Pages:
Author

Topic: How many of you can write well using your local language? - page 2. (Read 248 times)

jr. member
Activity: 70
Merit: 4
how easy e de for you to fit read and write using your local dialect?
Throughout my primary school, my school make am compulsory for every student, so e come make me dey very good for the language. But overtime i  dn reduce for the way wey i dey read and write am. Currently i dey read and write am but e dey take small time to make sense for my head sha.


    How we fit improve on being comfortable in the use of our local dialect?  I mean either reading or writing with it. 
For me i think active and intentional participation on the language will help. Dey curious on everything wey involve the language reading and writing.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
how easy e de for you to fit read and write using your local dialect?
You see as our local dialect d so, many people wey no sabi how to read and write with am as them d speak am so plenty. All this na because sae they were not taught how to read and write in their local dialect from school, till adulthood. What they were taught in school especially na how to read and write in English because English na the major and acceptable language give every Nigerian for easy communication since we get diverse ethnicities for the country.

How we fit improve on being comfortable in the use of our local dialect?  I mean either reading or writing with it.
We go start from the grassroots. From our family to the schools wey we attend(from nursery to tertiary). Let every family and school begin to the make their local dialect a compulsory subject wey everybody go d learn for schools. Irrespective of your background or the school wey you attend(private or local). Make every family take upon themselves to d teach their children on how dem go read and write for their dialect.

If it is done in that manner, we no go too d see cases of where so many people go know how to speak their dialect but them no know how to read and write am for book.
hero member
Activity: 812
Merit: 675
Like me eh, I fit speak my dialect well oh but when it comes to reading an article that is written in my dialect or even trying to write an article in my dialect eh, na suffer I go de suffer oh, I fit even manage read small for my local dialect but to fit write de hard me aswr.

To write for local dialect go hard for of us Nigerians because dem no teach us from school how to write in them. Na d three popular languages for the country; Hausa, Igbo and Yoruba na him dem teach for school and no be compulsory for some schools and also for some schools you go just chose one to do and leave the rest. The concentration was more on English, French and in some schools Arabic. So our people find am easy to write in those languages and read fluently with dem dan d local dialects in the country.

Quote
how easy e de for you to fit read and write using your local dialect?

E no easy oo and I no even sabi because d run dey very hard sef. I fit speak am fluently but to read or write am dey hard me very well. Dey get some books wey dem write in my local dialect sef, I no dey for read and understand wetin dem write until I check the translation in English before I go fit depict wetin dem write there.

Quote
    How we fit improve on being comfortable in the use of our local dialect?  I mean either reading or writing with it. 

That one na to make am compulsory from school, make e dey part of the curriculum for school and make everybody go learn him mother tongue as a core subject in school. With that, e go improve the writing and reading of local dialects too. So many languages in Nigeria go get people wey don sabi everything about the languages and go fit write am for books to be used in classes. That na the only way dis thing fit dey easy for our people to learn from am.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
Omo any how you write your pidgin English I go still read am. Me na born and brought up 9ja guy. as even say we dey write Pure English no mean say person no ft write am for pidgin. I wounder wetting hard for oga @charls Tim to read and write pidgin although everybody no fit be thesame. For me, e dey very simple because as e be like this, for Facebook and WhatsApp, all my friends na Pidgin we dey carry dey chat and e don master me. Even as i dey type am e just be like normal English wey I dey type.

So make we dey try our best to dey speak our pidgin English since e be say we no get standard language like India or China. Our pidgin English be like our secret pass phrase wey na only us get access to am. If language no dey private that means e no get value again na. And na because of this things dey make Mama and pikin go enter public place them no go fit talk freely with there local dialect. Secret thing Mama wan tell pikin every body go Sabi am. Like as e dey like this we fit say we want discuss Something wey no nice, even all dose oga dem wey dey come spy us for here, dem no go fit no wetting we dey Yan. but if one person just speak Pure English dem don understand wetting we dey talk.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
This topic wey you write, I been expect say e suppose dey for pidgin English, I mean the title. Something like How many of us fit write well for our local languages.
It does not mean. You can post in English or Pidgin. There is not rule that if a post is in Pidgin, that the topic title should also be in Pidgin. We all understand both English and Pidgin and we can do it the way we want.

To dey honest with you, e dey hard many people to write pigin, let alone to write their local language. As Charles-Tim talk, him deh find it difficult to write or read pidgin because different version of pidgins dem dey.

That is not what I meant.

Example if I am chatting with a friend. Like: How far bro? I dey. Or Bawo ni? Those are easily to read fast. But if it is getting longer, like posts on this forum, I find it slow to read and there is more energy I put on it to read it to understanding. I can easily use both informally but easily prefer to use English formally.

It is not about how you use the Pidgin. I can easily understand but difficult to continue to read it continually for long.
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
Re: How many of you can write well using your local language?
This topic wey you write, I been expect say e suppose dey for pidgin English, I mean the title. Something like How many of us fit write well for our local languages. To dey honest with you, e dey hard many people to write pigin, let alone to write their local language. As Charles-Tim talk, him deh find it difficult to write or read pidgin because different version of pidgins dem dey.

But for local languages, e dey difficult for many people. But I for still write with my language. To write languages no dey hard me, but to understand bu be nsogbu no. Kwu obula ona adi, kanyi were forum ya muo kwu eji asu okwu nyi. Odi mkpa nihina umu nyi ndeke adi muo amuo. Ka okwunyi yara ifuni
full member
Activity: 462
Merit: 145
Provide a poll for this because I think that at the end, the poll result may show that the number of people who cannot speak and write in their local dialect is more or almost more than the number of people who can speak and write well in their local dialect. The truth is because many people have migrated from their place of birth the other place is in search of greener pastures and better opportunities they get married to people from those places, mix up and sometimes even give birth and raise children in those communities where their language is not what is spoken as a result of this many children grow up in places far from their origin and then end up not being able to learn the language even writing. Parents should have this as a responsibility to ensure that their children always learn to write and speak their native and local dialects.
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
~snip
how easy e de for you to fit read and write using your local dialect?
    How we fit improve on being comfortable in the use of our local dialect?  I mean either reading or writing with it. 

Well, many if us for real life dey speak pidgin pass English. That one na normal thing as a nija person. Our local language for instance my own na Esan, na to only talk to people Dem wey come from my home town. Most times you go see say na state government dey put am as compulsory subject for children wey dey primary school. This one go help them know how to speak and write them local direct well. The thing be say, sofa u Sabi hear or speak you dialect, writing no really matter. That one na because no body go force you write am for any where. Na your personal language. Even pidgin wey e be say na every body own for we country, no still dey compulsory to speak or write as a nija person. These languages na watin we as Nigerians know same with other countries and them local Language. If you go another country you go need t learn the language so you go fit communicate with them.

No body dey force anybody to learn am, na something you fit do out of your own will. Jus as I don talk am before for one of my post, English and pidgin na the two accepted language for we local board. So no you fit choose  watin you wan write and people go still respond. Sofa you fit write watin people dey understand.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
We don de advocate for the board say make we de write more with pigin as e be say na the general language when every nija person fit speak well but e still get plenty people when no de fit use pigin write as e be say some of them don de used to normal good English.
I find it hard to read and post in Pidgins on this forum. Although, it is easy for me while chatting with friends online. But when it comes to this forum, I prefer English. I think it is because I read and write fast in English than Pidgin while this forum is not just a short conversion with my friend and me. If it is a long posts, I may not even finish reading it if it is in Pidgin, unlike English which is easy for me to read fast and clear.

English is easier because we were taught in school in English. Reading English from basic school to tertiary school takes decades. As we are growing, we noticed that we got better in English.

But when it comes to an average Nigerian, we know say most of us fit speak our Hausa, Igbo, yoruba or Efik well but when it comes to writing in those our local language eh, e de always de very difficult.
It is easy for me to speak my local language. Also easy for me to write my local language. But to read it is hard for me just like Pidgin. If it is conversation online with my friend and me, I find it easy for those short conversations. I even use with my local language to chart with people than they do with me. But if it is a long text, I will not even finish reading it as I find it difficult to read and that will make me slow to read it finish.
full member
Activity: 266
Merit: 113
We don de advocate for the board say make we de write more with pigin as e be say na the general language when every nija person fit speak well but e still get plenty people when no de fit use pigin write as e be say some of them don de used to normal good English.

The average English speaking man fit speak and write him English fluently without stress as e be say na wetin them know as their language right from when dem de small.

But when it comes to an average Nigerian, we know say most of us fit speak our Hausa, Igbo, yoruba or Efik well but when it comes to writing in those our local language eh, e de always de very difficult.

Like me eh, I fit speak my dialect well oh but when it comes to reading an article that is written in my dialect or even trying to write an article in my dialect eh, na suffer I go de suffer oh, I fit even manage read small for my local dialect but to fit write de hard me aswr.

how easy e de for you to fit read and write using your local dialect?

    How we fit improve on being comfortable in the use of our local dialect?  I mean either reading or writing with it. 
Pages:
Jump to: