07:56:31 PM
I have been meaning to do this for a while now but each time I get distracted and laggard. I want us to have an avenue of sharing some of our indigenous proverbs while still learning the crypto stuff.

— E don tey wey I be dey plan to do this thing here but each time too much distractions dey carry my mind comot from am. I go like make our area people share some of our local proverbs here with their explanations. I go put the proverbs in bold.

Share a proverb, and then put up its meaning. It will be best if the proverb is written in pidgin English.

Make I kick start am with some Warri flavour. Area!

Nor be today wey yansh don dey back.
Meaning: We are used to such a situation.

Dem nor dey tell blind man sey salt nor dey soup, you fit tell am sey oil nor dey.
Meaning: Obvious things don't need explanations.

Only a fool tests the depth of a river with both feet.
Meaning: You don't jump straight into a situation without thinking about it first.
sr. member
Activity: 546
Merit: 418
March 25, 2024, 12:06:55 AM
Proverb: Elephant pikin no go be dwarf.

Meaning: Like father like son.
hero member
Activity: 966
Merit: 545
March 14, 2024, 05:04:03 PM
Proverb: Wen sugar no dey again, all the ants go disappear
Meaning: People will leave you when they cannot get anything from you or benefit from their relationship with you.
member
Activity: 168
Merit: 75
March 13, 2024, 12:50:09 PM
Lol, proverbs dey full of wisdom and some dey parable, I like to dey talk dey speak proverb join and some really dey funny ah swear and e dey carry lesson join and e go dey make help us in times we dey face problem or wen we dey depressed or frustrated. Make I follow talk my own too..
* Akara and moi moi get same parents but na wetin them pass through na make them different.
Meaning: How you start doesn't matter but what matters is how you finish.

* Leave matter for Mathias and sabi for Sabinus
Meaning : Give everyone what they deserve.

* The difference between kpekere and plantain chips na packaging.
Meaning: Don't judge on appearance alone.

* The water dem use take make eba can never be recovered.
Meaning: Don't cry over spilled milk.

* Table no dey turn, na who get sense dey change chair
Meaning: Take charge of your destiny.

* If trust dey, water for no boil fish.
Meaning: Trust no one.

* Na strong head make February no complete.
Meaning: Listen to advice, suggestions or opinions at times.
Make I stop here because wetin dey my head, plenty well well, as e be say I start to dey learn proverbs even idioms wen I still dey primary school.
jr. member
Activity: 42
Merit: 5
March 13, 2024, 11:54:26 AM
Proverb ~ Custard na pap wey jand
Just like corned beef na cow wey travel abroad, ba 🤪

Nas look brother no be small proverbs wey full for here nija
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
March 12, 2024, 06:35:57 PM
Proverb ~ Custard na pap wey jand
Just like corned beef na cow wey travel abroad, ba 🤪
jr. member
Activity: 42
Merit: 5
March 12, 2024, 05:57:17 PM
Proverb ~ Custard na pap wey jand

Meaning - Looks can be deceiving. Stay sharp.

Proverb ~ Man wey naked no dey put hand for pocket:

Meaning - Stop capping. Be honest about your true situation.

Proverb ~ Who dey purge no dey select toilet:

Meaning - Basically, beggars can’t be choosers.

Proverb ~ E don tey wey yansh dey for back:

There’s nothing new under the sun.

Proverb ~ Rice wey dey bottom pot today go dey on top cooler tomorrow:

No condition is permanent.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
March 12, 2024, 04:12:03 PM
Proverb: Face of goat wey dey frown no go fit stop em owner wey wan carry am go market.

Meaning: No matter how you think a person is not able to do something because of a disability you will be shocked with their victory some day.
Bros, dis ur interpretation get small k-leg oh.


Dem nor dey take morning know bad market.
Meaning: You don't dismiss a thing by rushing into conclusion based on first incident.
   I also get one obonge African proverbs we I won add here, although many of us fit also done know am since but make I just talk am sha.
   Restless feet fit waka enter inside snake pit– This one means say person wey no get any better things wey em dey use em life dey do fit carry em leg waka enter where bad things them plenty.
   My advice for this talk be say make we find better things out our hand so that we no go enter trouble, them also talk am say an idle man nah devil's workshop, . As this country dey badh everyday make person also do meaningful things wey go provide money for ram.
   Nah only person wey no get jobs dey talk watin em next neighbor do wey no dey good.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
March 12, 2024, 08:49:44 AM
My people I greet una, e come be like say our elders here don go on holidays but as I dey think am I come understand say now na raining season our elders don go do farm work so that dem go rush come back before rain start. Make I drop one proverb abeg make here for hot small abeg make we no forget say na here we dey learn all the better word dem to take guide our children for our families.

Proverb: Pikin wey no get papa and mama no supposed dey cry of hunger dey go house.
Meaning: If you are the bread winner in your family, you don't need to depend on anyone else in your family for survival because the burden is already on your shoulders.
sr. member
Activity: 546
Merit: 418
February 25, 2024, 09:37:01 PM
Proverb: If life don beat you well well and your face don swell up, just dy smile and behave like fat man.

Meaning: In life always try to make the best out of it no matter what.
member
Activity: 75
Merit: 16
February 24, 2024, 11:50:47 AM
Though me I no grow up for village sha o but sometimes when my uncle's them de advice me e get some adage and proverbs them wey Dem dey use for me and e plenty of which I don't know whether people don already mention am because people wey reply to this thread plenty well well but make I drop this two:

××An apple doesn't fall far from the tree ---- meaning say Pikin dey get the same character and behavior like the parents.

××It's only when you near a tree that you would know the kind of fruits it bears ------ meaning say Na when you reach person body naim you go know the kind of person wey them be
member
Activity: 168
Merit: 22
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
February 23, 2024, 02:30:13 AM
Rat wey dey house they invite outside rat say food dey
Meaning: person wey get some na em exposed him self
A child in the parents shoulder never know the distance they are going
Meaning child under parents don't know life is not easy
Old woman that throw away basket on play ground invited public
Meaning: tabling your problem gives people room for opinion including your enemies
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
February 23, 2024, 02:10:18 AM
Proverb: Face of goat wey dey frown no go fit stop em owner wey wan carry am go market.

Meaning: No matter how you think a person is not able to do something because of a disability you will be shocked with their victory some day.
Bros, dis ur interpretation get small k-leg oh.


Dem nor dey take morning know bad market.
Meaning: You don't dismiss a thing by rushing into conclusion based on first incident.
sr. member
Activity: 546
Merit: 418
February 15, 2024, 06:46:46 PM
Proverb: Face of goat wey dey frown no go fit stop em owner wey wan carry am go market.

Meaning: No matter how you think a person is not able to do something because of a disability you will be shocked with their victory some day.
newbie
Activity: 25
Merit: 0
February 12, 2024, 07:20:55 AM
I have been meaning to do this for a while now but each time I get distracted and laggard. I want us to have an avenue of sharing some of our indigenous proverbs while still learning the crypto stuff.

— E don tey wey I be dey plan to do this thing here but each time too much distractions dey carry my mind comot from am. I go like make our area people share some of our local proverbs here with their explanations. I go put the proverbs in bold.

Share a proverb, and then put up its meaning. It will be best if the proverb is written in pidgin English.

Make I kick start am with some Warri flavour. Area!

Nor be today wey yansh don dey back.
Meaning: We are used to such a situation.

Dem nor dey tell blind man sey salt nor dey soup, you fit tell am sey oil nor dey.
Meaning: Obvious things don't need explanations.



Pikin wey wash him hand well go follow elder chop for the same plate
Meaning: pikin wey get sence dy follow elders do things
Pages:
Jump to: